﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,520
Wen Jesus dey waka pass,

2
00:00:07,520 --> 00:00:11,060
e kon si one man wey blind from di time wey en mama born am.

3
00:00:11,060 --> 00:00:13,460
En disciples ask am,

4
00:00:13,460 --> 00:00:14,600
“Tisha,

5
00:00:14,600 --> 00:00:16,060
na wish pesin sin,

6
00:00:16,060 --> 00:00:19,540
wey make dis man blind since di time en mama born am?

7
00:00:19,540 --> 00:00:22,560
Na di man or na en papa and mama?”

8
00:00:22,560 --> 00:00:24,640
Jesus ansa dem,

9
00:00:24,640 --> 00:00:28,240
“Nor bi di man or en papa and mama sin,

10
00:00:28,240 --> 00:00:30,620
but e blind since dem born am,

11
00:00:30,620 --> 00:00:35,940
bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.

12
00:00:35,940 --> 00:00:41,680
I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark,

13
00:00:41,680 --> 00:00:44,340
bikos nite dey kom wen nobody go fit work.

14
00:00:44,340 --> 00:00:47,380
As far as I dey inside dis world,

15
00:00:47,380 --> 00:00:49,780
na mi bi di lite for di world.

16
00:00:49,780 --> 00:00:51,620
“Afta e tok finish,

17
00:00:51,620 --> 00:00:56,780
e spit for groun kon take di san-san wey e spit put take rub di blind man eye.

18
00:00:56,780 --> 00:00:58,440
Den e tell am,

19
00:00:58,440 --> 00:01:06,060
Make yu go wosh yor face inside di pond wey dem dey koll Siloam (dis name mean ‘Send’).”

20
00:01:06,060 --> 00:01:10,100
So di blind man kon go wosh en face as Jesus tell am.

21
00:01:10,100 --> 00:01:11,720
As e dey kom back,

22
00:01:11,720 --> 00:01:13,260
e kon bigin si.

23
00:01:13,260 --> 00:01:16,720
Den en neighbours and oda pipol wey dey si am dey beg before,

24
00:01:16,720 --> 00:01:17,920
kon ask sey,

25
00:01:17,920 --> 00:01:22,380
“Dis nor bi di man wey dey sidan dey beg for money?”

26
00:01:22,380 --> 00:01:23,880
Some pipol ansa,

27
00:01:23,880 --> 00:01:26,620
“Na-im o-o!”

28
00:01:26,620 --> 00:01:28,000
Odas tok sey,

29
00:01:28,000 --> 00:01:30,400
“Nor bi en,

30
00:01:30,400 --> 00:01:32,240
but e look like am.”

31
00:01:32,240 --> 00:01:33,760
Di man ensef kon sey,

32
00:01:33,760 --> 00:01:36,140
“Na mi bi di pesin.”

33
00:01:36,140 --> 00:01:37,320
Dem ask am,

34
00:01:37,320 --> 00:01:40,300
“Wetin happen wey make yu bigin si?”

35
00:01:40,300 --> 00:01:42,420
E ansa dem,

36
00:01:42,420 --> 00:01:45,920
“Na di man wey dem dey koll Jesus take san-san wey e spit put rub my eye.

37
00:01:45,920 --> 00:01:46,840
Den e tell mi sey,

38
00:01:46,840 --> 00:01:52,960
‘Make yu go Siloam go wosh yor face.’

39
00:01:52,960 --> 00:01:55,040
Afta I go wosh my face for di pond,

40
00:01:55,040 --> 00:01:57,020
I kon bigin si.”

41
00:01:57,020 --> 00:01:58,360
Naim dem ask am,

42
00:01:58,360 --> 00:02:01,200
“Where di man dey?”

43
00:02:01,200 --> 00:02:02,920
E ansa dem,

44
00:02:02,920 --> 00:02:04,500
“I nor know o-o.”

45
00:02:04,500 --> 00:02:07,960
Dem take di man wey blind before go meet di Farisee pipol,

46
00:02:07,960 --> 00:02:12,940
(bikos na for Sabat Day Jesus spit for san-san take rub di blind man eye).

47
00:02:12,940 --> 00:02:15,400
Naim di Farisee pipol ask am again,

48
00:02:15,400 --> 00:02:18,280
“How yu take bigin si?”

49
00:02:18,280 --> 00:02:19,520
E ansa dem,

50
00:02:19,520 --> 00:02:24,400
“E take di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face,

51
00:02:24,400 --> 00:02:26,280
I kon bigin si.”

52
00:02:26,280 --> 00:02:28,200
Some Farisee pipol kon sey,

53
00:02:28,200 --> 00:02:30,840
“Nor bi God send dis man,

54
00:02:30,840 --> 00:02:34,440
bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.”

55
00:02:34,440 --> 00:02:35,640
But odas sey,

56
00:02:35,640 --> 00:02:40,760
“How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?”

57
00:02:40,760 --> 00:02:43,240
Dis argument kon make di pipol divide.

58
00:02:43,240 --> 00:02:45,600
Dem ask di man wey blind before sey,

59
00:02:45,600 --> 00:02:48,940
“Wetin yu tink about di man wey make yu dey si?”

60
00:02:48,940 --> 00:02:50,760
Di man ansa,

61
00:02:50,760 --> 00:02:53,400
“Na profet e bi.”

62
00:02:53,400 --> 00:02:55,600
Di Jew oga dem nor gri bilive sey,

63
00:02:55,600 --> 00:02:57,520
true-true di man blind before,

64
00:02:57,520 --> 00:02:59,440
so dem kon koll en papa and mama.

65
00:02:59,440 --> 00:03:01,120
Dem ask dem,

66
00:03:01,120 --> 00:03:03,120
“Na una pikin bi dis?

67
00:03:03,120 --> 00:03:04,880
Na true sey e blind wen una born am?

68
00:03:04,880 --> 00:03:07,260
How e kon take dey si naw?”

69
00:03:07,260 --> 00:03:09,700
So en papa and mama ansa,

70
00:03:09,700 --> 00:03:14,460
“Wi know sey dis na awa pikin and e blind wen wi born am.

71
00:03:14,460 --> 00:03:19,940
But wi nor know how e take bigin si or even who open en eye.

72
00:03:19,940 --> 00:03:21,760
Make una ask am,

73
00:03:21,760 --> 00:03:23,580
e don big rish to tok for ensef.”

74
00:03:23,580 --> 00:03:26,240
(En papa and mama tok like dis,

75
00:03:26,240 --> 00:03:29,620
bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey,

76
00:03:29,620 --> 00:03:33,060
“Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ,

77
00:03:33,060 --> 00:03:35,460
dem go drive am komot from di sinagog.”

78
00:03:35,460 --> 00:03:37,920
Na dis one make en papa and mama sey,

79
00:03:37,920 --> 00:03:39,520
“Make dem ask am,

80
00:03:39,520 --> 00:03:41,980
bikos e don big rish to tok for ensef).”

81
00:03:41,980 --> 00:03:44,160
So dem koll di man again kon tell am,

82
00:03:44,160 --> 00:03:47,960
“Make yu promise before God sey yu go tok di trut,

83
00:03:47,960 --> 00:03:50,300
bikos wi know sey di man na sina.”

84
00:03:50,300 --> 00:03:52,260
Man ansa dem,

85
00:03:52,260 --> 00:03:54,240
“Weda na sina e bi,

86
00:03:54,240 --> 00:03:55,320
I nor know!

87
00:03:55,320 --> 00:03:56,920
But wetin I know bi sey,

88
00:03:56,920 --> 00:03:57,640
before I blind,

89
00:03:57,640 --> 00:03:59,140
but naw,

90
00:03:59,140 --> 00:04:00,940
I don dey si.”

91
00:04:00,940 --> 00:04:02,520
So dem ask am again,

92
00:04:02,520 --> 00:04:04,400
“Wetin e do?

93
00:04:04,400 --> 00:04:06,580
How e take make yu dey si sef?”

94
00:04:06,580 --> 00:04:10,080
E kon ansa dem,

95
00:04:10,080 --> 00:04:12,220
“I don tell una before,

96
00:04:12,220 --> 00:04:13,320
but una nor gri.

97
00:04:13,320 --> 00:04:15,200
Why una won hear am again?

98
00:04:15,200 --> 00:04:15,780
Abi,

99
00:04:15,780 --> 00:04:19,880
una won bi en disciples too?”

100
00:04:19,880 --> 00:04:21,740
Dem shaut for di man kon sey,

101
00:04:21,740 --> 00:04:24,160
“Na yu bi en disciple.

102
00:04:24,160 --> 00:04:26,360
Wi bi Moses disciples.

103
00:04:26,360 --> 00:04:28,800
Wi know sey God tok to Moses,

104
00:04:28,800 --> 00:04:31,620
but wi nor know where dis man from kom.”

105
00:04:31,620 --> 00:04:33,300
Di man kon sey,

106
00:04:33,300 --> 00:04:35,300
“I sopraiz for una o-o.

107
00:04:35,300 --> 00:04:36,940
Una nor know where e from kom,

108
00:04:36,940 --> 00:04:38,600
but na-im open my eye!

109
00:04:38,600 --> 00:04:41,660
Wi know sey God nor dey listin to anybody wey dey sin,

110
00:04:41,660 --> 00:04:43,480
but if pesin dey do wetin God tok,

111
00:04:43,480 --> 00:04:44,640
God go hear en prayer.

112
00:04:44,640 --> 00:04:46,560
Wi neva hear before sey,

113
00:04:46,560 --> 00:04:49,560
anybody don fit make pesin wey blind si.

114
00:04:49,560 --> 00:04:51,600
If God nor send dis man,

115
00:04:51,600 --> 00:04:53,320
e nor go fit do dis kind tin.”

116
00:04:53,320 --> 00:04:55,080
Dem kon tell di man,

117
00:04:55,080 --> 00:04:58,020
“Na for inside sins born yu,

118
00:04:58,020 --> 00:05:01,420
yu tink sey yu go fit tish us anytin?”

119
00:05:01,420 --> 00:05:03,780
So dem drive am komot from di place.

120
00:05:03,780 --> 00:05:06,840
Wen Jesus hear sey dem don drive di man komot,

121
00:05:06,840 --> 00:05:09,300
e go look for am kon ask am,

122
00:05:09,300 --> 00:05:11,980
“Yu bilive who Man Pikin bi?”

123
00:05:11,980 --> 00:05:13,820
Di man kon sey,

124
00:05:13,820 --> 00:05:14,880
“Oga God,

125
00:05:14,880 --> 00:05:16,120
tell mi who e bi,

126
00:05:16,120 --> 00:05:17,720
make I for fit bilive am?”

127
00:05:17,720 --> 00:05:19,820
Jesus ansa am,

128
00:05:19,820 --> 00:05:22,560
“Na-im dey here dey tok to yu so.”

129
00:05:22,560 --> 00:05:24,500
Di man kon sey,

130
00:05:24,500 --> 00:05:25,780
“Oga God,

131
00:05:25,780 --> 00:05:27,860
I bilive.”

132
00:05:27,860 --> 00:05:30,560
Den e knee down kon woship Jesus.

133
00:05:30,560 --> 00:05:32,180
Jesus tell am,

134
00:05:32,180 --> 00:05:34,560
“I kon judge pipol for di world,

135
00:05:34,560 --> 00:05:36,680
so dat di pipol wey nor dey si,

136
00:05:36,680 --> 00:05:40,880
go bigin si and doz wey tink sey dem dey si,

137
00:05:40,880 --> 00:05:42,760
dia eye go blind.”

138
00:05:42,760 --> 00:05:46,440
Wen di Farisee pipol wey dey der hear wetin Jesus tok,

139
00:05:46,440 --> 00:05:48,000
dem kon ask am,

140
00:05:48,000 --> 00:05:50,480
“Yu tink sey wisef blind?”

141
00:05:50,480 --> 00:05:52,500
Jesus ansa dem,

142
00:05:52,500 --> 00:05:54,860
“If una gri sey una blind,

143
00:05:54,860 --> 00:05:58,100
God nor go kondemn una bikos of una sin,

144
00:05:58,100 --> 00:06:00,620
but as una tok sey una dey si so,

145
00:06:00,620 --> 00:06:04,440
una sin dey for una head.”

