﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,100
Dat evening,

2
00:00:07,100 --> 00:00:09,100
for di first day for di week,

3
00:00:09,100 --> 00:00:11,700
en disciples kon gada togeda.

4
00:00:11,700 --> 00:00:14,240
Dem lock di door for di house wey dem dey,

5
00:00:14,240 --> 00:00:16,420
bikos dem dey fear di Jew oga dem.

6
00:00:16,420 --> 00:00:18,460
Jesus stand among dem kon sey,

7
00:00:18,460 --> 00:00:21,640
“Make peace dey with una.”

8
00:00:21,640 --> 00:00:23,100
Wen e don tok finish,

9
00:00:23,100 --> 00:00:27,460
e show dem en hand and di korna for en belle wey dem shuk with spear.

10
00:00:27,460 --> 00:00:29,780
Den di disciples kon happy well-well,

11
00:00:29,780 --> 00:00:31,060
wen dem si Jesus.

12
00:00:31,060 --> 00:00:32,840
Den Jesus tell dem again,

13
00:00:32,840 --> 00:00:35,580
“Make peace dey with una.

14
00:00:35,580 --> 00:00:37,360
As my Papa send mi,

15
00:00:37,360 --> 00:00:39,760
na so I send una too.”

16
00:00:39,760 --> 00:00:41,280
Wen e tok finish,

17
00:00:41,280 --> 00:00:43,360
e breath for dia body kon sey,

18
00:00:43,360 --> 00:00:46,540
“Make una receive di Holy Spirit.

19
00:00:46,540 --> 00:00:49,340
If una forgive anybody en sin,

20
00:00:49,340 --> 00:00:50,700
God go forgi-am,

21
00:00:50,700 --> 00:00:53,520
but if una nor forgive anybody en sin,

22
00:00:53,520 --> 00:00:55,620
God nor go forgi-am.”

23
00:00:55,620 --> 00:00:56,660
For dis time,

24
00:00:56,660 --> 00:00:58,760
Tomas (wey bi twins),

25
00:00:58,760 --> 00:01:00,460
one among di twelf disciples,

26
00:01:00,460 --> 00:01:02,800
nor dey der wen Jesus show ensef to dem.

27
00:01:02,800 --> 00:01:04,860
Di oda disciples kon tell am,

28
00:01:04,860 --> 00:01:07,460
“Wi don si Jesus.”

29
00:01:07,460 --> 00:01:09,520
But e ansa dem,

30
00:01:09,520 --> 00:01:20,340
“Unless I si en two hand wey dem nail kon put my finger inside di whole wey di nail make and shuk my hand inside di whole wey dey en belle,

31
00:01:20,340 --> 00:01:22,840
I nor go ever bilive una.”

32
00:01:22,840 --> 00:01:24,920
Afta eight days,

33
00:01:24,920 --> 00:01:30,380
wen all di disciples gada again inside di house and Tomas dey der with dem dis time,

34
00:01:30,380 --> 00:01:32,460
even doh sey dem lock all di doors,

35
00:01:32,460 --> 00:01:35,300
Jesus show ensef kon stand among dem sey,

36
00:01:35,300 --> 00:01:37,980
“Make peace dey with una.”

37
00:01:37,980 --> 00:01:40,160
Den e tell Tomas,

38
00:01:40,160 --> 00:01:42,180
“Put yor finger for my hand,

39
00:01:42,180 --> 00:01:43,500
make yu tosh am.

40
00:01:43,500 --> 00:01:46,940
Stresh yor hand put inside di korna for my belle.

41
00:01:46,940 --> 00:01:48,980
Make yu nor dey doubt again,

42
00:01:48,980 --> 00:01:51,280
but make yu bilive.”

43
00:01:51,280 --> 00:01:53,520
Tomas ansa am,

44
00:01:53,520 --> 00:01:55,180
“O!

45
00:01:55,180 --> 00:01:57,860
My Oga God and my God.”

46
00:01:57,860 --> 00:01:59,400
Den Jesus tell am,

47
00:01:59,400 --> 00:02:01,180
“So yu bilive naw,

48
00:02:01,180 --> 00:02:02,420
bikos yu don si mi?

49
00:02:02,420 --> 00:02:05,820
God go bless pipol wey neva take eye si mi,

50
00:02:05,820 --> 00:02:07,660
but dem bilive mi.”

51
00:02:07,660 --> 00:02:12,740
Jesus do many mirakles wen e dey with en disciples wey dem nor rite for dis book.

52
00:02:12,740 --> 00:02:14,440
But dis tins wey dem rite so,

53
00:02:14,440 --> 00:02:20,740
na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am,

54
00:02:20,740 --> 00:02:24,860
una go get life thru en name.

