﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,100
“Wetin I dey tok so nor koncern all of una,

2
00:00:09,100 --> 00:00:11,660
bikos I know di pipol wey I choose.

3
00:00:11,660 --> 00:00:15,000
Dis show sey God word na true sey,

4
00:00:15,000 --> 00:00:18,300
‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’

5
00:00:18,300 --> 00:00:20,940
“I don tell una before e go happen,

6
00:00:20,940 --> 00:00:22,780
so dat wen e happen,

7
00:00:22,780 --> 00:00:25,180
una go bilive sey na mi bi Christ.

8
00:00:25,180 --> 00:00:27,620
I dey tell una true word,

9
00:00:27,620 --> 00:00:30,500
anybody wey receive di pesin wey I send,

10
00:00:30,500 --> 00:00:33,400
don receive mi and anybody wey receive mi,

11
00:00:33,400 --> 00:00:35,960
don receive God wey send mi kom.”

12
00:00:35,960 --> 00:00:38,140
Wen e don tok dis tin finish,

13
00:00:38,140 --> 00:00:40,380
en heart kon heavy well-well,

14
00:00:40,380 --> 00:00:41,180
den e sey,

15
00:00:41,180 --> 00:00:43,700
“I dey tell una true word,

16
00:00:43,700 --> 00:00:47,260
one of una go sell mi give my enemy.”

17
00:00:47,260 --> 00:00:51,820
Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey,

18
00:00:51,820 --> 00:00:54,940
“Wish pesin e dey tok about?”

19
00:00:54,940 --> 00:00:55,660
John,

20
00:00:55,660 --> 00:00:58,220
di disciple wey Jesus love well-well,

21
00:00:58,220 --> 00:01:00,780
sidan for en rite hand wen dem dey chop.

22
00:01:00,780 --> 00:01:01,380
So,

23
00:01:01,380 --> 00:01:06,580
Simon Pita kon use eye tell am sey make e ask Jesus wish pesin e dey tok about.

24
00:01:06,580 --> 00:01:10,940
Den John bend en head near Jesus chest kon ask am,

25
00:01:10,940 --> 00:01:12,020
“Oga God,

26
00:01:12,020 --> 00:01:14,240
who yu dey tok about?”

27
00:01:14,240 --> 00:01:15,780
Jesus ansa,

28
00:01:15,780 --> 00:01:21,780
“Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.”

29
00:01:21,780 --> 00:01:26,820
Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot,

30
00:01:26,820 --> 00:01:29,040
wey bi Simon pikin.

31
00:01:29,040 --> 00:01:31,180
Afta Judas take di bread,

32
00:01:31,180 --> 00:01:33,420
devil enter en mind.

33
00:01:33,420 --> 00:01:34,620
Jesus kon tell am,

34
00:01:34,620 --> 00:01:36,860
“Di tin wey yu won do,

35
00:01:36,860 --> 00:01:38,820
make yu go do am kwik-kwik.”

36
00:01:38,820 --> 00:01:43,700
(No one among dem wey sidan for di tabol undastand why Jesus tok to Judas like dat.

37
00:01:43,700 --> 00:01:45,380
Some of dem tink sey,

38
00:01:45,380 --> 00:01:47,940
since na Judas dey keep di money,

39
00:01:47,940 --> 00:01:52,820
Jesus tell am sey make e go buy wetin dem go use for di feast or make e give poor pipol money).

40
00:01:52,820 --> 00:01:55,300
Wen Judas don take di bread,

41
00:01:55,300 --> 00:01:57,020
e hurry komot for di place.

42
00:01:57,020 --> 00:01:57,980
(By dis time,

43
00:01:57,980 --> 00:01:58,840
day don dark.)

44
00:01:58,840 --> 00:02:00,280
Wen e don komot,

45
00:02:00,280 --> 00:02:01,700
Jesus kon sey,

46
00:02:01,700 --> 00:02:02,900
“Naw,

47
00:02:02,900 --> 00:02:07,880
di time don rish wen God go honor en pikin and en pikin go honor am too.

48
00:02:07,880 --> 00:02:10,080
Wen di pikin don honor God,

49
00:02:10,080 --> 00:02:11,720
God go honor am too.

50
00:02:11,720 --> 00:02:13,000
“My shidren,

51
00:02:13,000 --> 00:02:16,140
na small time remain wey I go dey with una.

52
00:02:16,140 --> 00:02:16,840
Leta,

53
00:02:16,840 --> 00:02:20,820
una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey,

54
00:02:20,820 --> 00:02:24,380
‘Where I dey go una nor go fit kom der’,

55
00:02:24,380 --> 00:02:26,340
na di same word I dey tell una naw.

56
00:02:26,340 --> 00:02:29,180
“I dey give una new kommand:

57
00:02:29,180 --> 00:02:31,220
Una must love each oda,

58
00:02:31,220 --> 00:02:32,060
as I love una,

59
00:02:32,060 --> 00:02:34,700
so dat evribody go know sey,

60
00:02:34,700 --> 00:02:38,300
una bi my disciples if una love each oda.”

61
00:02:38,300 --> 00:02:40,280
Simon Pita kon tell am,

62
00:02:40,280 --> 00:02:41,740
“Oga God,

63
00:02:41,740 --> 00:02:43,100
where yu dey go?”

64
00:02:43,100 --> 00:02:44,500
Jesus ansa,

65
00:02:44,500 --> 00:02:48,460
“Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw,

66
00:02:48,460 --> 00:02:50,900
but una go kom meet mi for der leta.”

67
00:02:50,900 --> 00:02:52,340
Pita ask am,

68
00:02:52,340 --> 00:02:53,260
“Oga God,

69
00:02:53,260 --> 00:02:55,720
why wi nor go fit follow yu naw?

70
00:02:55,720 --> 00:02:58,760
I ready to die bikos of yu!”

71
00:02:58,760 --> 00:03:00,220
Jesus ansa am,

72
00:03:00,220 --> 00:03:03,500
“Yu really ready to die for mi?

73
00:03:03,500 --> 00:03:05,380
Make I tell yu true word,

74
00:03:05,380 --> 00:03:09,220
before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite,

75
00:03:09,220 --> 00:03:11,760
yu go tok three times sey,

76
00:03:11,760 --> 00:03:14,900
yu nor know mi.”

