﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,800
Wen day break,

2
00:00:06,800 --> 00:00:10,820
plenty pipol wey kom di Feast kon hear sey Jesus dey kom Jerusalem.

3
00:00:10,820 --> 00:00:14,320
Di pipol take palm tree leaf go wait am for road.

4
00:00:14,320 --> 00:00:16,040
Dem kon bigin shaut,

5
00:00:16,040 --> 00:00:17,800
“Hosanna,

6
00:00:17,800 --> 00:00:22,960
make God bless di pesin wey E send kom meet us.

7
00:00:22,960 --> 00:00:27,060
Make God bless Israel king!”

8
00:00:27,060 --> 00:00:31,120
Jesus si one small donkey and e kon sidan put,

9
00:00:31,120 --> 00:00:32,660
just as God word sey,

10
00:00:32,660 --> 00:00:35,240
“Pipol wey dey Zion,

11
00:00:35,240 --> 00:00:36,960
make una nor fear;

12
00:00:36,960 --> 00:00:40,940
make una si una king sidan on-top donkey dey kom!”

13
00:00:40,940 --> 00:00:43,960
(En disciples nor undastand dis tins wey dey happen,

14
00:00:43,960 --> 00:00:46,960
until wen Jesus don wake-up from grave,

15
00:00:46,960 --> 00:00:50,280
naim dem kon remember wetin God word sey go happen.)

16
00:00:50,280 --> 00:00:56,000
So di pipol wey dey with am wen e wake Lazarus from grave kon tell odas about am.

17
00:00:56,000 --> 00:00:58,200
And dem gada go meet Jesus,

18
00:00:58,200 --> 00:01:01,180
bikos dem hear sey na-im wake Lazarus from grave.

19
00:01:01,180 --> 00:01:03,720
Den di Farisee pipol kon tell each oda,

20
00:01:03,720 --> 00:01:07,960
“Una dey si sey wetin wi dey do so nor get head!

21
00:01:07,960 --> 00:01:08,600
Si o-o,

22
00:01:08,600 --> 00:01:12,140
evribody don bigin follow am.”

