﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,620
Six days before Passova Feast rish,

2
00:00:08,620 --> 00:00:09,920
Jesus go Betany,

3
00:00:09,920 --> 00:00:11,200
where Lazarus,

4
00:00:11,200 --> 00:00:13,240
di pesin wey e wake-up from deat,

5
00:00:13,240 --> 00:00:14,080
dey stay.

6
00:00:14,080 --> 00:00:16,920
So dem kon do party for Jesus dat evening.

7
00:00:16,920 --> 00:00:22,820
Marta kon dey serve dem food and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol with Jesus.

8
00:00:22,820 --> 00:00:26,200
Mary take perfume wey dear well-well,

9
00:00:26,200 --> 00:00:30,680
wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg.

10
00:00:30,680 --> 00:00:32,960
Den e use en hair take klean dem.

11
00:00:32,960 --> 00:00:36,980
(Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).

12
00:00:36,980 --> 00:00:39,480
But Judas Iskariot,

13
00:00:39,480 --> 00:00:43,620
one among Jesus disciple (di pesin wey go sell am give en enemies) kon sey,

14
00:00:43,620 --> 00:00:53,060
“Why wi nor sell dis perfume for three hundred koins (money wey pass wetin workers go get for one year) kon give di money to poor pipol?”

15
00:00:53,060 --> 00:00:55,160
(Judas tok like dis,

16
00:00:55,160 --> 00:00:57,040
nor bi sey e kare for poor pipol,

17
00:00:57,040 --> 00:00:58,840
but bikos na tif e bi.

18
00:00:58,840 --> 00:01:01,280
As e bi sey naim dey keep di money,

19
00:01:01,280 --> 00:01:02,420
e dey tif from am.)

20
00:01:02,420 --> 00:01:03,640
Den Jesus ansa,

21
00:01:03,640 --> 00:01:05,960
“Make yu nor trobol di woman,

22
00:01:05,960 --> 00:01:09,540
e do dis tin dey wait di day wen dem go beri mi.

23
00:01:09,540 --> 00:01:11,720
Poor pipol go always dey with una,

24
00:01:11,720 --> 00:01:14,640
but I nor go dey with una all di time.”

25
00:01:14,640 --> 00:01:15,680
For dis time,

26
00:01:15,680 --> 00:01:20,040
plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town,

27
00:01:20,040 --> 00:01:21,800
so dem kon gada,

28
00:01:21,800 --> 00:01:23,800
nor bi bikos of Jesus alone,

29
00:01:23,800 --> 00:01:26,320
but dem won si Lazarus too,

30
00:01:26,320 --> 00:01:27,680
di pesin wey die before,

31
00:01:27,680 --> 00:01:29,180
wey Jesus wake-up.

32
00:01:29,180 --> 00:01:32,440
Di priest oga dem kon plan to kill Lazarus too,

33
00:01:32,440 --> 00:01:34,960
bikos naim make plenty Jew pipol for Jerusalem,

34
00:01:34,960 --> 00:01:36,080
bilive Jesus.

