﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,200
Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am,

2
00:00:09,200 --> 00:00:11,580
“If una obey wetin I dey tish una,

3
00:00:11,580 --> 00:00:13,620
den una go bi my disciples

4
00:00:13,620 --> 00:00:17,840
and una go know di trut and di trut go free una.”

5
00:00:17,840 --> 00:00:19,400
Dem tell am,

6
00:00:19,400 --> 00:00:22,160
“All of us na Abraham pikin,

7
00:00:22,160 --> 00:00:25,000
wi neva bi slave to anybody before.

8
00:00:25,000 --> 00:00:25,920
Why yu dey sey,

9
00:00:25,920 --> 00:00:27,560
wi go dey free?”

10
00:00:27,560 --> 00:00:29,840
Jesus ansa dem,

11
00:00:29,840 --> 00:00:31,960
“Na true word I dey tell una,

12
00:00:31,960 --> 00:00:33,760
anybody wey dey kommit sin,

13
00:00:33,760 --> 00:00:36,860
na sin bi di masta wey dey rule am.

14
00:00:36,860 --> 00:00:41,840
Pesin wey bi slave nor dey stay for inside dat family forever,

15
00:00:41,840 --> 00:00:44,000
but pesin wey bi pikin for di family,

16
00:00:44,000 --> 00:00:46,080
naim dey stay forever.

17
00:00:46,080 --> 00:00:48,800
So wen Man Pikin free una,

18
00:00:48,800 --> 00:00:50,460
una don dey free bi dat.

19
00:00:50,460 --> 00:00:53,840
I know sey una kom from Abraham family,

20
00:00:53,840 --> 00:00:58,180
but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.

21
00:00:58,180 --> 00:01:01,680
Na wetin I si wen I dey with my Papa,

22
00:01:01,680 --> 00:01:02,760
naim I dey tell una,

23
00:01:02,760 --> 00:01:07,140
so make una dey do di tins wey una hear from my Papa.”

24
00:01:07,140 --> 00:01:08,160
Dem tell am,

25
00:01:08,160 --> 00:01:12,360
“Na Abraham bi awa papa.”

26
00:01:12,360 --> 00:01:14,520
Den Jesus ansa dem,

27
00:01:14,520 --> 00:01:16,560
“If una bi Abraham pikin,

28
00:01:16,560 --> 00:01:19,060
una for dey do di tins wey Abraham do.

29
00:01:19,060 --> 00:01:20,760
But una won kill mi,

30
00:01:20,760 --> 00:01:24,540
bikos I tell una di real trut wey I hear from God.

31
00:01:24,540 --> 00:01:27,500
Abraham nor do wetin una dey do so o-o.

32
00:01:27,500 --> 00:01:30,620
Una dey do di tins wey una papa do.”

33
00:01:30,620 --> 00:01:32,380
Dem kon tell Jesus,

34
00:01:32,380 --> 00:01:36,000
“Awa papa nor born us for outside marriage.

35
00:01:36,000 --> 00:01:39,440
Na God ensef bi di papa wey wi get.”

36
00:01:39,440 --> 00:01:41,040
Den Jesus ansa,

37
00:01:41,040 --> 00:01:43,920
“If to sey na God bi una Papa,

38
00:01:43,920 --> 00:01:45,320
una for like mi,

39
00:01:45,320 --> 00:01:49,420
bikos I kom from God and as I dey so,

40
00:01:49,420 --> 00:01:51,540
I nor kom do my own tins,

41
00:01:51,540 --> 00:01:53,140
bikos na-im send mi.

42
00:01:53,140 --> 00:01:56,560
Na bikos una nor won asept wetin I dey tish,

43
00:01:56,560 --> 00:01:59,980
naim make una nor fit undastand wetin I dey tok.

44
00:01:59,980 --> 00:02:04,520
Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont,

45
00:02:04,520 --> 00:02:06,040
naim una dey do.

46
00:02:06,040 --> 00:02:10,240
E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good,

47
00:02:10,240 --> 00:02:12,760
as e nor get any good tin inside am.

48
00:02:12,760 --> 00:02:14,720
Anytime e dey tok,

49
00:02:14,720 --> 00:02:16,900
na di lie wey dey inside am,

50
00:02:16,900 --> 00:02:18,600
na-im e dey tok,

51
00:02:18,600 --> 00:02:19,800
e bi lie-lie pesin,

52
00:02:19,800 --> 00:02:22,260
bikos naim bi lie-lie papa.

53
00:02:22,260 --> 00:02:24,760
Na bikos I dey tell una true word,

54
00:02:24,760 --> 00:02:26,940
naim make una nor gri bilive mi.

55
00:02:26,940 --> 00:02:30,800
Who among una go fit show sey I kommit sin?

56
00:02:30,800 --> 00:02:32,900
Since I dey tell una true word,

57
00:02:32,900 --> 00:02:34,660
why una nor won bilive mi?

58
00:02:34,660 --> 00:02:36,560
Di pesin wey bi God pikin,

59
00:02:36,560 --> 00:02:40,500
dey listin and do wetin dem rite for God word.

60
00:02:40,500 --> 00:02:44,720
Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word,

61
00:02:44,720 --> 00:02:46,860
bikos una nor bi God Pikin.”

62
00:02:46,860 --> 00:02:50,500
So di pipol kon sey,

63
00:02:50,500 --> 00:02:54,360
“E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”

64
00:02:54,360 --> 00:02:56,600
Jesus kon tell dem,

65
00:02:56,600 --> 00:02:58,480
“I nor get demon.

66
00:02:58,480 --> 00:02:59,920
I dey respet my Papa,

67
00:02:59,920 --> 00:03:01,640
but una nor gri respet mi.

68
00:03:01,640 --> 00:03:03,920
I nor wont make una praiz mi,

69
00:03:03,920 --> 00:03:05,440
but na God,

70
00:03:05,440 --> 00:03:06,840
di One wey dey heaven,

71
00:03:06,840 --> 00:03:11,440
na-im wi suppose praiz and E go judge evribody for di korrect way.

72
00:03:11,440 --> 00:03:13,400
I dey tell una true word,

73
00:03:13,400 --> 00:03:15,960
if anybody follow wetin I dey tish,

74
00:03:15,960 --> 00:03:17,720
e nor go die again.”

75
00:03:17,720 --> 00:03:19,600
Den di pipol sey,

76
00:03:19,600 --> 00:03:21,720
“Eehen!

77
00:03:21,720 --> 00:03:24,640
Wi don know naw sey demon dey inside yu.

78
00:03:24,640 --> 00:03:27,000
Abraham and di profets don die,

79
00:03:27,000 --> 00:03:28,360
but yu dey tell us sey,

80
00:03:28,360 --> 00:03:31,400
‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’

81
00:03:31,400 --> 00:03:35,060
Yu big pass awa papa Abraham and all di profets wey don die?

82
00:03:35,060 --> 00:03:37,020
Who yu tink sey yu bi sef?”

83
00:03:37,020 --> 00:03:38,600
Jesus ansa,

84
00:03:38,600 --> 00:03:41,000
“If I dey praiz mysef,

85
00:03:41,000 --> 00:03:43,400
my praiz na yeye one.

86
00:03:43,400 --> 00:03:46,680
Di pesin wey dey praiz mi na my Papa,

87
00:03:46,680 --> 00:03:48,300
wey una dey sey,

88
00:03:48,300 --> 00:03:49,980
‘Na-im bi awa God.’

89
00:03:49,980 --> 00:03:51,560
Una nor know am,

90
00:03:51,560 --> 00:03:55,320
but I know am and if I sey I nor know am,

91
00:03:55,320 --> 00:03:57,280
I dey lie like una.

92
00:03:57,280 --> 00:04:00,160
I know am and I dey follow wetin e dey tok.

93
00:04:00,160 --> 00:04:05,440
Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom.

94
00:04:05,440 --> 00:04:08,060
E si am and e happy well-well.”

95
00:04:08,060 --> 00:04:10,200
Den di pipol ask am,

96
00:04:10,200 --> 00:04:14,340
“Yu neva old rish fifty years and yu sey yu don si Abraham?”

97
00:04:14,340 --> 00:04:16,360
Jesus ansa dem,

98
00:04:16,360 --> 00:04:18,600
“Na true word I dey tell una so,

99
00:04:18,600 --> 00:04:20,560
before dem born Abraham,

100
00:04:20,560 --> 00:04:21,980
I don already dey!”

101
00:04:21,980 --> 00:04:23,160
Den,

102
00:04:23,160 --> 00:04:25,560
dem kon pick stone won stone am,

103
00:04:25,560 --> 00:04:30,320
but Jesus hide kon komot from di temple aria.

