﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:13,220
Since wen di time start naim di Word dey and di Word dey with God and na God ensef bi di Word.

2
00:00:13,220 --> 00:00:16,620
Di Word dey with God from wen time bigin.

3
00:00:16,620 --> 00:00:20,360
Na God make evritin and if to sey E nor make dem,

4
00:00:20,360 --> 00:00:23,020
dem nor for dey dis world at-all.

5
00:00:23,020 --> 00:00:28,420
Na inside am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get.

6
00:00:28,420 --> 00:00:30,980
Di lite dey shine inside darkness,

7
00:00:30,980 --> 00:00:33,640
but darkness nor gri with am.

8
00:00:33,640 --> 00:00:36,480
E get one man wey en name bi John,

9
00:00:36,480 --> 00:00:38,600
wey God send kom dis world.

10
00:00:38,600 --> 00:00:40,760
E kom bear witness for di lite,

11
00:00:40,760 --> 00:00:46,460
make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.

12
00:00:46,460 --> 00:00:49,000
Nor bi John ensef bi di lite,

13
00:00:49,000 --> 00:00:53,160
but e kom tell pipol about Jesus wey bi di lite.

14
00:00:53,160 --> 00:00:57,460
Na Jesus bi di true lite wey go shine for evribody for dis world.

15
00:00:57,460 --> 00:01:00,460
E kom inside di world wey e make my ensef,

16
00:01:00,460 --> 00:01:02,800
but di pipol nor know am.

17
00:01:02,800 --> 00:01:04,700
E kom meet en own pipol,

18
00:01:04,700 --> 00:01:06,800
but dem nor wont am.

19
00:01:06,800 --> 00:01:09,800
But evribody wey receive and bilive en name,

20
00:01:09,800 --> 00:01:12,480
e go give dem di rite to bi God pikin.

21
00:01:12,480 --> 00:01:14,380
Dem go bi God shidren,

22
00:01:14,380 --> 00:01:17,720
nor bi as dia papa and mama take born dem from belle,

23
00:01:17,720 --> 00:01:19,980
or bikos somebody make dem so,

24
00:01:19,980 --> 00:01:23,160
but bikos God ensef make dem en own shidren.

25
00:01:23,160 --> 00:01:28,420
Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world.

26
00:01:28,420 --> 00:01:30,540
Wi si en glory wey show sey,

27
00:01:30,540 --> 00:01:34,260
naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut,

28
00:01:34,260 --> 00:01:36,740
wey God send kom meet us.

29
00:01:36,740 --> 00:01:39,240
John kon bigin shaut sey,

30
00:01:39,240 --> 00:01:42,260
“Dis na di pesin wey I tell una about sey,

31
00:01:42,260 --> 00:01:44,540
‘Di pesin wey go kom afta mi,

32
00:01:44,540 --> 00:01:45,840
big pass mi,

33
00:01:45,840 --> 00:01:47,820
bikos e dey before mi.’ ”

34
00:01:47,820 --> 00:01:51,980
Evribody for dis world don receive plenty good tins from am.

35
00:01:51,980 --> 00:01:54,520
Na thru Moses God give us di law,

36
00:01:54,520 --> 00:01:57,200
but God give us favor and trut,

37
00:01:57,200 --> 00:01:58,640
thru Jesus Christ.

38
00:01:58,640 --> 00:02:00,880
Nobody don fit si God face before.

39
00:02:00,880 --> 00:02:01,720
But Jesus,

40
00:02:01,720 --> 00:02:02,800
wey bi God ensef,

41
00:02:02,800 --> 00:02:04,720
wey en and en Papa bi tait friend,

42
00:02:04,720 --> 00:02:08,080
na-im kom show us how God bi.

