﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,580
Jesus kon go one feast wey dem dey do for Jerusalem.

2
00:00:09,580 --> 00:00:12,960
One pool dey der wey near di Sheep Gate,

3
00:00:12,960 --> 00:00:15,980
di name na Betsaida for Aramaik language.

4
00:00:15,980 --> 00:00:19,000
Na five roads pipol take dey enter inside.

5
00:00:19,000 --> 00:00:21,080
Pipol wey nor well,

6
00:00:21,080 --> 00:00:26,040
wey blind and doz wey nor fit waka dey liedan for di difren roads.

7
00:00:26,040 --> 00:00:27,440
From time to time,

8
00:00:27,440 --> 00:00:34,120
one angel dey kom shake di wota and anybody wey first enter di wota afta di angel don shake am,

9
00:00:34,120 --> 00:00:35,000
go well.

10
00:00:35,000 --> 00:00:39,180
One man dey der wey nor fit waka for thirty-eight years.

11
00:00:39,180 --> 00:00:41,560
Wen Jesus si am liedan for der,

12
00:00:41,560 --> 00:00:45,480
e kon know sey di man neva fit waka for long time.

13
00:00:45,480 --> 00:00:45,720
So,

14
00:00:45,720 --> 00:00:47,000
Jesus kon ask am,

15
00:00:47,000 --> 00:00:49,200
“Yu won waka?”

16
00:00:49,200 --> 00:00:50,720
Di man ansa am,

17
00:00:50,720 --> 00:00:54,000
“Oga God,

18
00:00:54,000 --> 00:01:04,880
I nor get anybody wey go put mi inside di pool wen di wota dey shake.

19
00:01:04,880 --> 00:01:08,920
Anytime I dey try to enter di wota,

20
00:01:08,920 --> 00:01:14,220
anoda pesin go kwik enter before I rish der.”

21
00:01:14,220 --> 00:01:16,040
Jesus tell am,

22
00:01:16,040 --> 00:01:17,180
“Make yu get up!

23
00:01:17,180 --> 00:01:19,700
Karry yor mat make yu bigin waka.”

24
00:01:19,700 --> 00:01:21,320
At wons,

25
00:01:21,320 --> 00:01:22,520
di man get up,

26
00:01:22,520 --> 00:01:24,480
karry en mat kon bigin waka.

27
00:01:24,480 --> 00:01:26,020
(Dat day na Sabat).

28
00:01:26,020 --> 00:01:29,680
Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey,

29
00:01:29,680 --> 00:01:31,960
“Today na Sabat,

30
00:01:31,960 --> 00:01:34,860
yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”

31
00:01:34,860 --> 00:01:36,940
Naim e ansa dem,

32
00:01:36,940 --> 00:01:38,640
“Di man wey make mi well,

33
00:01:38,640 --> 00:01:39,720
tell mi sey,

34
00:01:39,720 --> 00:01:43,960
‘Make I karry my mat and make I bigin waka.’ ”

35
00:01:43,960 --> 00:01:45,960
Dem kon ask am,

36
00:01:45,960 --> 00:01:47,320
“Who bi di man wey sey,

37
00:01:47,320 --> 00:01:48,800
‘Make yu karry yor mat,

38
00:01:48,800 --> 00:01:50,240
make yu dey waka?’ ”

39
00:01:50,240 --> 00:01:52,320
But di man nor know who e bi,

40
00:01:52,320 --> 00:01:57,320
bikos Jesus don komot der and plenty pipol dey for dat place.

41
00:01:57,320 --> 00:01:59,020
Afta dis,

42
00:01:59,020 --> 00:02:01,560
Jesus kon si di man inside di temple.

43
00:02:01,560 --> 00:02:02,740
So e kon tell am,

44
00:02:02,740 --> 00:02:03,780
“Look,

45
00:02:03,780 --> 00:02:04,880
yu don well naw,

46
00:02:04,880 --> 00:02:06,920
make yu nor kommit sin again,

47
00:02:06,920 --> 00:02:07,660
oda-wise,

48
00:02:07,660 --> 00:02:10,480
di tin wey bad pass wetin do yu before,

49
00:02:10,480 --> 00:02:11,600
go happen to yu.”

50
00:02:11,600 --> 00:02:14,880
Di man kon go tell di Jew oga dem sey,

51
00:02:14,880 --> 00:02:17,920
“Na Jesus bi di pesin wey make mi well.”

