﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,580
Den wen e follow dem sidan dey tok,

2
00:00:07,580 --> 00:00:09,400
e kon kommand dem sey,

3
00:00:09,400 --> 00:00:11,520
“Make una nor leave Jerusalem,

4
00:00:11,520 --> 00:00:16,260
but make una wait for di tin wey my Papa promise wey I don tell una before.

5
00:00:16,260 --> 00:00:18,200
John dey baptize with wota,

6
00:00:18,200 --> 00:00:25,800
but e nor go tey wen God go baptize una with en Holy Spirit (wey go kontrol una life forever).”

7
00:00:25,800 --> 00:00:27,360
So wen dem gada,

8
00:00:27,360 --> 00:00:29,900
dem kon start to ask Jesus Christ,

9
00:00:29,900 --> 00:00:31,160
“Oga God!

10
00:00:31,160 --> 00:00:34,080
Na naw yu go start to rule Israel?”

11
00:00:34,080 --> 00:00:35,280
Jesus ansa dem,

12
00:00:35,280 --> 00:00:39,200
“Di time wey God plan nor koncern una,

13
00:00:39,200 --> 00:00:45,840
but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem,

14
00:00:45,840 --> 00:00:52,880
for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”

15
00:00:52,880 --> 00:00:54,760
So afta e don tok with dem,

16
00:00:54,760 --> 00:00:59,440
God kon karry am up until kloud kover am and dem nor fit si am again.

17
00:00:59,440 --> 00:01:01,640
As dem still dey look up as e dey go,

18
00:01:01,640 --> 00:01:04,100
two men wey wear white klot stand near dem

19
00:01:04,100 --> 00:01:04,760
kon sey,

20
00:01:04,760 --> 00:01:06,840
“Galilee pipol,

21
00:01:06,840 --> 00:01:10,480
na wetin make una stand der dey look heaven like dat?

22
00:01:10,480 --> 00:01:14,400
Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today,

23
00:01:14,400 --> 00:01:18,840
go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”

