﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,560
Before dem do di Passova Feast,

2
00:00:07,560 --> 00:00:12,160
Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa.

3
00:00:12,160 --> 00:00:14,600
Bikos e love di pipol wey dey di world,

4
00:00:14,600 --> 00:00:17,640
e kon show dem how en love for dem strong rish.

5
00:00:17,640 --> 00:00:19,920
Before dem start to chop evening food,

6
00:00:19,920 --> 00:00:23,360
devil don already enter Judas Iskariot mind,

7
00:00:23,360 --> 00:00:25,360
wey bi Simon pikin sey,

8
00:00:25,360 --> 00:00:27,740
make e sell Jesus give en enemy.

9
00:00:27,740 --> 00:00:36,380
Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am,

10
00:00:36,380 --> 00:00:39,000
e kon stand up for where dem dey chop,

11
00:00:39,000 --> 00:00:42,440
remove en big koat kon tie towel for en waist.

12
00:00:42,440 --> 00:00:44,840
E pour wota for basin,

13
00:00:44,840 --> 00:00:50,720
bigin dey wosh en disciples leg and dey dry dem with di towel wey dey en waist.

14
00:00:50,720 --> 00:00:52,800
Wen e rish Simon Pita turn,

15
00:00:52,800 --> 00:00:54,280
Pita kon tell am,

16
00:00:54,280 --> 00:00:55,320
“Oga God,

17
00:00:55,320 --> 00:00:56,860
yu won wosh my leg?”

18
00:00:56,860 --> 00:00:58,120
Jesus ansa,

19
00:00:58,120 --> 00:01:01,760
“Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw,

20
00:01:01,760 --> 00:01:03,700
but yu go undastand am leta.”

21
00:01:03,700 --> 00:01:05,520
Pita tell am,

22
00:01:05,520 --> 00:01:08,960
“I nor go gri make yu wosh my leg!”

23
00:01:08,960 --> 00:01:10,160
Den Jesus ansa,

24
00:01:10,160 --> 00:01:13,040
“If I nor wosh yor leg,

25
00:01:13,040 --> 00:01:16,280
mi and yu nor go get anytin togeda again.”

26
00:01:16,280 --> 00:01:18,900
So Simon Pita tell am,

27
00:01:18,900 --> 00:01:20,040
“Oga God,

28
00:01:20,040 --> 00:01:21,860
make yu nor wosh only my leg,

29
00:01:21,860 --> 00:01:24,700
but make yu wosh my hand and head too!”

30
00:01:24,700 --> 00:01:26,840
Jesus ansa,

31
00:01:26,840 --> 00:01:28,920
“Di pesin wey don baf,

32
00:01:28,920 --> 00:01:30,920
only nid to wosh en leg,

33
00:01:30,920 --> 00:01:32,920
bikos e don dey klean.

34
00:01:32,920 --> 00:01:33,700
Una dey klean,

35
00:01:33,700 --> 00:01:35,060
but nor bi all of una.”

36
00:01:35,060 --> 00:01:38,360
(Bikos Jesus know di pesin wey go sell am,

37
00:01:38,360 --> 00:01:39,300
naim make am sey,

38
00:01:39,300 --> 00:01:43,220
“Nor bi all of una dey klean.”)

39
00:01:43,220 --> 00:01:45,800
So wen Jesus don wosh dia leg finish,

40
00:01:45,800 --> 00:01:48,160
e kon wear en big koat back.

41
00:01:48,160 --> 00:01:51,000
Den e go sidan for di tabol kon ask dem,

42
00:01:51,000 --> 00:01:53,720
“Una undastand wetin I do for una so?

43
00:01:53,720 --> 00:01:56,920
Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’,

44
00:01:56,920 --> 00:01:58,360
una korrect,

45
00:01:58,360 --> 00:01:59,920
bikos na so I bi.

46
00:01:59,920 --> 00:02:00,740
So,

47
00:02:00,740 --> 00:02:04,140
if mi wey bi una oga and tisha,

48
00:02:04,140 --> 00:02:05,600
wosh una leg,

49
00:02:05,600 --> 00:02:08,280
e good make una wosh each oda leg too.

50
00:02:08,280 --> 00:02:12,160
I don give una ezample wey una go follow.

51
00:02:12,160 --> 00:02:15,540
So make una do for each oda as I don do for una.

52
00:02:15,540 --> 00:02:17,840
Make I tell una true word,

53
00:02:17,840 --> 00:02:20,880
savant nor dey big pass en oga,

54
00:02:20,880 --> 00:02:25,800
just as di pesin wey bi messenja nor dey big pass di oga wey send am.

55
00:02:25,800 --> 00:02:29,320
Since una know wetin I dey tok,

56
00:02:29,320 --> 00:02:30,540
God go bless una,

57
00:02:30,540 --> 00:02:31,820
if una do dem.

