﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,560
One day,

2
00:00:06,560 --> 00:00:08,820
as wi dey go di place where dem for dey pray,

3
00:00:08,820 --> 00:00:12,360
one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon,

4
00:00:12,360 --> 00:00:13,640
kon si us.

5
00:00:13,640 --> 00:00:16,720
Di girl oga dey use am make plenty money,

6
00:00:16,720 --> 00:00:18,680
anytime e tell pipol wetin go happen.

7
00:00:18,680 --> 00:00:22,560
Di girl kon dey follow mi and Paul for back dey shaut sey,

8
00:00:22,560 --> 00:00:25,400
“Dis pipol na God savants o-o,

9
00:00:25,400 --> 00:00:28,580
dem dey prish to una about how una go take save.”

10
00:00:28,580 --> 00:00:32,160
E kontinue to dey shaut like dis for many days.

11
00:00:32,160 --> 00:00:34,360
So di tin vex Paul well-well,

12
00:00:34,360 --> 00:00:36,920
naim e turn face di girl kon tell di spirit,

13
00:00:36,920 --> 00:00:39,720
“I kommand yu with Jesus Christ name,

14
00:00:39,720 --> 00:00:41,880
komot for dis girl body!”

15
00:00:41,880 --> 00:00:42,920
At wons,

16
00:00:42,920 --> 00:00:44,940
di spirit komot from di girl body.

17
00:00:44,940 --> 00:00:49,680
But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go,

18
00:00:49,680 --> 00:00:54,700
dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.

19
00:00:54,700 --> 00:00:57,640
Den dem drag dem go meet di judge dem kon sey,

20
00:00:57,640 --> 00:01:00,840
“All dis men dey kause wahala for dis town.

21
00:01:00,840 --> 00:01:01,940
Dem bi Jew

22
00:01:01,940 --> 00:01:04,040
and dem dey tish law wey nor bi awa own,

23
00:01:04,040 --> 00:01:06,240
since wi bi Rome pipol.”

24
00:01:06,240 --> 00:01:12,680
All di pipol wey gada for der kon join put mout against dem and di judge dem kon give orda sey,

25
00:01:12,680 --> 00:01:17,840
make dem remove Paul and Silas klot komot for dia body and flog dem with heavy stik.

26
00:01:17,840 --> 00:01:19,840
Afta dem don flog dem well-well,

27
00:01:19,840 --> 00:01:24,000
dem put dem for prison kon tell di warda make e guide dem well-well.

28
00:01:24,000 --> 00:01:25,360
Bikos of dis strong orda,

29
00:01:25,360 --> 00:01:30,440
di warda put dem for inside-inside di prison kon hook dia leg with big-big shains.

30
00:01:30,440 --> 00:01:31,800
Wen mid-nite rish,

31
00:01:31,800 --> 00:01:37,880
Paul and Silas kon dey pray and sing song give God and all di pipol wey dey di prison dey listin to dem.

32
00:01:37,880 --> 00:01:38,720
At wons,

33
00:01:38,720 --> 00:01:40,360
di groun start to shake,

34
00:01:40,360 --> 00:01:44,760
sotey all di wall and pilas wey dey di prison kon dey shake too.

35
00:01:44,760 --> 00:01:48,800
Na wons di door open and di shains wey dem take hook di pipol wey dey di prison,

36
00:01:48,800 --> 00:01:49,920
kon luz.

37
00:01:49,920 --> 00:01:53,360
Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open,

38
00:01:53,360 --> 00:01:55,080
e bring en swod kom out,

39
00:01:55,080 --> 00:01:56,400
won kon kill ensef,

40
00:01:56,400 --> 00:01:59,320
bikos e tink sey all di prisonas don run.

41
00:01:59,320 --> 00:02:01,480
But Paul shaut,

42
00:02:01,480 --> 00:02:03,720
“Make yu nor kill yorsef,

43
00:02:03,720 --> 00:02:06,720
all of us still dey for here!”

44
00:02:06,720 --> 00:02:13,180
Naim di warda sey make dem bring lite and e rush enter inside di prison kon fall for Paul and Silas front dey shake.

45
00:02:13,180 --> 00:02:15,040
E bring dem kom outside kon ask,

46
00:02:15,040 --> 00:02:17,100
“My oga dem,

47
00:02:17,100 --> 00:02:19,500
wetin I go do to dey save?”

48
00:02:19,500 --> 00:02:21,360
Dem ansa am,

49
00:02:21,360 --> 00:02:24,640
“Bilive Jesus Christ and yu go save,

50
00:02:24,640 --> 00:02:27,760
both yu and all yor family.”

51
00:02:27,760 --> 00:02:28,160
Den,

52
00:02:28,160 --> 00:02:32,000
dem prish God word give en and all di pipol wey dey en house.

53
00:02:32,000 --> 00:02:32,760
Dat nite,

54
00:02:32,760 --> 00:02:35,120
di warda kon wosh all dia sore;

55
00:02:35,120 --> 00:02:37,680
den en and en family kon baptize.

56
00:02:37,680 --> 00:02:41,320
Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop.

57
00:02:41,320 --> 00:02:45,500
E happy well-well sey en and en family don bilive God.

58
00:02:45,500 --> 00:02:46,960
Wen day break,

59
00:02:46,960 --> 00:02:49,360
di judge dem kon send sojas sey,

60
00:02:49,360 --> 00:02:51,800
“Make una go release doz men.”

61
00:02:51,800 --> 00:02:53,400
Di warda tell Paul,

62
00:02:53,400 --> 00:02:57,760
“Di judge dem don give orda sey make wi free una.

63
00:02:57,760 --> 00:02:59,920
So make una kon dey go.”

64
00:02:59,920 --> 00:03:01,900
But Paul tell di sojas,

65
00:03:01,900 --> 00:03:07,320
“Dem sey make dem beat us for publik even wen dem neva judge awa kase,

66
00:03:07,320 --> 00:03:09,800
even doh sey wi bi Rome pipol,

67
00:03:09,800 --> 00:03:11,640
dem still trow us for prison.

68
00:03:11,640 --> 00:03:12,400
Naw,

69
00:03:12,400 --> 00:03:15,320
dem won free us from back make pipol nor for know?

70
00:03:15,320 --> 00:03:16,600
Wi nor gri!

71
00:03:16,600 --> 00:03:20,040
Make dem kom here by demsef kon release us!”

72
00:03:20,040 --> 00:03:24,280
Di sojas kon ripot wetin Paul tok give di judge dem.

73
00:03:24,280 --> 00:03:28,560
Fear katch dem wen dem hear sey Paul and Silas na Rome pipol,

74
00:03:28,560 --> 00:03:31,240
so dem kon beg dem sey make dem nor vex.

75
00:03:31,240 --> 00:03:32,800
Afta dem bring dem kom out,

76
00:03:32,800 --> 00:03:36,080
dem kon beg dem well-well sey make dem leave di town.

77
00:03:36,080 --> 00:03:37,880
Wen dem don komot for prison,

78
00:03:37,880 --> 00:03:40,840
dem enter Lydia house and wen dem si di brodas,

79
00:03:40,840 --> 00:03:45,240
dem enkourage dem before dem leave di town.

