﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,140
By dis time,

2
00:00:07,140 --> 00:00:09,920
di Jew Passova Feast don near well-well,

3
00:00:09,920 --> 00:00:11,900
so Jesus kon go Jerusalem.

4
00:00:11,900 --> 00:00:15,080
E si di pipol dey sell melu,

5
00:00:15,080 --> 00:00:21,280
sheep and dove inside di temple yard and e still si pipol wey dey shange money,

6
00:00:21,280 --> 00:00:22,740
sidan near dia tabol.

7
00:00:22,740 --> 00:00:25,120
So e use koboko wey e make,

8
00:00:25,120 --> 00:00:28,800
take drive dem with dia sheep and melu komot from di temple yard.

9
00:00:28,800 --> 00:00:33,880
E trowey di tabol wey di pipol dey take shange money and dia money kon skata.

10
00:00:33,880 --> 00:00:36,800
E kon tell di pipol wey dey sell dove,

11
00:00:36,800 --> 00:00:39,640
“Make una karry all dis tins komot for here.

12
00:00:39,640 --> 00:00:42,820
Make una nor turn my Papa house to market.”

13
00:00:42,820 --> 00:00:47,480
Den en disciples kon remember as den rite for Psalms Book sey,

14
00:00:47,480 --> 00:00:52,800
“Di love wey e get for en Papa house dey burn for en heart like fire.”

15
00:00:52,800 --> 00:00:55,180
Di Jew oga dem kon ask am,

16
00:00:55,180 --> 00:00:57,140
“As yu dey do all dis tins,

17
00:00:57,140 --> 00:01:01,080
na wish sign yu go show us make wi for fit bilive yu?”

18
00:01:01,080 --> 00:01:03,040
Jesus ansa dem,

19
00:01:03,040 --> 00:01:05,640
“Even if una distroy dis Temple,

20
00:01:05,640 --> 00:01:07,300
for three days time,

21
00:01:07,300 --> 00:01:09,360
I go build am again.”

22
00:01:09,360 --> 00:01:11,020
Den di Jew oga dem tell am,

23
00:01:11,020 --> 00:01:17,540
“Na forty-six years dem take build dis Temple and yu dey sey yu go fit build am for three days?”

24
00:01:17,540 --> 00:01:22,080
But na di temple for Jesus body naim e dey tok about.

25
00:01:22,080 --> 00:01:24,360
So wen Jesus don wake-up from deat,

26
00:01:24,360 --> 00:01:27,160
en disciples kon remember sey,

27
00:01:27,160 --> 00:01:28,760
e tok so before.

28
00:01:28,760 --> 00:01:34,520
Den dem kon bilive wetin dem rite for God word and wetin Jesus tell dem.

29
00:01:34,520 --> 00:01:40,000
Jesus dey for Jerusalem by di time wey dem dey do di Passova Feast.

30
00:01:40,000 --> 00:01:40,600
For der,

31
00:01:40,600 --> 00:01:41,880
many pipol kon bilive am,

32
00:01:41,880 --> 00:01:44,580
bikos dem si di mirakles wey e do.

33
00:01:44,580 --> 00:01:47,960
But Jesus nor gri open en mind give di pipol,

34
00:01:47,960 --> 00:01:49,580
bikos e know dem well-well.

35
00:01:49,580 --> 00:01:51,980
E nor nid anybody to tok about am,

36
00:01:51,980 --> 00:01:55,060
bikos e know wetin dey inside pipol belle,

37
00:01:55,060 --> 00:01:58,600
so e nor fit trust dem.

