﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,860
Wen day break,

2
00:00:06,860 --> 00:00:09,660
John with en two disciple stand for outside.

3
00:00:09,660 --> 00:00:13,260
Dem kon dey look Jesus wen e dey waka pass,

4
00:00:13,260 --> 00:00:15,060
den John kon sey,

5
00:00:15,060 --> 00:00:16,580
“Make una look!

6
00:00:16,580 --> 00:00:18,540
Na dat pesin bi God Sheep.”

7
00:00:18,540 --> 00:00:22,060
Wen John two disciples hear wetin e tok,

8
00:00:22,060 --> 00:00:23,700
dem kon follow Jesus.

9
00:00:23,700 --> 00:00:26,960
Jesus look back kon si di disciples dey follow am.

10
00:00:26,960 --> 00:00:28,220
Den e ask dem,

11
00:00:28,220 --> 00:00:31,060
“Wetin una wont?”

12
00:00:31,060 --> 00:00:31,920
Dem ansa am,

13
00:00:31,920 --> 00:00:33,760
“Oga God,

14
00:00:33,760 --> 00:00:37,720
(wey mean Tisha) where yu dey stay?”

15
00:00:37,720 --> 00:00:39,900
Jesus ansa dem,

16
00:00:39,900 --> 00:00:42,540
“Make una kom si am.”

17
00:00:42,540 --> 00:00:46,800
So dem go si di place wey e dey stay kon stay with am dat day.

18
00:00:46,800 --> 00:00:49,380
Dat time na about for oklok for aftanoon.

19
00:00:49,380 --> 00:00:50,820
Andru,

20
00:00:50,820 --> 00:00:52,260
Simon Pita broda,

21
00:00:52,260 --> 00:00:56,960
na one for di disciples wey hear wetin John tok kon follow Jesus.

22
00:00:56,960 --> 00:01:00,420
E first go find en broda Simon kon tell am,

23
00:01:00,420 --> 00:01:02,660
“Wi don si di Mezaya”,

24
00:01:02,660 --> 00:01:04,680
(wey mean Christ).

25
00:01:04,680 --> 00:01:07,740
Andru kon bring Simon kom meet Jesus.

26
00:01:07,740 --> 00:01:08,980
Wen Jesus si am,

27
00:01:08,980 --> 00:01:10,700
e tell am,

28
00:01:10,700 --> 00:01:12,200
“Yu bi Simon,

29
00:01:12,200 --> 00:01:13,140
John pikin,

30
00:01:13,140 --> 00:01:20,800
na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”

31
00:01:20,800 --> 00:01:22,720
Wen day break,

32
00:01:22,720 --> 00:01:24,940
Jesus kon plan to go Galilee.

33
00:01:24,940 --> 00:01:26,500
Wen e si Filip,

34
00:01:26,500 --> 00:01:27,100
e tell am,

35
00:01:27,100 --> 00:01:29,480
“Make yu follow mi.”

36
00:01:29,480 --> 00:01:31,440
Filip na from Betsaida,

37
00:01:31,440 --> 00:01:33,920
wey bi Andru and Pita home-town.

38
00:01:33,920 --> 00:01:36,060
Wen Filip si Netanel,

39
00:01:36,060 --> 00:01:36,880
e tell am,

40
00:01:36,880 --> 00:01:42,540
“Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey,

41
00:01:42,540 --> 00:01:44,620
‘En name na Jesus,

42
00:01:44,620 --> 00:01:49,800
wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”

43
00:01:49,800 --> 00:01:51,700
Netanel kon sey,

44
00:01:51,700 --> 00:01:55,440
“Betta tin go fit kom out from Nazaret?”

45
00:01:55,440 --> 00:01:56,760
Filip ansa am,

46
00:01:56,760 --> 00:01:59,220
“Make yu kom si.”

47
00:01:59,220 --> 00:02:02,620
Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am,

48
00:02:02,620 --> 00:02:03,380
e kon sey,

49
00:02:03,380 --> 00:02:05,660
“Make una look!

50
00:02:05,660 --> 00:02:08,320
Dis na betta pesin wey kom from Israel,

51
00:02:08,320 --> 00:02:10,020
wayo nor dey en belle.”

52
00:02:10,020 --> 00:02:12,240
Netanel ask am,

53
00:02:12,240 --> 00:02:14,140
“How yu take know mi.”

54
00:02:14,140 --> 00:02:16,020
Jesus ansa,

55
00:02:16,020 --> 00:02:20,260
“Before Filip koll yu wen yu dey under di tree,

56
00:02:20,260 --> 00:02:21,860
I don si yu.”

57
00:02:21,860 --> 00:02:23,420
Netanel sey,

58
00:02:23,420 --> 00:02:24,900
“Tisha,

59
00:02:24,900 --> 00:02:26,340
true-true,

60
00:02:26,340 --> 00:02:29,740
yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”

61
00:02:29,740 --> 00:02:32,500
Jesus tell am,

62
00:02:32,500 --> 00:02:36,220
“Bikos I tell yu sey I si yu under di fig tree,

63
00:02:36,220 --> 00:02:38,380
yu bilive wetin I tok?

64
00:02:38,380 --> 00:02:39,500
Bikos yu bilive,

65
00:02:39,500 --> 00:02:43,000
yu go si wetin big pass dis one.”

66
00:02:43,000 --> 00:02:44,340
Den e kon sey,

67
00:02:44,340 --> 00:02:48,020
“Wetin I dey tell una na true word,

68
00:02:48,020 --> 00:02:56,260
una go si heaven open and God angels go dey waka up-and-down on-top God Pikin.”

