﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,220
Wen Jesus don tok all dis tins finish,

2
00:00:08,220 --> 00:00:10,500
e look heaven kon sey,

3
00:00:10,500 --> 00:00:11,680
“My Papa,

4
00:00:11,680 --> 00:00:15,400
di time don kom wen yu go give glory to yor pikin,

5
00:00:15,400 --> 00:00:17,940
so dat yor pikin go give yu glory too.

6
00:00:17,940 --> 00:00:22,640
Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world,

7
00:00:22,640 --> 00:00:27,920
na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.

8
00:00:27,920 --> 00:00:30,280
Life wey nor dey end,

9
00:00:30,280 --> 00:00:32,220
dis na wetin e mean,

10
00:00:32,220 --> 00:00:37,680
‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ,

11
00:00:37,680 --> 00:00:38,560
wey yu send.’

12
00:00:38,560 --> 00:00:43,860
I don give yu glory for dis world and I don finish di work wey yu send mi.

13
00:00:43,860 --> 00:00:44,880
And naw,

14
00:00:44,880 --> 00:00:46,680
Papa honor mi,

15
00:00:46,680 --> 00:00:48,480
make yu draw mi near yu,

16
00:00:48,480 --> 00:00:51,420
just as wi dey before di world start.

17
00:00:51,420 --> 00:00:55,920
I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name.

18
00:00:55,920 --> 00:01:01,520
Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.

19
00:01:01,520 --> 00:01:02,200
Naw,

20
00:01:02,200 --> 00:01:05,140
dem don know sey evritin wey yu give mi kom from yu,

21
00:01:05,140 --> 00:01:08,920
bikos I don tell dem di message wey yu give mi.

22
00:01:08,920 --> 00:01:14,300
Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.

23
00:01:14,300 --> 00:01:17,440
I dey pray for di pipol wey yu give mi,

24
00:01:17,440 --> 00:01:19,480
bikos dem bi yor own,

25
00:01:19,480 --> 00:01:22,560
but I nor dey pray for di oda pipol wey dey inside di world.

26
00:01:22,560 --> 00:01:24,640
Evritin wey I get,

27
00:01:24,640 --> 00:01:27,120
na yor own and evritin wey yu get,

28
00:01:27,120 --> 00:01:29,220
na my own and dem don honor mi.

29
00:01:29,220 --> 00:01:32,400
I nor go dey di world again,

30
00:01:32,400 --> 00:01:34,720
but dem go still dey inside di world,

31
00:01:34,720 --> 00:01:36,520
since I won kom meet yu.

32
00:01:36,520 --> 00:01:37,680
Holy Papa,

33
00:01:37,680 --> 00:01:40,920
make yor name protet di pipol wey yu give mi,

34
00:01:40,920 --> 00:01:42,960
so dat dem go bi one,

35
00:01:42,960 --> 00:01:45,080
just as mi and yu na one.

36
00:01:45,080 --> 00:01:47,000
Wen I dey with dem,

37
00:01:47,000 --> 00:01:48,640
I keep dem with yor name.

38
00:01:48,640 --> 00:01:50,040
No one lost,

39
00:01:50,040 --> 00:01:53,360
escept di one wey yor word sey e go perish.

40
00:01:53,360 --> 00:01:55,400
Since I dey kom meet yu,

41
00:01:55,400 --> 00:01:58,320
I dey tok all dis tins for di world,

42
00:01:58,320 --> 00:02:00,520
so dat dia joy go full well-well.

43
00:02:00,520 --> 00:02:04,040
I don give dem yor word and bikos of dat,

44
00:02:04,040 --> 00:02:06,080
di pipol for world hate dem,

45
00:02:06,080 --> 00:02:08,200
since dem nor bilong to di world,

46
00:02:08,200 --> 00:02:10,960
as misef nor bilong to di world.

47
00:02:10,960 --> 00:02:14,440
I nor sey make yu remove dem from di world,

48
00:02:14,440 --> 00:02:17,160
but make yu protet dem from di devil.

49
00:02:17,160 --> 00:02:19,080
Dem nor bilong to di world,

50
00:02:19,080 --> 00:02:21,940
just as misef nor bilong to di world.

51
00:02:21,940 --> 00:02:24,880
Make yu protet dem with di trut,

52
00:02:24,880 --> 00:02:26,740
bikos na yor word bi di trut.

53
00:02:26,740 --> 00:02:29,920
Just as yu send mi kom inside dis world,

54
00:02:29,920 --> 00:02:32,660
na so too I send dem go inside di world.

55
00:02:32,660 --> 00:02:36,240
I don separate mysef from di world for dia sake,

56
00:02:36,240 --> 00:02:39,520
so dat dem go fit separate diasef from di world too.

57
00:02:39,520 --> 00:02:40,840
I nor dey pray for dem alone,

58
00:02:40,840 --> 00:02:48,160
but I also dey pray for oda pipol wey go bilive mi thru di word wey dem go tok about mi.

59
00:02:48,160 --> 00:02:49,420
Papa,

60
00:02:49,420 --> 00:02:50,760
I dey pray,

61
00:02:50,760 --> 00:02:54,040
so dat all of dem go get one mind,

62
00:02:54,040 --> 00:02:56,440
just as mi and yu bi one.

63
00:02:56,440 --> 00:02:59,240
I still dey pray make dem dey with us,

64
00:02:59,240 --> 00:03:01,960
so dat di world go bilive sey na yu send mi.

65
00:03:01,960 --> 00:03:05,560
I don give dem di honor wey yu give mi,

66
00:03:05,560 --> 00:03:09,160
so dat dem go bi one just as wi bi one:

67
00:03:09,160 --> 00:03:11,440
I dey with dem and yu dey with mi,

68
00:03:11,440 --> 00:03:13,720
so dat dem go really bi one,

69
00:03:13,720 --> 00:03:20,360
just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem,

70
00:03:20,360 --> 00:03:21,320
as yu love mi.

71
00:03:21,320 --> 00:03:22,720
Papa,

72
00:03:22,720 --> 00:03:27,800
I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey,

73
00:03:27,800 --> 00:03:30,960
so dat dem go si di glory wey yu give mi,

74
00:03:30,960 --> 00:03:34,280
bikos yu love mi before yu kreate di world.

75
00:03:34,280 --> 00:03:35,560
Holy Papa,

76
00:03:35,560 --> 00:03:39,440
even if di pipol for di world nor know yu,

77
00:03:39,440 --> 00:03:43,400
I know yu and dis ones know sey na yu send mi.

78
00:03:43,400 --> 00:03:49,600
I don help dem know yor name and I go dey try to make oda pipol know am too,

79
00:03:49,600 --> 00:03:51,920
so dat di love wey yu get for mi,

80
00:03:51,920 --> 00:03:53,680
go dey with dem,

81
00:03:53,680 --> 00:03:56,760
as I dey with dem.”

