﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,280
Den,

2
00:00:06,280 --> 00:00:10,480
dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis.

3
00:00:10,480 --> 00:00:12,080
(By dis time,

4
00:00:12,080 --> 00:00:13,240
morning don rish).

5
00:00:13,240 --> 00:00:16,280
Dem nor gri enter inside di govnor house,

6
00:00:16,280 --> 00:00:19,320
make dem nor for dirty as dia tradishon tok,

7
00:00:19,320 --> 00:00:21,600
so dat dem go fit chop di Passova food.

8
00:00:21,600 --> 00:00:25,520
So Pilate kom meet dem for outside kon ask dem,

9
00:00:25,520 --> 00:00:28,480
“Wetin una sey dis man do?”

10
00:00:28,480 --> 00:00:29,800
Dem ansa,

11
00:00:29,800 --> 00:00:31,720
“If to sey dis man nor bi criminal,

12
00:00:31,720 --> 00:00:34,520
wi nor for bring am kom meet yu.”

13
00:00:34,520 --> 00:00:36,480
Den Pilate tell dem,

14
00:00:36,480 --> 00:00:40,760
“Make una go judge am as una law tok.”

15
00:00:40,760 --> 00:00:42,520
Di Jew oga dem kon sey,

16
00:00:42,520 --> 00:00:46,120
“Awa law nor give us pawa to kill anybody.”

17
00:00:46,120 --> 00:00:50,760
(Dis tin happen to show sey wetin Jesus tok about how e go die,

18
00:00:50,760 --> 00:00:51,440
na true).

19
00:00:51,440 --> 00:00:54,000
So Pilate go inside en house for di palis,

20
00:00:54,000 --> 00:00:55,760
kon koll Jesus ask am,

21
00:00:55,760 --> 00:00:58,680
“Na yu bi di Jew pipol king?”

22
00:00:58,680 --> 00:01:00,280
Jesus ansa am,

23
00:01:00,280 --> 00:01:03,280
“Na from yor mind yu ask dis kweshon,

24
00:01:03,280 --> 00:01:05,820
abi pipol don tell yu about mi?”

25
00:01:05,820 --> 00:01:07,440
Pilate kon sey,

26
00:01:07,440 --> 00:01:09,780
“Yu know sey I nor bi Jew,

27
00:01:09,780 --> 00:01:10,580
abi?

28
00:01:10,580 --> 00:01:15,280
Na yor pipol and priest oga dem bring yu kom meet mi.

29
00:01:15,280 --> 00:01:16,820
Wetin yu do sef?”

30
00:01:16,820 --> 00:01:18,620
Jesus ansa,

31
00:01:18,620 --> 00:01:21,000
“My kingdom nor dey dis world.

32
00:01:21,000 --> 00:01:22,960
If to sey my kingdom dey dis world,

33
00:01:22,960 --> 00:01:27,280
my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem.

34
00:01:27,280 --> 00:01:29,000
But as e bi so,

35
00:01:29,000 --> 00:01:30,500
my kingdom nor dey here.”

36
00:01:30,500 --> 00:01:32,840
Den Pilate ask am,

37
00:01:32,840 --> 00:01:35,160
“So yu bi king?”

38
00:01:35,160 --> 00:01:36,640
Jesus ansa,

39
00:01:36,640 --> 00:01:40,080
“Na yu tok so and yu dey korrect sey,

40
00:01:40,080 --> 00:01:40,720
I bi king.

41
00:01:40,720 --> 00:01:46,040
Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut.

42
00:01:46,040 --> 00:01:48,160
Anybody wey wont hear di trut,

43
00:01:48,160 --> 00:01:50,100
go listin to wetin I dey tok.”

44
00:01:50,100 --> 00:01:51,920
Pilate still ask am,

45
00:01:51,920 --> 00:01:55,600
“Wetin bi di trut?”

46
00:01:55,600 --> 00:02:00,640
Den e go outside again go meet di Jew oga dem kon tell dem,

47
00:02:00,640 --> 00:02:03,740
“I nor si any bad tin wey dis man do o-o.

48
00:02:03,740 --> 00:02:08,160
But as una custom sey make I free one prisona for una for Passova,

49
00:02:08,160 --> 00:02:10,780
una wont make I free Jesus,

50
00:02:10,780 --> 00:02:12,900
wey bi di Jew king?”

51
00:02:12,900 --> 00:02:13,600
Den,

52
00:02:13,600 --> 00:02:15,320
dem kon dey shaut,

53
00:02:15,320 --> 00:02:18,280
“Wi nor wont dat man,

54
00:02:18,280 --> 00:02:25,360
na Barabas wi wont and na criminal dis Barabas bi.”

