﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,840
As all dis tins dey happen,

2
00:00:07,840 --> 00:00:11,100
Saul still dey tell di disciples sey e go kill dem.

3
00:00:11,100 --> 00:00:12,580
E go meet di High Priest

4
00:00:12,580 --> 00:00:15,420
kon take pamishon to go Damaskus,

5
00:00:15,420 --> 00:00:19,400
so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way,

6
00:00:19,400 --> 00:00:20,900
weda na man or woman,

7
00:00:20,900 --> 00:00:22,900
e go arrest dem kom Jerusalem.

8
00:00:22,900 --> 00:00:24,160
As e dey go,

9
00:00:24,160 --> 00:00:27,620
one lite from heaven kon shine round where e dey.

10
00:00:27,620 --> 00:00:31,160
E fall for groun kon hear one vois wey koll en name,

11
00:00:31,160 --> 00:00:32,500
“Saul,

12
00:00:32,500 --> 00:00:33,580
Saul,

13
00:00:33,580 --> 00:00:35,660
wetin make yu dey ponish mi?”

14
00:00:35,660 --> 00:00:36,980
So e ansa,

15
00:00:36,980 --> 00:00:38,500
“Oga God,

16
00:00:38,500 --> 00:00:41,900
na who dey tok so?”

17
00:00:41,900 --> 00:00:43,680
Di vois ansa am,

18
00:00:43,680 --> 00:00:46,480
“I bi Jesus Christ wey yu dey ponish!

19
00:00:46,480 --> 00:00:47,360
Naw,

20
00:00:47,360 --> 00:00:52,100
make yu get up go inside di town and dem go tell yu wetin yu go do.”

21
00:00:52,100 --> 00:00:54,400
Di men wey dey follow am travel,

22
00:00:54,400 --> 00:00:56,040
sopraiz dey look,

23
00:00:56,040 --> 00:00:58,360
bikos dem hear vois dey tok,

24
00:00:58,360 --> 00:01:00,100
but dem nor si anybody.

25
00:01:00,100 --> 00:01:01,980
So Saul get up from groun,

26
00:01:01,980 --> 00:01:03,420
en eye open,

27
00:01:03,420 --> 00:01:05,020
but e nor dey si.

28
00:01:05,020 --> 00:01:07,940
En friends hold en hand kon escort am enter Damaskus.

29
00:01:07,940 --> 00:01:11,380
E nor si at-all for three days and for dat time,

30
00:01:11,380 --> 00:01:13,360
e nor chop or drink anytin.

31
00:01:13,360 --> 00:01:14,340
Dat time,

32
00:01:14,340 --> 00:01:17,920
e get one disciple for Damaskus and en name na Ananias.

33
00:01:17,920 --> 00:01:20,100
God koll am for inside vishon,

34
00:01:20,100 --> 00:01:22,160
“Ananias”,

35
00:01:22,160 --> 00:01:23,680
e kon ansa,

36
00:01:23,680 --> 00:01:25,340
“Na mi bi dis,

37
00:01:25,340 --> 00:01:26,660
Oga God.”

38
00:01:26,660 --> 00:01:28,180
God tell am,

39
00:01:28,180 --> 00:01:35,360
“Get up make yu go di street wey dem dey koll ‘Strait’ and wen yu rish Judas house wey dey der,

40
00:01:35,360 --> 00:01:37,700
make yu look for one man,

41
00:01:37,700 --> 00:01:40,700
en name na Saul and e kom from Tarsus.

42
00:01:40,700 --> 00:01:42,460
Yu go meet am dey pray for der.

43
00:01:42,460 --> 00:01:49,900
I don show am for vishon sey one man wey dem dey koll Ananias go kom meet am and e go put hand for en head,

44
00:01:49,900 --> 00:01:50,580
pray for am,

45
00:01:50,580 --> 00:01:52,500
make e for fit si again.”

46
00:01:52,500 --> 00:01:54,440
But Ananias ansa,

47
00:01:54,440 --> 00:01:55,980
“Oga God,

48
00:01:55,980 --> 00:02:02,500
many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem.

49
00:02:02,500 --> 00:02:05,100
E even kollect leta from di priest oga dem,

50
00:02:05,100 --> 00:02:07,620
wey e go take katch and trow pipol wey bilive yu,

51
00:02:07,620 --> 00:02:08,700
for prison.”

52
00:02:08,700 --> 00:02:10,900
But God tell Ananias,

53
00:02:10,900 --> 00:02:12,800
“Make yu go meet am,

54
00:02:12,800 --> 00:02:16,500
bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol,

55
00:02:16,500 --> 00:02:18,740
kings and all Israel pipol.

56
00:02:18,740 --> 00:02:21,740
True-true I go show am how e go sofa,

57
00:02:21,740 --> 00:02:23,540
bikos of my name.”

58
00:02:23,540 --> 00:02:26,540
So Ananias go di house and wen e enter,

59
00:02:26,540 --> 00:02:29,300
e put en hand for Saul head kon sey,

60
00:02:29,300 --> 00:02:30,740
“Broda Saul,

61
00:02:30,740 --> 00:02:34,700
di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here,

62
00:02:34,700 --> 00:02:36,740
na en send mi kom meet yu,

63
00:02:36,740 --> 00:02:41,540
so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.”

64
00:02:41,540 --> 00:02:42,940
At wons,

65
00:02:42,940 --> 00:02:47,320
sometin wey bi like fish skale fall komot from Saul eye and e kon dey si.

66
00:02:47,320 --> 00:02:49,920
E get up and dem baptize am.

67
00:02:49,920 --> 00:02:51,520
Afta e chop finish,

68
00:02:51,520 --> 00:02:53,540
en body kon strong again and Saul kon stay Damaskus for some days with di disciple.

