﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,440
Wen evening rish,

2
00:00:07,440 --> 00:00:10,220
en disciples kon go wotaside go wait am,

3
00:00:10,220 --> 00:00:12,180
dem enter one kenu,

4
00:00:12,180 --> 00:00:15,980
cross go Kapanaum (by dis time,

5
00:00:15,980 --> 00:00:18,900
evriwhere don dey dark and Jesus neva kom meet dem.)

6
00:00:18,900 --> 00:00:24,040
Den strong breeze bigin blow and di river kon dey rof well-well.

7
00:00:24,040 --> 00:00:28,500
Wen dem don padol di kenu go rish about three or for mile,

8
00:00:28,500 --> 00:00:33,020
dem si Jesus dey waka on-top di wota dey kom near dem.

9
00:00:33,020 --> 00:00:34,760
Fear kon katch dem well-well.

10
00:00:34,760 --> 00:00:36,740
Jesus tell dem,

11
00:00:36,740 --> 00:00:38,380
“Na mi,

12
00:00:38,380 --> 00:00:40,380
make una nor fear.”

13
00:00:40,380 --> 00:00:43,820
As dem dey try make e enter inside di kenu,

14
00:00:43,820 --> 00:00:47,380
dem kon si sey di kenu don rish where dem dey go.

