﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,700
Den Jesus sey,

2
00:00:07,700 --> 00:00:10,520
“Na mi bi di lite wey dey di world,

3
00:00:10,520 --> 00:00:12,740
anybody wey follow mi,

4
00:00:12,740 --> 00:00:15,100
nor go waka for darkness lie-lie,

5
00:00:15,100 --> 00:00:18,800
but e go get di lite wey go gi-am life.”

6
00:00:18,800 --> 00:00:22,620
Di Farisee pipol kon dey argue with am sey,

7
00:00:22,620 --> 00:00:26,000
“Yu dey tok about yorsef and wetin yu tok,

8
00:00:26,000 --> 00:00:27,120
nor bi true.”

9
00:00:27,120 --> 00:00:28,740
Jesus ansa dem,

10
00:00:28,740 --> 00:00:32,220
“Even if I dey tok about mysef,

11
00:00:32,220 --> 00:00:34,720
wetin I dey tok na true,

12
00:00:34,720 --> 00:00:38,140
bikos I know where I from kom and where I dey go.

13
00:00:38,140 --> 00:00:41,820
But una nor know where I from kom or where I dey go.

14
00:00:41,820 --> 00:00:45,680
Una dey judge pesin with wetin una si with una eye,

15
00:00:45,680 --> 00:00:47,800
but I nor dey judge pipol like dat.

16
00:00:47,800 --> 00:00:49,080
But,

17
00:00:49,080 --> 00:00:50,980
if I sey pesin do bad,

18
00:00:50,980 --> 00:00:53,680
di tins wey I si and tok about,

19
00:00:53,680 --> 00:00:54,520
na true,

20
00:00:54,520 --> 00:00:58,180
as e bi sey nor bi only mi dey tok am.

21
00:00:58,180 --> 00:01:00,920
Na mi and my Papa wey send mi,

22
00:01:00,920 --> 00:01:02,380
dey tok am togeda.

23
00:01:02,380 --> 00:01:03,760
God word sey,

24
00:01:03,760 --> 00:01:06,640
‘Wetin two pipol bear witness about,

25
00:01:06,640 --> 00:01:07,200
na true.’

26
00:01:07,200 --> 00:01:11,520
I dey bear witness about mysef and my Papa wey send mi,

27
00:01:11,520 --> 00:01:13,520
dey bear witness about mi too.”

28
00:01:13,520 --> 00:01:15,480
Dem kon bigin kweshon am,

29
00:01:15,480 --> 00:01:18,000
“Who bi yor Papa sef?”

30
00:01:18,000 --> 00:01:19,600
Jesus ansa dem,

31
00:01:19,600 --> 00:01:23,240
“Una nor know mi or my Papa,

32
00:01:23,240 --> 00:01:24,440
if to sey una know mi,

33
00:01:24,440 --> 00:01:26,820
una for know my Papa too.”

34
00:01:26,820 --> 00:01:30,820
Jesus dey tok to dem near di box where dem dey put ofrin money,

35
00:01:30,820 --> 00:01:32,640
wey dey inside di temple.

36
00:01:32,640 --> 00:01:34,080
Nobody fit katch am,

37
00:01:34,080 --> 00:01:36,000
bikos en time neva rish.

38
00:01:36,000 --> 00:01:38,400
Den Jesus kon tell dem again,

39
00:01:38,400 --> 00:01:41,660
“I dey go and una go look for mi,

40
00:01:41,660 --> 00:01:44,020
but una go die inside una sin.

41
00:01:44,020 --> 00:01:45,340
Where I dey go,

42
00:01:45,340 --> 00:01:47,140
una nor go fit kom der.”

43
00:01:47,140 --> 00:01:49,760
So di Jew oga dem kon dey ask,

44
00:01:49,760 --> 00:01:52,660
“Abi e won go kill ensef?

45
00:01:52,660 --> 00:01:54,240
As e dey tok sey,

46
00:01:54,240 --> 00:01:55,620
‘Where I dey go,

47
00:01:55,620 --> 00:01:57,440
una nor go fit kom der?’ ”

48
00:01:57,440 --> 00:01:59,460
Jesus ansa dem,

49
00:01:59,460 --> 00:02:01,720
“Na groun una from kom,

50
00:02:01,720 --> 00:02:02,920
but mi,

51
00:02:02,920 --> 00:02:04,640
na heaven I from kom.

52
00:02:04,640 --> 00:02:06,440
Una kom from dis world,

53
00:02:06,440 --> 00:02:08,400
but I nor kom from dis world.

54
00:02:08,400 --> 00:02:12,640
Na dis make mi sey una go die inside una sin.

55
00:02:12,640 --> 00:02:14,240
Unless una bilive sey,

56
00:02:14,240 --> 00:02:17,220
‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’,

57
00:02:17,220 --> 00:02:19,500
una go die inside una sin.”

58
00:02:19,500 --> 00:02:21,640
Den dem ask am,

59
00:02:21,640 --> 00:02:23,800
“Who yu bi sef?”

60
00:02:23,800 --> 00:02:25,120
Jesus ansa,

61
00:02:25,120 --> 00:02:28,200
“Na wetin I tell una from di biginnin.

62
00:02:28,200 --> 00:02:31,360
I get plenty tins to tok about wetin una dey do,

63
00:02:31,360 --> 00:02:33,400
but my Papa wey send mi,

64
00:02:33,400 --> 00:02:37,980
nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”

65
00:02:37,980 --> 00:02:42,540
(But dem nor undastand sey e dey tok about en Papa for heaven).

66
00:02:42,540 --> 00:02:44,400
Den Jesus sey,

67
00:02:44,400 --> 00:02:47,360
“Wen una don karry mi put for cross,

68
00:02:47,360 --> 00:02:49,220
una go know who I bi.

69
00:02:49,220 --> 00:02:51,880
I nor just dey do anytin wey I like,

70
00:02:51,880 --> 00:02:54,460
but I dey always do wetin my Papa tell mi.

71
00:02:54,460 --> 00:02:57,240
And di Pesin wey send mi dey with mi.

72
00:02:57,240 --> 00:02:58,920
E nor dey leave mi,

73
00:02:58,920 --> 00:03:01,900
bikos I always dey do di tins wey E wont.”

74
00:03:01,900 --> 00:03:03,160
As e dey tok,

75
00:03:03,160 --> 00:03:04,840
many pipol kon bilive am.

