﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,160
Aldo Jesus don do many mirakle for dia front,

2
00:00:09,160 --> 00:00:10,700
dem nor still bilive am.

3
00:00:10,700 --> 00:00:13,720
Dis make wetin Profet Isaya tok happen,

4
00:00:13,720 --> 00:00:14,680
wen e sey,

5
00:00:14,680 --> 00:00:16,560
“Oga God,

6
00:00:16,560 --> 00:00:19,400
wish pipol don bilive wetin wi tok

7
00:00:19,400 --> 00:00:21,800
and who God don show en pawa?”

8
00:00:21,800 --> 00:00:23,820
As di pipol nor fit bilive,

9
00:00:23,820 --> 00:00:26,380
naim make Profet Isaya tok anoda word sey,

10
00:00:26,380 --> 00:00:27,160
“God don blind dia eye

11
00:00:27,160 --> 00:00:31,320
and make dia heart strong like stone,

12
00:00:31,320 --> 00:00:36,960
so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart,

13
00:00:36,960 --> 00:00:39,360
so dem nor go fit kom meet mi,

14
00:00:39,360 --> 00:00:41,180
make I for heal dem.”

15
00:00:41,180 --> 00:00:43,440
Profet Isaya tok dis tins,

16
00:00:43,440 --> 00:00:47,380
bikos e si how God honor and tok about Christ.

17
00:00:47,380 --> 00:00:51,800
Many pipol and many Jew oga kon bilive Jesus,

18
00:00:51,800 --> 00:00:54,180
but bikos of di Farisee pipol,

19
00:00:54,180 --> 00:00:58,300
doz wey bilive nor fit tok for publik about Jesus Christ,

20
00:00:58,300 --> 00:01:01,100
so dat dem nor go drive dem komot for di sinagog.

21
00:01:01,100 --> 00:01:06,400
Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.

22
00:01:06,400 --> 00:01:08,980
Jesus kon shaut sey,

23
00:01:08,980 --> 00:01:11,400
“Di pesin wey bilive mi,

24
00:01:11,400 --> 00:01:13,300
nor bi mi e bilive,

25
00:01:13,300 --> 00:01:15,620
but na my Papa wey send mi.

26
00:01:15,620 --> 00:01:17,820
And di pesin wey si mi,

27
00:01:17,820 --> 00:01:19,560
don si God wey send mi.

28
00:01:19,560 --> 00:01:22,620
I kom as lite for dis world,

29
00:01:22,620 --> 00:01:27,600
so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.

30
00:01:27,600 --> 00:01:31,840
“Anybody wey hear wetin I tok and nor obey am,

31
00:01:31,840 --> 00:01:33,860
nor bi mi go judge am,

32
00:01:33,860 --> 00:01:36,140
bikos I nor kom judge di world,

33
00:01:36,140 --> 00:01:38,480
but I kom save pipol for di world.

34
00:01:38,480 --> 00:01:42,760
Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok,

35
00:01:42,760 --> 00:01:46,260
God go use dis my word judge am for di last day.

36
00:01:46,260 --> 00:01:49,140
Bikos nor bi my pawa I take dey tok,

37
00:01:49,140 --> 00:01:52,660
but na my Papa wey send mi dey tell mi wetin I dey tok.

38
00:01:52,660 --> 00:01:55,880
I know sey anytin wey God kommand,

39
00:01:55,880 --> 00:01:58,260
dey give life wey nor dey end,

40
00:01:58,260 --> 00:02:02,400
so I dey tok wetin E send mi.”

