﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,740
“Na true word I dey tell una,

2
00:00:06,740 --> 00:00:11,280
pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep,

3
00:00:11,280 --> 00:00:14,440
but klimb pass anoda side enter di place,

4
00:00:14,440 --> 00:00:15,760
na big tif.

5
00:00:15,760 --> 00:00:17,880
Di pesin wey pass di door enter,

6
00:00:17,880 --> 00:00:20,960
na-im bi di shepad wey dey guide di sheep.

7
00:00:20,960 --> 00:00:29,420
Di gateman go open di door for am and en sheep go hear en vois wen e koll dia name and e go lead dem kom out.

8
00:00:29,420 --> 00:00:32,800
Wen e don bring all en sheep kom out,

9
00:00:32,800 --> 00:00:35,800
e go-go dia front and di sheep go follow am,

10
00:00:35,800 --> 00:00:38,040
bikos dem know en vois.

11
00:00:38,040 --> 00:00:40,040
Dem nor go gri follow strenja,

12
00:00:40,040 --> 00:00:41,660
but dem go run from dem,

13
00:00:41,660 --> 00:00:44,380
bikos dem nor know di strenja vois.”

14
00:00:44,380 --> 00:00:46,680
Jesus tell dem dis parabol,

15
00:00:46,680 --> 00:00:49,080
but dem nor undastand wetin e tok.

16
00:00:49,080 --> 00:00:51,160
So Jesus kon tell dem again,

17
00:00:51,160 --> 00:00:53,800
“I dey tell una true word.

18
00:00:53,800 --> 00:00:57,720
Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter.

19
00:00:57,720 --> 00:01:00,480
All di pipol wey kom before mi,

20
00:01:00,480 --> 00:01:04,780
na big tif dem bi and di sheep nor go gri listin to dem.

21
00:01:04,780 --> 00:01:06,320
Na mi bi di door,

22
00:01:06,320 --> 00:01:08,600
anybody wey enter thru mi,

23
00:01:08,600 --> 00:01:09,740
God go save am.

24
00:01:09,740 --> 00:01:14,000
E go-go inside and out and e go si betta grass chop.

25
00:01:14,000 --> 00:01:15,880
Di tin wey tif dey do,

26
00:01:15,880 --> 00:01:16,980
na to tif,

27
00:01:16,980 --> 00:01:19,280
kill and distroy pipol,

28
00:01:19,280 --> 00:01:19,800
but mi,

29
00:01:19,800 --> 00:01:22,640
I kom so dat pipol go get life,

30
00:01:22,640 --> 00:01:24,740
di kind life wey full well-well.

31
00:01:24,740 --> 00:01:26,960
“Na mi bi di good shepad.

32
00:01:26,960 --> 00:01:29,200
Di good shepad ready to die for di sheep.

33
00:01:29,200 --> 00:01:34,840
Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep,

34
00:01:34,840 --> 00:01:37,560
e go run wen e si lion dey kom,

35
00:01:37,560 --> 00:01:39,440
so di lion go skata di sheep,

36
00:01:39,440 --> 00:01:41,220
kon kill di ones wey e katch.

37
00:01:41,220 --> 00:01:43,940
Bikos di pesin nor kare for di sheep,

38
00:01:43,940 --> 00:01:45,820
go run leave dem.

39
00:01:45,820 --> 00:01:47,920
“Na mi bi di good shepad,

40
00:01:47,920 --> 00:01:51,600
I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.

41
00:01:51,600 --> 00:01:54,800
Bikos my Papa know mi and I know am,

42
00:01:54,800 --> 00:01:57,340
naim make mi ready to die for di sheep.

43
00:01:57,340 --> 00:02:00,160
I get oda sheep wey nor dey here.

44
00:02:00,160 --> 00:02:04,120
I must gada dem too and dem go listin to my vois,

45
00:02:04,120 --> 00:02:08,700
all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.

46
00:02:08,700 --> 00:02:12,480
Na dis bi di rizin wey make my Papa like mi,

47
00:02:12,480 --> 00:02:15,360
bikos I ready to sakrifice my life,

48
00:02:15,360 --> 00:02:17,240
so dat I go fit get di life back again.

49
00:02:17,240 --> 00:02:20,080
Nobody go fit take my life from mi,

50
00:02:20,080 --> 00:02:25,520
but na mi go put am down by mysef and I get di pawa to take am back again.

51
00:02:25,520 --> 00:02:28,240
Dis na wetin God kommand mi to do.”

52
00:02:28,240 --> 00:02:33,140
Anoda big kworel kon happen between di Jew pipol bikos of wetin Jesus tok.

53
00:02:33,140 --> 00:02:35,200
Many of dem kon dey sey,

54
00:02:35,200 --> 00:02:38,520
“Demon dey inside am and en head nor korrect.

55
00:02:38,520 --> 00:02:41,300
Why una dey listin to am sef?”

56
00:02:41,300 --> 00:02:43,120
Odas kon sey,

57
00:02:43,120 --> 00:02:46,960
“Di pesin wey get demon nor go fit tok like dis.

58
00:02:46,960 --> 00:02:50,140
No demon fit make blind pesin si.”

