﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,660
Wen two days pass,

2
00:00:07,660 --> 00:00:09,620
Jesus komot from der go Galilee.

3
00:00:09,620 --> 00:00:12,240
(Bikos Jesus don tok am sey,

4
00:00:12,240 --> 00:00:15,740
“Pesin wey bi profet nor dey get respet for en home-town”).

5
00:00:15,740 --> 00:00:17,020
Wen e rish Galilee,

6
00:00:17,020 --> 00:00:19,760
di pipol wey dey der kon welkom am,

7
00:00:19,760 --> 00:00:26,220
bikos dem don si all di tins wey e do for Jerusalem for di time wen dem dey do Passova Feast.

8
00:00:26,220 --> 00:00:28,140
Again,

9
00:00:28,140 --> 00:00:30,280
e go Kana wey dey Galilee,

10
00:00:30,280 --> 00:00:32,880
for where e first turn wota to wine.

11
00:00:32,880 --> 00:00:34,500
For Kapanaum,

12
00:00:34,500 --> 00:00:39,840
one soja-man wey dey work for di king palis dey der and en pikin wey nor well.

13
00:00:39,840 --> 00:00:42,980
Wen e hear sey Jesus don kom back to Galilee,

14
00:00:42,980 --> 00:00:47,860
e go meet am kon beg am sey make e kom heal en pikin wey won die.

15
00:00:47,860 --> 00:00:49,660
So Jesus ask am,

16
00:00:49,660 --> 00:00:54,320
“If una nor si signs and wonders una nor go bilive mi?”

17
00:00:54,320 --> 00:00:56,020
Di man ansa,

18
00:00:56,020 --> 00:00:58,300
“Oga God,

19
00:00:58,300 --> 00:01:02,680
abeg make yu kom before my pikin go die.”

20
00:01:02,680 --> 00:01:04,580
Jesus kon tell am,

21
00:01:04,580 --> 00:01:06,280
“Make yu go house,

22
00:01:06,280 --> 00:01:08,120
yor pikin nor go die.”

23
00:01:08,120 --> 00:01:10,460
Di man bilive wetin Jesus tell am,

24
00:01:10,460 --> 00:01:12,600
so e kon komot go en house.

25
00:01:12,600 --> 00:01:14,260
Wen e don near house,

26
00:01:14,260 --> 00:01:15,380
en savants kon meet,

27
00:01:15,380 --> 00:01:16,520
tell am sey,

28
00:01:16,520 --> 00:01:18,000
“Yor pikin don well,

29
00:01:18,000 --> 00:01:19,100
e nor die.”

30
00:01:19,100 --> 00:01:20,420
So,

31
00:01:20,420 --> 00:01:23,500
e ask dem di time wen di pikin bigin dey betta.

32
00:01:23,500 --> 00:01:25,300
Dem kon tell am,

33
00:01:25,300 --> 00:01:28,980
“Na yestiday for one oklok for aftanoon naim e well.”

34
00:01:28,980 --> 00:01:31,460
Bikos of wetin dem tok,

35
00:01:31,460 --> 00:01:36,380
di pikin papa kon remember sey dat na di time wen Jesus tell am sey,

36
00:01:36,380 --> 00:01:38,340
“Yor pikin nor go die.”

37
00:01:38,340 --> 00:01:39,540
Bikos of dis,

38
00:01:39,540 --> 00:01:43,060
di man and evribody wey dey en house kon bilive Jesus.

39
00:01:43,060 --> 00:01:46,760
Dis na di sekond mirakle wey Jesus do for Galilee,

40
00:01:46,760 --> 00:01:50,460
afta e kom back from Judea.

