﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,960
E get one man,

2
00:00:06,960 --> 00:00:09,320
en name na Lazarus and e nor well.

3
00:00:09,320 --> 00:00:11,160
En with Mary and Marta,

4
00:00:11,160 --> 00:00:13,380
en sistas kom from Betany.

5
00:00:13,380 --> 00:00:16,720
Na dis Mary pour perfume for Jesus leg,

6
00:00:16,720 --> 00:00:18,700
kon klean dem with en hair.

7
00:00:18,700 --> 00:00:22,160
So di sistas kon send message go meet Jesus sey,

8
00:00:22,160 --> 00:00:22,960
Oga God,

9
00:00:22,960 --> 00:00:25,800
yor friend wey yu love well-well nor well.

10
00:00:25,800 --> 00:00:27,720
Wen Jesus hear di message,

11
00:00:27,720 --> 00:00:29,160
e kon sey,

12
00:00:29,160 --> 00:00:32,000
“Dis sickness nor go kill Lazarus.

13
00:00:32,000 --> 00:00:34,820
E go make God and en pikin get honor.”

14
00:00:34,820 --> 00:00:37,160
(E klear sey Jesus love Marta,

15
00:00:37,160 --> 00:00:39,020
Mary and Lazarus well-well.)

16
00:00:39,020 --> 00:00:41,840
Afta e hear sey Lazarus nor well,

17
00:00:41,840 --> 00:00:44,560
e stay where e dey for anoda two days.

18
00:00:44,560 --> 00:00:46,680
Den e kon tell en disciples,

19
00:00:46,680 --> 00:00:49,420
“Make wi go back to Judea.”

20
00:00:49,420 --> 00:00:51,560
But en disciples ask am,

21
00:00:51,560 --> 00:00:53,120
“Tisha,

22
00:00:53,120 --> 00:00:58,180
nor bi di place where di Jew pipol won for kill us yu sey make wi go again so?”

23
00:00:58,180 --> 00:00:59,680
Jesus ansa,

24
00:00:59,680 --> 00:01:04,640
“Evriday get twelf hours wey lite dey take shine,

25
00:01:04,640 --> 00:01:07,160
so pipol nor dey fear to waka,

26
00:01:07,160 --> 00:01:09,000
bikos dem dey si well-well,

27
00:01:09,000 --> 00:01:10,900
as e bi sey lite dey.

28
00:01:10,900 --> 00:01:13,800
But pesin wey waka for nite,

29
00:01:13,800 --> 00:01:14,920
go fit fall,

30
00:01:14,920 --> 00:01:17,600
bikos e nor get lite to si road.”

31
00:01:17,600 --> 00:01:19,200
Den Jesus tell dem,

32
00:01:19,200 --> 00:01:21,980
“Awa friend Lazarus dey sleep,

33
00:01:21,980 --> 00:01:23,940
but I won go wake am up.”

34
00:01:23,940 --> 00:01:26,060
Di disciples sey,

35
00:01:26,060 --> 00:01:27,280
“Oga God,

36
00:01:27,280 --> 00:01:28,720
if e just dey sleep,

37
00:01:28,720 --> 00:01:30,200
den e go wake-up.”

38
00:01:30,200 --> 00:01:31,780
(Dem tink sey,

39
00:01:31,780 --> 00:01:33,620
wetin Jesus mean bi sey,

40
00:01:33,620 --> 00:01:35,300
Lazarus just dey sleep,

41
00:01:35,300 --> 00:01:37,060
but wetin e mean bi sey,

42
00:01:37,060 --> 00:01:38,460
Lazarus don die.)

43
00:01:38,460 --> 00:01:40,500
So e tell dem sey,

44
00:01:40,500 --> 00:01:42,300
“Lazarus don die.

45
00:01:42,300 --> 00:01:44,500
I happy sey I nor dey der,

46
00:01:44,500 --> 00:01:47,700
so dat una go get anoda shance to bilive mi.

47
00:01:47,700 --> 00:01:50,340
Make una kom make wi go si am.”

48
00:01:50,340 --> 00:01:51,520
So Tomas,

49
00:01:51,520 --> 00:01:54,520
(wey bi Twins) kon tell di oda disciple,

50
00:01:54,520 --> 00:01:56,400
“Make wi follow am go,

51
00:01:56,400 --> 00:01:59,180
so dat wi go die with am.”

52
00:01:59,180 --> 00:02:01,600
Wen Jesus rish Betany,

53
00:02:01,600 --> 00:02:06,420
dem kon tell am sey e don rish for days wey dem beri Lazarus.

54
00:02:06,420 --> 00:02:09,740
(Betany na about two mile from Jerusalem,

55
00:02:09,740 --> 00:02:10,720
and from der,

56
00:02:10,720 --> 00:02:13,400
many Jew pipol kon salot Mary and Marta,

57
00:02:13,400 --> 00:02:15,500
bikos of dia broda wey die.)

58
00:02:15,500 --> 00:02:18,680
So wen Marta hear sey Jesus dey kom,

59
00:02:18,680 --> 00:02:20,480
e kon waka go meet am,

60
00:02:20,480 --> 00:02:22,320
but Mary sidan for house.

61
00:02:22,320 --> 00:02:24,000
Marta tell Jesus,

62
00:02:24,000 --> 00:02:28,200
“Oga God,

63
00:02:28,200 --> 00:02:29,680
if to sey yu dey here,

64
00:02:29,680 --> 00:02:31,800
my broda nor for die.

65
00:02:31,800 --> 00:02:34,480
But I know sey,

66
00:02:34,480 --> 00:02:38,540
God go give yu anytin wey yu ask am.”

67
00:02:38,540 --> 00:02:40,120
So Jesus tell am,

68
00:02:40,120 --> 00:02:42,780
“Yor broda go wake-up again.”

69
00:02:42,780 --> 00:02:45,780
Den Marta sey,

70
00:02:45,780 --> 00:02:54,500
“I know sey e go wake-up again for di resureshon day.”

71
00:02:54,500 --> 00:02:56,040
Jesus ansa am,

72
00:02:56,040 --> 00:02:59,960
“Na mi bi di resureshon and na mi dey give life.

73
00:02:59,960 --> 00:03:05,460
Anybody wey bilive mi go get life even if e don die

74
00:03:05,460 --> 00:03:07,880
and di pesin wey bilive mi for dis life,

75
00:03:07,880 --> 00:03:09,440
nor go ever die.

76
00:03:09,440 --> 00:03:10,640
Marta,

77
00:03:10,640 --> 00:03:12,780
yu bilive wetin I tok so?”

78
00:03:12,780 --> 00:03:15,520
Marta kon ansa,

79
00:03:15,520 --> 00:03:20,020
“Yes!

80
00:03:20,020 --> 00:03:21,520
Oga God,

81
00:03:21,520 --> 00:03:23,480
I bilive sey yu bi Christ,

82
00:03:23,480 --> 00:03:25,480
God Pikin,

83
00:03:25,480 --> 00:03:27,980
wey kom dis world.”

84
00:03:27,980 --> 00:03:30,360
Den Marta go meet Mary,

85
00:03:30,360 --> 00:03:33,480
en sista kon tok for en ear sey,

86
00:03:33,480 --> 00:03:37,040
“Di tisha dey here and e won si yu.”

87
00:03:37,040 --> 00:03:40,120
Wen Mary hear wetin e tok,

88
00:03:40,120 --> 00:03:42,040
e kon get up go meet Jesus.

89
00:03:42,040 --> 00:03:45,380
Jesus still dey outside di village wen Marta go meet am.

90
00:03:45,380 --> 00:03:49,760
Wen di pipol wey kom salot Mary si as e waka komot kwik-kwik,

91
00:03:49,760 --> 00:03:52,680
dem kon tink sey na Lazarus grave e for dey go kry,

92
00:03:52,680 --> 00:03:54,540
so dem follow am.

93
00:03:54,540 --> 00:03:56,320
Wen Mary si Jesus,

94
00:03:56,320 --> 00:03:59,000
e fall for en front kon sey,

95
00:03:59,000 --> 00:04:02,840
“Oga God,

96
00:04:02,840 --> 00:04:06,380
if to sey yu dey here,

97
00:04:06,380 --> 00:04:10,160
my broda nor for die.”

98
00:04:10,160 --> 00:04:14,920
Jesus kon si as Mary and di oda pipol dey kry.

99
00:04:14,920 --> 00:04:18,900
So e sorry for dem and di tin pain am well-well.

100
00:04:18,900 --> 00:04:21,040
E kon ask dem,

101
00:04:21,040 --> 00:04:22,400
“Where una beri am put?”

102
00:04:22,400 --> 00:04:25,760
Den dem tell am,

103
00:04:25,760 --> 00:04:27,900
“Oga God,

104
00:04:27,900 --> 00:04:31,680
kom make wi show yu.”

105
00:04:31,680 --> 00:04:34,640
Jesus kon kry.

106
00:04:34,640 --> 00:04:38,040
Di pipol wey kom salot dem kon sey,

107
00:04:38,040 --> 00:04:41,280
“Jesus love dis man well-well o-o.”

108
00:04:41,280 --> 00:04:43,520
But some among dem sey,

109
00:04:43,520 --> 00:04:45,880
“Dis man wey make blind man si,

110
00:04:45,880 --> 00:04:49,500
e nor fit do make Lazarus nor die?”

111
00:04:49,500 --> 00:04:52,280
Jesus sorry for dem again,

112
00:04:52,280 --> 00:04:54,160
den e waka go di grave.

113
00:04:54,160 --> 00:04:58,700
(Dis grave na big whole inside rock wey dem take big stone kover).

114
00:04:58,700 --> 00:05:00,000
Jesus kon sey,

115
00:05:00,000 --> 00:05:02,840
“Make una remove di stone.”

116
00:05:02,840 --> 00:05:05,480
Marta wey bi Lazarus sista kon sey,

117
00:05:05,480 --> 00:05:07,480
“Oga God,

118
00:05:07,480 --> 00:05:09,320
by dis time e go don dey smell,

119
00:05:09,320 --> 00:05:12,300
bikos e don rish for days wey dem beri am.”

120
00:05:12,300 --> 00:05:13,600
Jesus tell am,

121
00:05:13,600 --> 00:05:15,920
“I nor tell yu before sey,

122
00:05:15,920 --> 00:05:17,760
‘Yu go si God pawa,

123
00:05:17,760 --> 00:05:19,460
if yu bilive mi?’ ”

124
00:05:19,460 --> 00:05:19,920
So,

125
00:05:19,920 --> 00:05:22,840
dem kon roll di stone komot from di grave mout.

126
00:05:22,840 --> 00:05:24,880
Den Jesus look heaven kon sey,

127
00:05:24,880 --> 00:05:26,240
“Papa,

128
00:05:26,240 --> 00:05:32,940
I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.

129
00:05:32,940 --> 00:05:36,160
I know sey Yu dey always hear mi,

130
00:05:36,160 --> 00:05:37,760
but I dey tok like dis,

131
00:05:37,760 --> 00:05:40,560
bikos of di pipol wey stand here naw,

132
00:05:40,560 --> 00:05:43,900
so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”

133
00:05:43,900 --> 00:05:46,360
Wen e don tok dis finish,

134
00:05:46,360 --> 00:05:47,800
e kon shaut,

135
00:05:47,800 --> 00:05:53,180
“Lazarus,

136
00:05:53,180 --> 00:05:56,400
kom out!”

137
00:05:56,400 --> 00:05:58,820
Den Lazarus kom out,

138
00:05:58,820 --> 00:06:02,000
but di klot wey dem take beri am still kover en body.

139
00:06:02,000 --> 00:06:02,560
So,

140
00:06:02,560 --> 00:06:03,980
Jesus tell dem,

141
00:06:03,980 --> 00:06:06,940
“Make una luz di klot komot for en body,

142
00:06:06,940 --> 00:06:08,160
make e dey go.”

143
00:06:08,160 --> 00:06:13,000
Den many pipol among di Jew pipol wey follow Mary go di grave bilive Jesus,

144
00:06:13,000 --> 00:06:15,120
wen dem si wetin happen.

145
00:06:15,120 --> 00:06:19,820
But some among dem go meet di Farisee pipol kon tell dem wetin Jesus do.

146
00:06:19,820 --> 00:06:26,520
Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda,

147
00:06:26,520 --> 00:06:27,360
ask dem,

148
00:06:27,360 --> 00:06:29,040
“Wetin wi go do,

149
00:06:29,040 --> 00:06:31,420
since dis man dey do plenty mirakles?

150
00:06:31,420 --> 00:06:33,640
If wi let am kontinue like dis,

151
00:06:33,640 --> 00:06:39,660
evribody go bilive am and di Roman govnor go kom take di place wey wi dey woship and awa kountry.”

152
00:06:39,660 --> 00:06:42,160
Den won among dem wey en name bi Kaiafas,

153
00:06:42,160 --> 00:06:44,600
wey bi di High Priest dat year kon sey,

154
00:06:44,600 --> 00:06:47,600
“Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen.

155
00:06:47,600 --> 00:06:51,480
Una nor know sey e betta make one man die for evribody,

156
00:06:51,480 --> 00:06:54,560
dan sey make evribody for dis kountry die?”

157
00:06:54,560 --> 00:06:56,400
(Dis man tok like dis,

158
00:06:56,400 --> 00:06:59,520
bikos naim bi di High Priest dat year.

159
00:06:59,520 --> 00:07:00,480
E tok true sey,

160
00:07:00,480 --> 00:07:03,320
Jesus go die for di whole Jew pipol,

161
00:07:03,320 --> 00:07:05,000
but e nor know wetin e tok,

162
00:07:05,000 --> 00:07:07,660
and nor bi for only di Jew pipol,

163
00:07:07,660 --> 00:07:09,600
but make all God shidren,

164
00:07:09,600 --> 00:07:12,560
wey dey di world for gada togeda.)

165
00:07:12,560 --> 00:07:13,760
So from dat day,

166
00:07:13,760 --> 00:07:15,920
dem kon dey plan to kill Jesus.

167
00:07:15,920 --> 00:07:17,620
Bikos of dis,

168
00:07:17,620 --> 00:07:21,160
Jesus nor kon dey waka for Judea as e dey do before,

169
00:07:21,160 --> 00:07:26,280
but en and en disciples kon go stay for di town wey dem dey koll Efraim,

170
00:07:26,280 --> 00:07:27,900
wey near wildaness.

171
00:07:27,900 --> 00:07:30,480
Wen Passova Feast don near,

172
00:07:30,480 --> 00:07:32,640
many pipol for di kountry go Jerusalem,

173
00:07:32,640 --> 00:07:35,160
kon dey make demsef klean for di feast,

174
00:07:35,160 --> 00:07:36,660
as dia tradishon tok.

175
00:07:36,660 --> 00:07:41,240
Dem bigin dey look for Jesus kon dey ask each oda inside di temple yard,

176
00:07:41,240 --> 00:07:43,020
“Wetin yu tink,

177
00:07:43,020 --> 00:07:44,660
e go kom for di feast?”

178
00:07:44,660 --> 00:07:46,440
Abi yu nor tink so?

179
00:07:46,440 --> 00:07:48,040
(By dis time,

180
00:07:48,040 --> 00:07:52,020
di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey,

181
00:07:52,020 --> 00:07:54,620
anybody wey know where Jesus dey,

182
00:07:54,620 --> 00:07:55,940
make e kon tok,

183
00:07:55,940 --> 00:07:59,680
so dat dem go-go katch am).

