﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,360
Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy,

2
00:00:09,360 --> 00:00:12,660
dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius,

3
00:00:12,660 --> 00:00:15,260
one kommander wey dey Augustan group.

4
00:00:15,260 --> 00:00:25,640
Wi enter one ship from Adramyttium wey won travel go difren place for Asia sea kon bigin travel go Aristakus and one Masidonia man wey dey stay Tesalonika,

5
00:00:25,640 --> 00:00:26,880
follow us.

6
00:00:26,880 --> 00:00:28,200
Di next day,

7
00:00:28,200 --> 00:00:31,360
wi enter Sidon and Julius kon do good give Paul,

8
00:00:31,360 --> 00:00:35,140
e allow am go meet en friends make dem fit gi-am all di tins wey e nid.

9
00:00:35,140 --> 00:00:36,280
From der,

10
00:00:36,280 --> 00:00:40,120
wi enter wota travel again face Cyprus island,

11
00:00:40,120 --> 00:00:42,420
bikos breeze dey blow di ship.

12
00:00:42,420 --> 00:00:47,440
Afta wi don travel enter di open sea wey dey inside Silisia and Pamfilia,

13
00:00:47,440 --> 00:00:49,040
wi kon stop for Myra,

14
00:00:49,040 --> 00:00:50,360
wey dey Lycia.

15
00:00:50,360 --> 00:00:51,360
For der,

16
00:00:51,360 --> 00:00:58,240
di soja kommander kon si one ship wey kom from Alexandria dey drive go Italy and e kon put us for inside.

17
00:00:58,240 --> 00:01:03,640
Wi dey go small-small for many days and nor bi small wahala before wi fit rish Cnidus.

18
00:01:03,640 --> 00:01:06,040
Bikos di breeze nor make us fit go front again,

19
00:01:06,040 --> 00:01:08,600
wi kon drive small-small dey go Krete,

20
00:01:08,600 --> 00:01:10,560
wey dey opposite Salmone.

21
00:01:10,560 --> 00:01:12,640
Before wi rish Krete wotaside,

22
00:01:12,640 --> 00:01:15,380
e hard us well-well and wi kon rish one place wey dem dey koll,

23
00:01:15,380 --> 00:01:18,740
“Fair Havens” wey dey near Lasea town.

24
00:01:18,740 --> 00:01:22,540
As e bi sey time don go well-well and di journey don hard like dis,

25
00:01:22,540 --> 00:01:24,980
bikos di time wey dem dey fast don pass,

26
00:01:24,980 --> 00:01:26,660
Paul kon advise dem sey,

27
00:01:26,660 --> 00:01:28,360
“My pipol,

28
00:01:28,360 --> 00:01:34,340
I dey si sey dis journey na with wahala e go take end and nor bi only di load and di ship go lost,

29
00:01:34,340 --> 00:01:37,020
but many pipol go die too.”

30
00:01:37,020 --> 00:01:41,380
But di kommander nor listin to am and na wetin di kaptain and di ship owner tok,

31
00:01:41,380 --> 00:01:42,620
naim e bilive.

32
00:01:42,620 --> 00:01:45,340
Bikos di place where ship dey pak put wen dem si,

33
00:01:45,340 --> 00:01:46,780
nor good for kold weda;

34
00:01:46,780 --> 00:01:49,660
some for di pipol kon gri sey make wi dey go.

35
00:01:49,660 --> 00:01:51,820
Dem dey hope sey wi go fit rish Foenix,

36
00:01:51,820 --> 00:01:52,880
wey dey Krete,

37
00:01:52,880 --> 00:01:55,020
wey face sout-west and nort-west,

38
00:01:55,020 --> 00:01:57,260
so dat wi go fit spend kold sizin for der.

39
00:01:57,260 --> 00:02:00,620
Wen one kind kwayet breeze blow kom from sout,

40
00:02:00,620 --> 00:02:03,540
dem tink sey dem go fit do wetin dem plan,

41
00:02:03,540 --> 00:02:07,460
so dem kon dey go small-small pass Krete wotaside.

42
00:02:07,460 --> 00:02:08,820
Afta di kold breeze,

43
00:02:08,820 --> 00:02:10,760
one strong breeze wey dem dey koll,

44
00:02:10,760 --> 00:02:11,300
“Hurricane”,

45
00:02:11,300 --> 00:02:13,460
kon dey blow kom from di Island.

46
00:02:13,460 --> 00:02:16,820
Wen dis breeze trap di ship and wi nor fit si well-well again,

47
00:02:16,820 --> 00:02:21,360
wi leave di ship give di breeze and e kon dey karry us go where e like.

48
00:02:21,360 --> 00:02:25,700
As wi dey run go hide under one small island wey dem dey koll Kauda,

49
00:02:25,700 --> 00:02:26,780
nor bi small wahala,

50
00:02:26,780 --> 00:02:28,060
before wi fit kontrol di ship.

51
00:02:28,060 --> 00:02:30,980
Afta dem don drag di ship komot from di wota,

52
00:02:30,980 --> 00:02:32,580
dem kon take rope tie am.

53
00:02:32,580 --> 00:02:35,660
Wi dey fear sey wi go run around for Sirtis,

54
00:02:35,660 --> 00:02:39,440
so wi hook di ship for groun kon leave di breeze make e karry us go.

55
00:02:39,440 --> 00:02:41,040
Di next day,

56
00:02:41,040 --> 00:02:42,920
bikos di breeze worry us well-well,

57
00:02:42,920 --> 00:02:44,940
wi kon dey trow awa load put for wota

58
00:02:44,940 --> 00:02:46,800
and wen di third day rish,

59
00:02:46,800 --> 00:02:50,360
dem use dia hand trow wetin dem take dey kontrol di ship put for wota.

60
00:02:50,360 --> 00:02:54,320
Wen wi nor si sun or star for many days and di breeze still dey worry us,

61
00:02:54,320 --> 00:02:56,840
wi kon luz hope sey wi don die bi dat.

62
00:02:56,840 --> 00:02:59,440
Afta dem don stay without food for many days,

63
00:02:59,440 --> 00:03:01,560
Paul stand for dia front kon sey,

64
00:03:01,560 --> 00:03:02,600
“My pipol,

65
00:03:02,600 --> 00:03:07,760
if to sey una listin to mi wen I sey make wi nor komot for Krete,

66
00:03:07,760 --> 00:03:09,740
wi for nor si all dis wahala.

67
00:03:09,740 --> 00:03:11,240
Naw,

68
00:03:11,240 --> 00:03:13,520
I won make una heart strong,

69
00:03:13,520 --> 00:03:15,640
bikos nobody go die among us,

70
00:03:15,640 --> 00:03:18,840
but na only di ship go skata.

71
00:03:18,840 --> 00:03:20,920
Bikos yestiday nite,

72
00:03:20,920 --> 00:03:22,320
God wey I dey serve,

73
00:03:22,320 --> 00:03:23,760
en angel appear to mi

74
00:03:23,760 --> 00:03:24,560
kon sey,

75
00:03:24,560 --> 00:03:26,880
‘Make yu nor fear Paul!

76
00:03:26,880 --> 00:03:31,500
Yu must face Caesar and God go save yu and evribody wey dey follow yu travel.’

77
00:03:31,500 --> 00:03:32,240
So,

78
00:03:32,240 --> 00:03:33,080
my pipol,

79
00:03:33,080 --> 00:03:34,620
make una heart strong,

80
00:03:34,620 --> 00:03:37,060
bikos I bilive sey na as God tell mi,

81
00:03:37,060 --> 00:03:38,640
na so e go bi.

82
00:03:38,640 --> 00:03:41,980
But wi sure sey wi go rish land.”

83
00:03:41,980 --> 00:03:44,140
Afta fourteen days,

84
00:03:44,140 --> 00:03:48,320
as di breeze dey karry us pass di Adriatik Sea for mid-nite,

85
00:03:48,320 --> 00:03:51,140
di sailors kon dey suspet sey wi don dey near land.

86
00:03:51,140 --> 00:03:59,320
Dem trow long rope wey dem tie sometin put inside di wota to measure how e deep rish and dem si sey di wota still deep rish 40 metres.

87
00:03:59,320 --> 00:04:01,080
Afta e don tey small,

88
00:04:01,080 --> 00:04:04,260
dem trow am again kon si sey e don bi 30 metres.

89
00:04:04,260 --> 00:04:08,000
Dem dey fear sey di ship go jam rock for di land,

90
00:04:08,000 --> 00:04:12,660
so dem trow for big-big shain from di ship back kon dey pray make day kwik break.

91
00:04:12,660 --> 00:04:15,160
Den di sailor try to run leave di ship,

92
00:04:15,160 --> 00:04:17,160
dem take di small boat for di ship,

93
00:04:17,160 --> 00:04:22,020
put am for wota kon dey play wayo sey dem won go put big shain down for di ship front,

94
00:04:22,020 --> 00:04:24,520
but Paul tell di offisa and sojas,

95
00:04:24,520 --> 00:04:27,440
“Unless all dis men stay inside di ship,

96
00:04:27,440 --> 00:04:29,460
all of us go die.”

97
00:04:29,460 --> 00:04:32,860
So di sojas kon kut di rope for di boat make e float go.

98
00:04:32,860 --> 00:04:34,320
As day one break,

99
00:04:34,320 --> 00:04:36,600
Paul enkourage dem make dem chop kon sey,

100
00:04:36,600 --> 00:04:40,080
“Today make am fourteen days wey una dey worry,

101
00:04:40,080 --> 00:04:41,620
sotey una nor gri chop.

102
00:04:41,620 --> 00:04:42,680
So naw,

103
00:04:42,680 --> 00:04:44,440
I dey beg una to chop,

104
00:04:44,440 --> 00:04:46,720
bikos una nid am to survive.

105
00:04:46,720 --> 00:04:50,620
And nobody among una go luz even one hair for en head.”

106
00:04:50,620 --> 00:04:52,160
Wen Paul tok finish,

107
00:04:52,160 --> 00:04:57,140
e take bread kon tank God for dia front make all of dem si and e start to chop.

108
00:04:57,140 --> 00:04:59,800
All of dem get strong heart kon take food chop.

109
00:04:59,800 --> 00:05:03,140
(Wi bi 276 wey dey inside di ship.)

110
00:05:03,140 --> 00:05:04,780
Wen dem don chop beleful,

111
00:05:04,780 --> 00:05:09,900
dem kon trowey all di remainin bread inside di wota make di ship nor for heavy again.

112
00:05:09,900 --> 00:05:11,100
Wen day break,

113
00:05:11,100 --> 00:05:12,400
dem nor know where dem dey,

114
00:05:12,400 --> 00:05:16,240
but dem si one small land wey near di sea and dem tok for dia mind sey,

115
00:05:16,240 --> 00:05:19,280
if e dey possibol dem go use di ship take enter di land.

116
00:05:19,280 --> 00:05:24,100
So dem kut all di shains wey whole di ship kon let dem fall inside di sea.

117
00:05:24,100 --> 00:05:27,300
Dem still luz di ones wey dey whole wetin dey kontrol di ship.

118
00:05:27,300 --> 00:05:31,080
Dem let breeze blow di ship go front and wi kon move face land.

119
00:05:31,080 --> 00:05:33,700
But dem meet san-san for di sea.

120
00:05:33,700 --> 00:05:36,920
So di ship front kon hook and e nor fit move again,

121
00:05:36,920 --> 00:05:37,920
di back skata,

122
00:05:37,920 --> 00:05:39,780
bikos of di way di wave dey blow am.

123
00:05:39,780 --> 00:05:45,020
Di sojas kon plan to kill all di prisonas make dem nor for fit swim kon eskape.

124
00:05:45,020 --> 00:05:48,360
But bikos di soja offisa one save Paul life,

125
00:05:48,360 --> 00:05:50,520
e nor kon let dem do wetin dem plan.

126
00:05:50,520 --> 00:05:52,440
E kommand di pipol wey fit swim,

127
00:05:52,440 --> 00:05:55,280
make dem first jump komot from di ship swim go land

128
00:05:55,280 --> 00:05:57,760
and di rest pipol kon follow for back,

129
00:05:57,760 --> 00:06:00,960
some whole di wood and odas whole di ship body wey break.

130
00:06:00,960 --> 00:06:05,480
Na so all of dem take rish land and nobody die.

131
00:06:05,480 --> 00:06:07,760
Afta wi don rish land and nobody die,

132
00:06:07,760 --> 00:06:09,120
wi kon hear sey,

133
00:06:09,120 --> 00:06:11,300
na Malta dem dey koll di island.

134
00:06:11,300 --> 00:06:14,480
Di pipol wey dey stay for der trit us well.

135
00:06:14,480 --> 00:06:15,760
Dem make fire for us,

136
00:06:15,760 --> 00:06:18,720
bikos rain don start to dey fall and kold dey katch us.

137
00:06:18,720 --> 00:06:22,100
Wen Paul dey gada plenty stik make e put inside di fire,

138
00:06:22,100 --> 00:06:23,680
one snake wey dem dey koll,

139
00:06:23,680 --> 00:06:24,320
“Vipa”,

140
00:06:24,320 --> 00:06:27,800
kom out bikos of di heat kon put e mout for Paul hand.

141
00:06:27,800 --> 00:06:31,920
Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand,

142
00:06:31,920 --> 00:06:33,240
dem kon dey tell demsef,

143
00:06:33,240 --> 00:06:36,880
“E bi like sey dis man hand nor klean!

144
00:06:36,880 --> 00:06:39,120
Even doh e nor die inside sea,

145
00:06:39,120 --> 00:06:41,480
hand don still tosh am for here!”

146
00:06:41,480 --> 00:06:46,500
But Paul shake di snake komot from en hand enter di fire and nor-tin do am at-all.

147
00:06:46,500 --> 00:06:50,400
But dem dey tink sey en body go swell-up or e go fall for groun die.

148
00:06:50,400 --> 00:06:54,220
So afta dem don wait for sometaim kon si sey nor-tin happen to am,

149
00:06:54,220 --> 00:06:55,760
dem kon shange mind sey,

150
00:06:55,760 --> 00:06:58,020
Paul na god.

151
00:06:58,020 --> 00:06:59,880
Dat time for dat aria,

152
00:06:59,880 --> 00:07:00,520
Publius,

153
00:07:00,520 --> 00:07:01,480
wey bi di oga,

154
00:07:01,480 --> 00:07:02,680
get some land.

155
00:07:02,680 --> 00:07:05,320
E welkom us kon give us food for three days.

156
00:07:05,320 --> 00:07:09,000
Publius papa kon get fever and en belle dey pain am.

157
00:07:09,000 --> 00:07:10,700
Paul go si am kon heal am.

158
00:07:10,700 --> 00:07:12,080
Afta dis tin don happen,

159
00:07:12,080 --> 00:07:15,680
many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem.

160
00:07:15,680 --> 00:07:19,320
Dem kon dey praiz us well-well and wen wi won go,

161
00:07:19,320 --> 00:07:21,480
dem give us evritin wey wi nid.

