﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,960
E get one man wey bi Farisee,

2
00:00:07,960 --> 00:00:13,260
en name na Nikodimos and e bi memba for di kansol wey dey rule Jew pipol.

3
00:00:13,260 --> 00:00:16,260
E hide go meet Jesus for nite kon tell am,

4
00:00:16,260 --> 00:00:17,480
“Tisha,

5
00:00:17,480 --> 00:00:20,800
wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us,

6
00:00:20,800 --> 00:00:23,500
bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do,

7
00:00:23,500 --> 00:00:25,460
unless God dey with am.”

8
00:00:25,460 --> 00:00:27,320
Jesus tell am,

9
00:00:27,320 --> 00:00:29,320
“Make I tell yu true word,

10
00:00:29,320 --> 00:00:31,900
unless dem born pesin di sekond time,

11
00:00:31,900 --> 00:00:34,000
e nor go fit si God kingdom.”

12
00:00:34,000 --> 00:00:36,600
Den Nikodimos ask am,

13
00:00:36,600 --> 00:00:41,000
“How dem go fit take born pesin wey don old for di sekond time?

14
00:00:41,000 --> 00:00:45,040
Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again?

15
00:00:45,040 --> 00:00:46,680
E fit happen like dat?”

16
00:00:46,680 --> 00:00:48,640
Jesus ansa am,

17
00:00:48,640 --> 00:00:51,480
“I tell yu di trut,

18
00:00:51,480 --> 00:00:56,680
unless God born pesin with wota and en Spirit,

19
00:00:56,680 --> 00:00:59,120
di pesin nor go fit enter God kingdom.

20
00:00:59,120 --> 00:01:01,300
Wetin flesh born,

21
00:01:01,300 --> 00:01:02,880
na flesh e bi,

22
00:01:02,880 --> 00:01:05,200
but wetin God Spirit born,

23
00:01:05,200 --> 00:01:06,740
na spirit e bi.

24
00:01:06,740 --> 00:01:07,520
So,

25
00:01:07,520 --> 00:01:10,260
make yu nor konfuse bikos I tok sey,

26
00:01:10,260 --> 00:01:13,060
‘God go born yu for di sekond time.’

27
00:01:13,060 --> 00:01:15,620
Wen breeze dey blow,

28
00:01:15,620 --> 00:01:18,280
e dey go anywhere e wont,

29
00:01:18,280 --> 00:01:20,880
yu dey hear di sound wey e dey make,

30
00:01:20,880 --> 00:01:25,120
but yu nor fit know where e dey kom from or where e dey go.

31
00:01:25,120 --> 00:01:29,600
Na so e bi with evribody wey God Spirit born.”

32
00:01:29,600 --> 00:01:31,840
Nikodimos kon ask am,

33
00:01:31,840 --> 00:01:34,360
“How dis tins go fit happen?”

34
00:01:34,360 --> 00:01:36,380
Jesus ansa,

35
00:01:36,380 --> 00:01:39,520
“Yu bi tisha for Israel,

36
00:01:39,520 --> 00:01:41,700
yet yu nor fit undastand dis tins?

37
00:01:41,700 --> 00:01:43,640
Make I tell yu di trut,

38
00:01:43,640 --> 00:01:50,340
wi dey tok wetin wi sabi and dey bear witness for wetin wi don si with awa eyes,

39
00:01:50,340 --> 00:01:52,840
but una nor gri asept wetin wi tok.

40
00:01:52,840 --> 00:01:53,880
Naw,

41
00:01:53,880 --> 00:02:00,280
if I dey tell una about di tins wey dey for dis world and una nor fit bilive wetin I tok,

42
00:02:00,280 --> 00:02:02,640
how una go fit take bilive mi,

43
00:02:02,640 --> 00:02:06,200
if I bigin dey tell una about di tins wey dey for heaven?

44
00:02:06,200 --> 00:02:08,560
Nobody don go heaven before,

45
00:02:08,560 --> 00:02:13,200
escept Man Pikin wey kom down from heaven and e go-go back der.

46
00:02:13,200 --> 00:02:14,620
Yu si,

47
00:02:14,620 --> 00:02:19,160
as Moses karry di snake go up wen dem dey inside desert,

48
00:02:19,160 --> 00:02:21,880
na so too dem go karry Man Pikin up,

49
00:02:21,880 --> 00:02:24,920
so dat anybody wey bilive am,

50
00:02:24,920 --> 00:02:27,520
go get life wey nor dey end.

51
00:02:27,520 --> 00:02:32,200
“God love di pipol wey dey dis world well-well,

52
00:02:32,200 --> 00:02:36,380
so E kon send di only pikin wey E get to us,

53
00:02:36,380 --> 00:02:39,100
so dat anybody wey bilive am,

54
00:02:39,100 --> 00:02:40,420
nor go die,

55
00:02:40,420 --> 00:02:43,840
but e go get life wey nor dey end.

56
00:02:43,840 --> 00:02:48,500
God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world,

57
00:02:48,500 --> 00:02:50,560
but make e kom save dem.

58
00:02:50,560 --> 00:02:53,200
Anybody wey bilive am,

59
00:02:53,200 --> 00:02:54,960
God nor go kondemn am.

60
00:02:54,960 --> 00:02:57,400
But di pesin wey nor bilive am,

61
00:02:57,400 --> 00:03:00,240
God don kondemn am already,

62
00:03:00,240 --> 00:03:03,640
bikos di pesin nor bilive God Pikin name.

63
00:03:03,640 --> 00:03:07,660
Na dis bi di rizin why God go judge di world,

64
00:03:07,660 --> 00:03:10,720
bikos lite don kom inside di world,

65
00:03:10,720 --> 00:03:14,400
but pipol like to stay for darkness instead of lite,

66
00:03:14,400 --> 00:03:17,440
bikos dem dey do tins wey nor good.

67
00:03:17,440 --> 00:03:18,680
Yu si,

68
00:03:18,680 --> 00:03:25,680
evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey,

69
00:03:25,680 --> 00:03:29,840
make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do.

70
00:03:29,840 --> 00:03:33,320
But di pesin wey dey do good tins,

71
00:03:33,320 --> 00:03:35,440
dey kom out for lite,

72
00:03:35,440 --> 00:03:38,120
so dat pipol go si di tins wey e dey do,

73
00:03:38,120 --> 00:03:41,680
bikos na as God wont naim e dey do.”

