﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,600
Afta e don tok finish,

2
00:00:07,600 --> 00:00:13,340
Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.

3
00:00:13,340 --> 00:00:14,160
(Judas,

4
00:00:14,160 --> 00:00:15,160
wey sell Jesus,

5
00:00:15,160 --> 00:00:16,280
know di place,

6
00:00:16,280 --> 00:00:19,920
bikos Jesus don go der with en disciples many times).

7
00:00:19,920 --> 00:00:22,960
So Judas kon escort many soja,

8
00:00:22,960 --> 00:00:27,040
some Temple polise and Farisee pipol enter di farm.

9
00:00:27,040 --> 00:00:27,960
Dem whole lamp,

10
00:00:27,960 --> 00:00:31,120
tosh and some whole swod and stik for hand.

11
00:00:31,120 --> 00:00:34,040
Bikos Jesus know evritin wey go happen to am,

12
00:00:34,040 --> 00:00:35,280
e kon ask dem,

13
00:00:35,280 --> 00:00:37,340
“Who una dey find?”

14
00:00:37,340 --> 00:00:38,680
Dem ansa am,

15
00:00:38,680 --> 00:00:42,360
“Na Jesus wey kom from Nazaret.”

16
00:00:42,360 --> 00:00:43,600
E kon tell dem,

17
00:00:43,600 --> 00:00:45,480
“Na mi bi di pesin.”

18
00:00:45,480 --> 00:00:47,000
(Judas wey sell am,

19
00:00:47,000 --> 00:00:47,920
stand der with dem).

20
00:00:47,920 --> 00:00:50,120
So wen Jesus don tell dem sey,

21
00:00:50,120 --> 00:00:51,960
“Na mi bi di pesin”,

22
00:00:51,960 --> 00:00:53,960
dem dress go back kon fall for groun.

23
00:00:53,960 --> 00:00:56,080
Den Jesus ask dem again,

24
00:00:56,080 --> 00:00:58,440
“Who una sey una dey find?”

25
00:00:58,440 --> 00:00:59,560
Dem ansa,

26
00:00:59,560 --> 00:01:03,420
“Na Jesus wey kom from Nazaret.”

27
00:01:03,420 --> 00:01:04,800
Jesus kon sey,

28
00:01:04,800 --> 00:01:07,800
“I don tell una sey na mi bi di pesin.

29
00:01:07,800 --> 00:01:09,400
Since na mi una dey find,

30
00:01:09,400 --> 00:01:11,500
make una allow dis men go.”

31
00:01:11,500 --> 00:01:15,920
(E tok dis word make e bi sey wetin dem rite for God word na true,

32
00:01:15,920 --> 00:01:18,140
“I nor lost anybody among di sheep wey yu give mi.”)

33
00:01:18,140 --> 00:01:23,920
Den Simon Pita bring en swod out kon kut di High Priest savant rite ear komot.

34
00:01:23,920 --> 00:01:25,940
(Di savant name na Malkus).

35
00:01:25,940 --> 00:01:27,560
Jesus kon tell Pita,

36
00:01:27,560 --> 00:01:30,920
“Make yu put yor swod back for where e dey before!

37
00:01:30,920 --> 00:01:34,580
Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”

38
00:01:34,580 --> 00:01:39,980
Den di sojas with dia oga and di Jew oga dem take Jesus kon tie am with rope.

39
00:01:39,980 --> 00:01:41,840
Dem take am go meet Annas,

40
00:01:41,840 --> 00:01:43,540
Kaiafas fada-in-law,

41
00:01:43,540 --> 00:01:45,380
wey bi di High Priest for dat year.

42
00:01:45,380 --> 00:01:49,080
(Dis na di Kaiafas wey advise di Jew oga dem sey,

43
00:01:49,080 --> 00:01:53,360
“E good make one man die for evribody”).

