﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,780
“Make una nor let anytin worry una mind.

2
00:00:08,780 --> 00:00:10,560
Since una bilive God,

3
00:00:10,560 --> 00:00:12,380
make una still bilive mi.

4
00:00:12,380 --> 00:00:17,940
Many rooms dey for my Papa house and I dey go prepare place for una to stay,

5
00:00:17,940 --> 00:00:19,360
if nor bi so,

6
00:00:19,360 --> 00:00:20,380
I for tell una.

7
00:00:20,380 --> 00:00:21,980
Wen I don finish,

8
00:00:21,980 --> 00:00:23,620
I go kom take una,

9
00:00:23,620 --> 00:00:26,480
so dat una go stay with mi for where I dey.

10
00:00:26,480 --> 00:00:31,620
And una go know di place wey I dey go and how una go take rish der.”

11
00:00:31,620 --> 00:00:33,860
Tomas ask am,

12
00:00:33,860 --> 00:00:34,800
“Oga God,

13
00:00:34,800 --> 00:00:36,300
wi nor know where yu dey go,

14
00:00:36,300 --> 00:00:37,980
how wi go take know road?”

15
00:00:37,980 --> 00:00:40,260
Jesus ansa am,

16
00:00:40,260 --> 00:00:42,180
“Na mi bi di road,

17
00:00:42,180 --> 00:00:44,260
di trut and life.

18
00:00:44,260 --> 00:00:46,700
Nobody go fit go meet my Papa,

19
00:00:46,700 --> 00:00:48,380
unless e pass thru mi.

20
00:00:48,380 --> 00:00:50,680
But since una don know mi,

21
00:00:50,680 --> 00:00:52,540
una go know my Papa too.

22
00:00:52,540 --> 00:00:54,560
Naw wey una don know am,

23
00:00:54,560 --> 00:00:55,880
una don si am.”

24
00:00:55,880 --> 00:00:57,940
Filip kon sey,

25
00:00:57,940 --> 00:00:59,120
“Oga God,

26
00:00:59,120 --> 00:01:02,360
show us yor Papa and wi go dey okay.”

27
00:01:02,360 --> 00:01:04,380
Jesus ansa am,

28
00:01:04,380 --> 00:01:06,260
“So Filip,

29
00:01:06,260 --> 00:01:11,100
I don dey with una all dis time and yu still nor know mi?

30
00:01:11,100 --> 00:01:12,760
Di pesin wey don si mi,

31
00:01:12,760 --> 00:01:14,100
don si my Papa!

32
00:01:14,100 --> 00:01:15,480
Why yu kon dey sey,

33
00:01:15,480 --> 00:01:16,740
‘Show us yor Papa?’

34
00:01:16,740 --> 00:01:20,420
Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same?

35
00:01:20,420 --> 00:01:22,060
As E dey inside mi,

36
00:01:22,060 --> 00:01:24,280
na so I dey inside am.

37
00:01:24,280 --> 00:01:26,000
Di word wey I dey tell una so,

38
00:01:26,000 --> 00:01:28,120
I nor dey tok am with my own pawa,

39
00:01:28,120 --> 00:01:30,720
but na my Papa wey dey inside mi,

40
00:01:30,720 --> 00:01:33,120
dey do all dis mirakle thru mi.

41
00:01:33,120 --> 00:01:38,360
Make una bilive sey I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi,

42
00:01:38,360 --> 00:01:40,380
but if una nor fit bilive mi,

43
00:01:40,380 --> 00:01:43,880
make una bilive bikos of di mirakles wey I dey do.

44
00:01:43,880 --> 00:01:46,120
I tell una true word,

45
00:01:46,120 --> 00:01:47,680
di pesin wey bilive mi,

46
00:01:47,680 --> 00:01:53,360
go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem,

47
00:01:53,360 --> 00:01:55,100
bikos I dey go meet my Papa.

48
00:01:55,100 --> 00:01:58,120
And anytin wey una use my name ask,

49
00:01:58,120 --> 00:01:59,400
I go do am,

50
00:01:59,400 --> 00:02:02,000
so dat pipol go honor di Papa bikos of en pikin.

51
00:02:02,000 --> 00:02:03,920
If una ask anytin with my name,

52
00:02:03,920 --> 00:02:06,100
I go do am for una.

