﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,860
Afta,

2
00:00:06,860 --> 00:00:09,840
Jesus kon travel go evriwhere for Galilee.

3
00:00:09,840 --> 00:00:11,780
Den e komot for Judea,

4
00:00:11,780 --> 00:00:14,400
bikos di Jew oga dem won kill-am.

5
00:00:14,400 --> 00:00:20,800
Di time kon rish wen Jew pipol dey do dia feast wey dem dey koll Tabanako Feast.

6
00:00:20,800 --> 00:00:22,980
Jesus brodas kon dey tell am,

7
00:00:22,980 --> 00:00:25,060
“Komot for here go Judea,

8
00:00:25,060 --> 00:00:28,100
make yor disciples si di mirakles wey yu dey do.

9
00:00:28,100 --> 00:00:32,440
Bikos anybody wey wont make pipol sabi who e bi,

10
00:00:32,440 --> 00:00:34,780
nor go do anytin for korna.

11
00:00:34,780 --> 00:00:36,840
Since yu dey do dis tins,

12
00:00:36,840 --> 00:00:40,640
e good sey make yu show yorsef to evribody.”

13
00:00:40,640 --> 00:00:43,860
(Even en brodas nor bilive wetin Jesus dey do.)

14
00:00:43,860 --> 00:00:45,840
Jesus ansa dem,

15
00:00:45,840 --> 00:00:48,280
“Time neva rish for mi to go,

16
00:00:48,280 --> 00:00:50,320
but una fit go anytime una like.

17
00:00:50,320 --> 00:00:52,160
Pipol like una,

18
00:00:52,160 --> 00:00:53,600
but dem nor like mi,

19
00:00:53,600 --> 00:00:56,940
bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.

20
00:00:56,940 --> 00:00:59,000
Make una go di feast,

21
00:00:59,000 --> 00:01:00,440
I nor go-go,

22
00:01:00,440 --> 00:01:02,400
bikos my time neva rish.”

23
00:01:02,400 --> 00:01:04,720
Afta e don tok finish,

24
00:01:04,720 --> 00:01:06,180
e kon stay for Galilee.

25
00:01:06,180 --> 00:01:08,580
But wen en brodas don go di feast,

26
00:01:08,580 --> 00:01:10,760
Jesus kon go der too,

27
00:01:10,760 --> 00:01:13,980
but e nor let anybody know sey e dey der.

28
00:01:13,980 --> 00:01:16,640
Di Jew oga dem kon dey ask pipol,

29
00:01:16,640 --> 00:01:18,440
“Where e dey?”

30
00:01:18,440 --> 00:01:20,960
Dem kon dey tok among demsef.

31
00:01:20,960 --> 00:01:22,240
Some sey,

32
00:01:22,240 --> 00:01:24,960
“Jesus na good pesin”,

33
00:01:24,960 --> 00:01:26,320
but odas sey,

34
00:01:26,320 --> 00:01:28,920
“E dey play pipol wayo.”

35
00:01:28,920 --> 00:01:31,380
But nobody fit tok out,

36
00:01:31,380 --> 00:01:33,820
bikos dem dey fear di Jew oga dem.

37
00:01:33,820 --> 00:01:35,920
Wen di feast don rish half,

38
00:01:35,920 --> 00:01:38,800
Jesus enter di temple kon dey tish.

39
00:01:38,800 --> 00:01:42,880
Di Jew oga dem sopraiz and dem kon dey sey,

40
00:01:42,880 --> 00:01:45,840
“How e take know dis tins wey e dey tish so,

41
00:01:45,840 --> 00:01:48,180
as e bi sey e nor go skool at-all?”

42
00:01:48,180 --> 00:01:50,420
Jesus ansa dem,

43
00:01:50,420 --> 00:01:53,340
“Wetin I dey tish nor bi my own,

44
00:01:53,340 --> 00:01:55,400
but na di Pesin wey send mi,

45
00:01:55,400 --> 00:01:56,100
na-im give mi.

46
00:01:56,100 --> 00:02:00,000
Anybody wey ready to do wetin God wont,

47
00:02:00,000 --> 00:02:04,080
di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.

48
00:02:04,080 --> 00:02:07,880
Anybody wey dey tok with en own pawa,

49
00:02:07,880 --> 00:02:10,320
go wont make pipol praiz am,

50
00:02:10,320 --> 00:02:13,320
but di pesin wey won honor who send am,

51
00:02:13,320 --> 00:02:17,140
naim dey do wetin korrect and sin nor dey inside am.

52
00:02:17,140 --> 00:02:19,720
Moses nor give una di law?

53
00:02:19,720 --> 00:02:21,380
But una nor gri obey am.

54
00:02:21,380 --> 00:02:24,480
Why e bi sey una won kill misef?”

55
00:02:24,480 --> 00:02:26,760
Di pipol ansa Jesus,

56
00:02:26,760 --> 00:02:29,720
“Demon don enter yor body!

57
00:02:29,720 --> 00:02:31,040
Who won kill yu?”

58
00:02:31,040 --> 00:02:33,080
Den Jesus ansa,

59
00:02:33,080 --> 00:02:35,840
“Na one mirakle wey I do so,

60
00:02:35,840 --> 00:02:37,020
make una dey sopraiz?

61
00:02:37,020 --> 00:02:40,720
Na true sey Moses tell una to sekonsaiz una son,

62
00:02:40,720 --> 00:02:42,800
(nor bi Moses start am,

63
00:02:42,800 --> 00:02:48,460
na from Abraham time e start) and una dey sekonsaiz una son for Sabat Day.

64
00:02:48,460 --> 00:02:53,600
Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law,

65
00:02:53,600 --> 00:02:55,220
why una dey vex with mi,

66
00:02:55,220 --> 00:02:57,800
bikos I heal dis sick man for Sabat Day?

67
00:02:57,800 --> 00:03:00,240
Make una nor dey judge pesin,

68
00:03:00,240 --> 00:03:03,300
bikos of wetin una si with una eye,

69
00:03:03,300 --> 00:03:06,540
but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”

