﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,820
Some Greek pipol go woship God for di feast for Jerusalem.

2
00:00:08,820 --> 00:00:13,880
Dem meet Filip wey kom from Betsaida for Galilee kon tell am,

3
00:00:13,880 --> 00:00:15,140
“Oga God,

4
00:00:15,140 --> 00:00:17,380
wi go like to si Jesus.”

5
00:00:17,380 --> 00:00:19,360
Filip tell Andru,

6
00:00:19,360 --> 00:00:21,540
den dem kon go tell Jesus.

7
00:00:21,540 --> 00:00:23,200
Jesus tell dem,

8
00:00:23,200 --> 00:00:27,080
“Di time don kom wen God go honor en own pikin.

9
00:00:27,080 --> 00:00:28,800
I tell una true word,

10
00:00:28,800 --> 00:00:32,340
if one korn seed fall for groun and e nor die,

11
00:00:32,340 --> 00:00:34,360
e nor go grow,

12
00:00:34,360 --> 00:00:35,340
but if e die,

13
00:00:35,340 --> 00:00:38,340
e go grow kon bear plenty seed.

14
00:00:38,340 --> 00:00:41,140
Anybody wey love en life for dis world,

15
00:00:41,140 --> 00:00:42,140
go luz am,

16
00:00:42,140 --> 00:00:44,820
but di pesin wey nor love en life for dis world,

17
00:00:44,820 --> 00:00:46,720
go get life wey nor dey end.

18
00:00:46,720 --> 00:00:48,540
Anybody wey ready to serve mi,

19
00:00:48,540 --> 00:00:50,860
go must follow mi and where I dey,

20
00:00:50,860 --> 00:00:54,460
na der my savant go dey too.

21
00:00:54,460 --> 00:00:55,900
Anybody wey serve mi,

22
00:00:55,900 --> 00:00:57,840
my Papa go honor am.

23
00:00:57,840 --> 00:01:00,260
“My heart heavy well-well.

24
00:01:00,260 --> 00:01:01,780
Wetin I go tok?

25
00:01:01,780 --> 00:01:02,540
‘Papa,

26
00:01:02,540 --> 00:01:06,220
make yu save mi from dis tin wey won happen’?

27
00:01:06,220 --> 00:01:06,900
No!

28
00:01:06,900 --> 00:01:09,380
Na dis tin make mi kom dis world.

29
00:01:09,380 --> 00:01:10,300
Papa,

30
00:01:10,300 --> 00:01:12,700
make yu honor yor name.”

31
00:01:12,700 --> 00:01:14,780
Den one vois tok from heaven sey,

32
00:01:14,780 --> 00:01:19,520
“I don honor am before and I go honor am again.”

33
00:01:19,520 --> 00:01:22,380
Wen di pipol wey dey di place hear di vois,

34
00:01:22,380 --> 00:01:23,740
some kon sey,

35
00:01:23,740 --> 00:01:26,540
“Di vois sound like tonda”,

36
00:01:26,540 --> 00:01:28,340
but odas sey,

37
00:01:28,340 --> 00:01:31,120
“Na angel dey tok to am.”

38
00:01:31,120 --> 00:01:32,580
Jesus kon sey,

39
00:01:32,580 --> 00:01:35,780
“Dis vois nor tok bikos of mi,

40
00:01:35,780 --> 00:01:37,460
but na bikos of una.

41
00:01:37,460 --> 00:01:42,500
Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan,

42
00:01:42,500 --> 00:01:44,940
wey dey kontrol dis world komot.

43
00:01:44,940 --> 00:01:46,300
But as for mi,

44
00:01:46,300 --> 00:01:48,400
if una karry mi go up for cross,

45
00:01:48,400 --> 00:01:51,100
I go draw evribody kom meet mi.”

46
00:01:51,100 --> 00:01:52,380
(E tok like dis,

47
00:01:52,380 --> 00:01:54,420
make pipol for know di way e go take die).

48
00:01:54,420 --> 00:01:56,240
Den di pipol ask,

49
00:01:56,240 --> 00:01:58,660
“Wi know sey God law sey,

50
00:01:58,660 --> 00:02:00,320
‘Christ go live forever.’

51
00:02:00,320 --> 00:02:03,880
Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross?

52
00:02:03,880 --> 00:02:06,080
Na who bi dis Man Pikin sef?”

53
00:02:06,080 --> 00:02:08,300
Jesus ansa dem,

54
00:02:08,300 --> 00:02:11,120
“My lite nor go dey with una tey.

55
00:02:11,120 --> 00:02:12,740
Naw wen di lite dey,

56
00:02:12,740 --> 00:02:14,820
make una take am waka,

57
00:02:14,820 --> 00:02:17,820
so dat darkness nor go kover una.

58
00:02:17,820 --> 00:02:20,180
Bikos di pesin wey dey waka for darkness,

59
00:02:20,180 --> 00:02:21,700
nor dey si where e dey go.

60
00:02:21,700 --> 00:02:23,720
As una get di lite naw,

61
00:02:23,720 --> 00:02:25,080
make una bilive am,

62
00:02:25,080 --> 00:02:28,060
so dat una go bi lite shidren.”

63
00:02:28,060 --> 00:02:30,340
Wen Jesus don tok dis tin finish,

64
00:02:30,340 --> 00:02:32,860
e kon komot der go hide.

