﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,060
Den Pilate kon sey make dem flog Jesus with koboko.

2
00:00:09,060 --> 00:00:16,920
Den di sojas go kut tree branches wey get shuku-shuku make crown put for en head and dem kon wear am klot wey dear well-well.

3
00:00:16,920 --> 00:00:18,800
Dem kon dey laf am,

4
00:00:18,800 --> 00:00:20,040
dey take am make yeye,

5
00:00:20,040 --> 00:00:20,280
dey sey,

6
00:00:20,280 --> 00:00:25,760
“Make una kon si di Jew pipol king.”

7
00:00:25,760 --> 00:00:30,700
Dem slap am for face many times.

8
00:00:30,700 --> 00:00:34,200
Pilate kom out again kon tell di Jew oga dem sey,

9
00:00:34,200 --> 00:00:37,000
“I won bring am kom out for una,

10
00:00:37,000 --> 00:00:41,080
to let una know sey I nor si anytin bad wey e do.”

11
00:00:41,080 --> 00:00:42,960
So Jesus kom outside,

12
00:00:42,960 --> 00:00:47,320
with di shuku-shuku crown for en head and di fine klot wey dem gi-am wear.

13
00:00:47,320 --> 00:00:48,760
Den Pilate kon sey,

14
00:00:48,760 --> 00:00:50,960
“Na di man bi dis!”

15
00:00:50,960 --> 00:00:55,000
Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am,

16
00:00:55,000 --> 00:00:55,960
dem kon dey shaut,

17
00:00:55,960 --> 00:00:56,680
“Nail am for cross!

18
00:00:56,680 --> 00:00:58,880
Nail am for cross!”

19
00:00:58,880 --> 00:01:01,880
Den Pilate sey,

20
00:01:01,880 --> 00:01:05,040
“Make only una go nail am.

21
00:01:05,040 --> 00:01:05,840
But as for mi,

22
00:01:05,840 --> 00:01:09,320
I nor si any bad tin wey e do.”

23
00:01:09,320 --> 00:01:11,880
Di Jew oga dem ansa,

24
00:01:11,880 --> 00:01:14,200
“Wi get law and di law sey,

25
00:01:14,200 --> 00:01:15,280
e suppose to die,

26
00:01:15,280 --> 00:01:17,600
bikos e sey en na God Pikin.”

27
00:01:17,600 --> 00:01:20,040
Wen Pilate hear wetin dem tok,

28
00:01:20,040 --> 00:01:21,540
fear kon katch am well-well.

29
00:01:21,540 --> 00:01:24,320
So e enter di house back kon ask Jesus,

30
00:01:24,320 --> 00:01:27,360
“Na where yu from kom sef?”

31
00:01:27,360 --> 00:01:28,980
But Jesus nor ansa am.

32
00:01:28,980 --> 00:01:30,540
So Pilate kon sey,

33
00:01:30,540 --> 00:01:32,360
“Yu nor won tok to mi?

34
00:01:32,360 --> 00:01:36,640
Yu nor know sey I get pawa to free or kill yu?”

35
00:01:36,640 --> 00:01:38,000
Jesus ansa,

36
00:01:38,000 --> 00:01:41,280
“Yu nor get pawa at-all for my life,

37
00:01:41,280 --> 00:01:43,080
escept God gi-am to yu.

38
00:01:43,080 --> 00:01:43,320
So,

39
00:01:43,320 --> 00:01:45,260
na di pipol wey bring mi kom meet yu,

40
00:01:45,260 --> 00:01:47,940
na dia sin big pass yor own.”

41
00:01:47,940 --> 00:01:49,080
From dat time,

42
00:01:49,080 --> 00:01:51,080
Pilate kon bigin find way to free Jesus,

43
00:01:51,080 --> 00:01:54,040
but di Jew oga dem kon dey shaut,

44
00:01:54,040 --> 00:01:56,760
“If yu free dis man,

45
00:01:56,760 --> 00:01:58,480
yu nor bi Caesar friend.

46
00:01:58,480 --> 00:02:00,680
Anybody wey sey en bi king,

47
00:02:00,680 --> 00:02:02,400
na Caesar enemy e bi.”

48
00:02:02,400 --> 00:02:05,240
Wen Pilate hear wetin dem tok,

49
00:02:05,240 --> 00:02:09,160
e bring Jesus kom out kon sidan for di chair for where e dey judge kase,

50
00:02:09,160 --> 00:02:11,080
(dem dey koll di chair,

51
00:02:11,080 --> 00:02:12,640
“Di Stone Pavement”,

52
00:02:12,640 --> 00:02:16,320
but na Gabbata dem dey koll am for Aramaik language.)

53
00:02:16,320 --> 00:02:21,320
(Dat time na aftanoon for di day wen dem dey prepare for Passova Feast).

54
00:02:21,320 --> 00:02:21,760
So,

55
00:02:21,760 --> 00:02:24,120
Pilate kon tell di Jew oga dem,

56
00:02:24,120 --> 00:02:26,160
“Make una look,

57
00:02:26,160 --> 00:02:27,860
na una king bi dis!”

58
00:02:27,860 --> 00:02:29,020
Den,

59
00:02:29,020 --> 00:02:30,720
dem kon bigin dey shaut,

60
00:02:30,720 --> 00:02:33,240
“Kill-am trowey!

61
00:02:33,240 --> 00:02:35,200
Kill-am trowey!

62
00:02:35,200 --> 00:02:37,080
Make yu kill-am!”

63
00:02:37,080 --> 00:02:38,680
Pilate kon ask dem,

64
00:02:38,680 --> 00:02:45,600
“Una wont make I nail una king for cross?”

65
00:02:45,600 --> 00:02:46,480
Di High Priest dem kon sey,

66
00:02:46,480 --> 00:02:48,120
“Di only king wey wi get na Caesar.”

67
00:02:48,120 --> 00:02:51,520
So Pilate kon gi-am to dem make dem go kill-am.

68
00:02:51,520 --> 00:02:55,560
Den dem kon take Jesus komot for der.

