﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,500
Some pipol wey dey stay for Jerusalem kon dey sey,

2
00:00:08,500 --> 00:00:11,200
“Dis nor bi di man wey dem won kill?

3
00:00:11,200 --> 00:00:16,380
Naim dey here dey tok for publik so and dem nor fit tell am anytin.

4
00:00:16,380 --> 00:00:18,880
Abi di oga dem don gri sey naim bi di Christ?

5
00:00:18,880 --> 00:00:25,380
Wisef know di place where dis man from kom and wi know sey anytime wey Christ go kom,

6
00:00:25,380 --> 00:00:27,580
nobody go fit know where e go kom from.”

7
00:00:27,580 --> 00:00:30,300
As Jesus dey tish for di temple,

8
00:00:30,300 --> 00:00:32,220
e kon shaut sey,

9
00:00:32,220 --> 00:00:36,220
“Una know mi and di place wey I from kom,

10
00:00:36,220 --> 00:00:38,580
nor bi my pawa I take kom,

11
00:00:38,580 --> 00:00:42,120
na God wey send mi naim bi di korrect Pesin.

12
00:00:42,120 --> 00:00:43,640
But una nor know am.

13
00:00:43,640 --> 00:00:45,620
But I know am well-well,

14
00:00:45,620 --> 00:00:47,020
bikos na from am,

15
00:00:47,020 --> 00:00:48,900
I kom and naim send mi.”

16
00:00:48,900 --> 00:00:51,420
Dem kon try to katch Jesus,

17
00:00:51,420 --> 00:00:53,620
but nobody fit tosh am,

18
00:00:53,620 --> 00:00:54,920
bikos en time neva rish.

19
00:00:54,920 --> 00:00:58,180
Many pipol for der bilive am kon sey,

20
00:00:58,180 --> 00:01:01,540
“Anytime di pesin wey bi di Christ kom,

21
00:01:01,540 --> 00:01:05,540
e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”

22
00:01:05,540 --> 00:01:09,340
Wen di Farisee pipol hear pipol dey tok about Jesus,

23
00:01:09,340 --> 00:01:12,820
dia oga and di priests kon send sojas go arrest am.

24
00:01:12,820 --> 00:01:14,500
Jesus kon tell dem,

25
00:01:14,500 --> 00:01:18,780
“I go only stay with una for small time and afta,

26
00:01:18,780 --> 00:01:20,900
I go-go meet di Pesin wey send mi.

27
00:01:20,900 --> 00:01:22,580
Una go dey look for mi,

28
00:01:22,580 --> 00:01:26,880
but una nor go si mi and una nor go fit kom meet mi for where I dey.”

29
00:01:26,880 --> 00:01:30,280
Den di Jew oga dem kon dey ask each oda,

30
00:01:30,280 --> 00:01:33,700
“Where e won go wey wi nor go fit si am,

31
00:01:33,700 --> 00:01:37,100
abi e won go tish Jew pipol wey dey stay with Greek pipol?

32
00:01:37,100 --> 00:01:39,900
Wetin e mean wen e tok sey,

33
00:01:39,900 --> 00:01:41,300
‘Una go look for mi,

34
00:01:41,300 --> 00:01:44,020
but una nor go si mi and where I dey,

35
00:01:44,020 --> 00:01:47,120
una nor go fit kom der?’ ”

36
00:01:47,120 --> 00:01:49,060
For di last day for di feast,

37
00:01:49,060 --> 00:01:50,980
wey bi di biggest day,

38
00:01:50,980 --> 00:01:53,980
Jesus stand kon shaut,

39
00:01:53,980 --> 00:01:56,420
“If wota dey hongry anybody,

40
00:01:56,420 --> 00:01:57,940
make e kom meet mi.

41
00:01:57,940 --> 00:02:01,860
Di pesin wey bilive mi and wetin I tok,

42
00:02:01,860 --> 00:02:03,940
make e kom drink,

43
00:02:03,940 --> 00:02:05,700
just as God word sey,

44
00:02:05,700 --> 00:02:08,660
‘Plenty wota wey dey give life,

45
00:02:08,660 --> 00:02:11,160
go flow from inside en belle.’ ”

46
00:02:11,160 --> 00:02:16,220
(E tok dis tin about di Spirit wey di pipol wey bilive am go get,

47
00:02:16,220 --> 00:02:18,020
bikos by dis time,

48
00:02:18,020 --> 00:02:20,240
God neva give en Spirit to pipol,

49
00:02:20,240 --> 00:02:22,860
bikos E neva honor Jesus Christ.)

50
00:02:22,860 --> 00:02:25,160
Wen pipol hear wetin e tok,

51
00:02:25,160 --> 00:02:26,540
some for dem kon sey,

52
00:02:26,540 --> 00:02:28,140
“True-true,

53
00:02:28,140 --> 00:02:30,200
dis man naim bi di Profet!”

54
00:02:30,200 --> 00:02:31,880
Some still sey,

55
00:02:31,880 --> 00:02:33,620
“Na-im bi di Christ”,

56
00:02:33,620 --> 00:02:35,900
but odas sey,

57
00:02:35,900 --> 00:02:37,300
“Na lie,

58
00:02:37,300 --> 00:02:39,080
Christ nor fit kom from Galilee.

59
00:02:39,080 --> 00:02:41,060
Abi God word nor sey,

60
00:02:41,060 --> 00:02:44,140
‘Christ go kom from David family wey dey Betlehem,

61
00:02:44,140 --> 00:02:46,080
di village wey David from kom?’ ”

62
00:02:46,080 --> 00:02:49,060
So di pipol kon divide bikos of Jesus.

63
00:02:49,060 --> 00:02:51,680
Some of dem kon dey try to katch am,

64
00:02:51,680 --> 00:02:53,900
but nobody fit take hand tosh am.

65
00:02:53,900 --> 00:02:55,980
Wen di sojas go back,

66
00:02:55,980 --> 00:02:59,100
di priest oga dem and Farisee pipol kon ask dem,

67
00:02:59,100 --> 00:03:02,100
“Why una nor katch Jesus kom?”

68
00:03:02,100 --> 00:03:03,980
Di sojas ansa,

69
00:03:03,980 --> 00:03:09,660
“Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”

70
00:03:09,660 --> 00:03:12,460
Den di Farisee pipol kon ask di sojas,

71
00:03:12,460 --> 00:03:13,500
“Abi,

72
00:03:13,500 --> 00:03:14,940
e don deceive una too?

73
00:03:14,940 --> 00:03:20,420
Abi any of us wey bi Farisee pipol or priests don bilive Jesus?

74
00:03:20,420 --> 00:03:22,980
Curse dey dis pipol head,

75
00:03:22,980 --> 00:03:24,840
bikos dem nor know di law.”

76
00:03:24,840 --> 00:03:28,480
Den one man wey en name bi Nikodimos,

77
00:03:28,480 --> 00:03:33,400
wey don first go meet Jesus and wey bi one of di big oga dem kon sey,

78
00:03:33,400 --> 00:03:40,460
“Awa law nor dey kondemn pesin unless wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey do,

79
00:03:40,460 --> 00:03:42,180
abi nor bi so?”

80
00:03:42,180 --> 00:03:43,540
Dem kon ask am,

81
00:03:43,540 --> 00:03:46,620
“Abi na Galilee yu too from kom?

82
00:03:46,620 --> 00:03:47,780
If yu look well,

83
00:03:47,780 --> 00:03:50,880
yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”

84
00:03:50,880 --> 00:03:52,140
Afta dis,

85
00:03:52,140 --> 00:03:55,660
evribody bigin go en house.

