﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:10,640
Simon Pita with anoda disciple kon follow dem as dem dey take Jesus go meet Annas.

2
00:00:10,640 --> 00:00:13,920
(Di oda disciples know di High Priest well-well,

3
00:00:13,920 --> 00:00:16,900
so e follow Jesus enter inside di High Priest kompond).

4
00:00:16,900 --> 00:00:20,600
But Simon Pita stand outside di kompond near di door.

5
00:00:20,600 --> 00:00:28,200
Den di oda disciple wey know di High Priest kom out kon tok to di savant girl wey dey guide di gate and e kon allow Pita enter inside.

6
00:00:28,200 --> 00:00:30,720
Di girl wey dey di gate kon ask Pita,

7
00:00:30,720 --> 00:00:33,960
“Yu nor bi one of dis man disciple?”

8
00:00:33,960 --> 00:00:34,920
At wons,

9
00:00:34,920 --> 00:00:36,120
Pita ansa,

10
00:00:36,120 --> 00:00:38,080
“I nor bi one of dem.”

11
00:00:38,080 --> 00:00:39,040
For dis time,

12
00:00:39,040 --> 00:00:44,120
all di savant and guards gada round shako fire wey dem make to warm demsef,

13
00:00:44,120 --> 00:00:46,080
bikos kold strong well-well.

14
00:00:46,080 --> 00:00:48,680
Pita follow dem stand der dey warm ensef too.

15
00:00:48,680 --> 00:00:51,400
As dem dey der,

16
00:00:51,400 --> 00:00:56,180
di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.

17
00:00:56,180 --> 00:00:57,800
Jesus kon ansa am,

18
00:00:57,800 --> 00:01:00,960
“Na for publik I tok wetin I tish.

19
00:01:00,960 --> 00:01:05,600
Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada,

20
00:01:05,600 --> 00:01:07,280
na der I for dey tish.

21
00:01:07,280 --> 00:01:09,220
I nor tok anytin for sekret.

22
00:01:09,220 --> 00:01:10,800
Why yu dey ask mi?

23
00:01:10,800 --> 00:01:13,240
Make yu ask di pipol wey hear mi.

24
00:01:13,240 --> 00:01:15,020
Dem know wetin I tok.”

25
00:01:15,020 --> 00:01:16,960
Afta Jesus don tok finish,

26
00:01:16,960 --> 00:01:18,400
one of di High Priest savant,

27
00:01:18,400 --> 00:01:21,200
wey stand near am slap am for face kon ask am,

28
00:01:21,200 --> 00:01:23,720
“Na di High Priest yu dey tok to like dis?”

29
00:01:23,720 --> 00:01:25,360
Den Jesus sey,

30
00:01:25,360 --> 00:01:28,240
“If wetin I tok nor korrect,

31
00:01:28,240 --> 00:01:29,520
make yu tell mi,

32
00:01:29,520 --> 00:01:30,760
but if e korrect,

33
00:01:30,760 --> 00:01:32,060
why yu slap mi?”

34
00:01:32,060 --> 00:01:35,520
Den Annas kon send am as dem still tie am with rope,

35
00:01:35,520 --> 00:01:36,840
go meet Kaiafas,

36
00:01:36,840 --> 00:01:38,340
wey bi di High Priest.

37
00:01:38,340 --> 00:01:42,040
As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef,

38
00:01:42,040 --> 00:01:43,520
dem kon ask am,

39
00:01:43,520 --> 00:01:46,260
“Yu too nor bi one of en disciple?”

40
00:01:46,260 --> 00:01:48,220
Pita deny sey,

41
00:01:48,220 --> 00:01:50,000
“I nor dey among dem.”

42
00:01:50,000 --> 00:01:51,920
One High Priest savant,

43
00:01:51,920 --> 00:01:56,560
wey bi di same family with di man wey Pita take swod kut en ear kon sey,

44
00:01:56,560 --> 00:01:59,460
“I nor si yu with am for inside di farm?”

45
00:01:59,460 --> 00:02:06,200
Pita deny again for dia front and fawol kon do “Kukuruku.”

