﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,760
One day,

2
00:00:06,760 --> 00:00:08,200
wen Jesus dey tish,

3
00:00:08,200 --> 00:00:12,880
some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee,

4
00:00:12,880 --> 00:00:14,420
Judea and Jerusalem,

5
00:00:14,420 --> 00:00:18,180
dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.

6
00:00:18,180 --> 00:00:21,280
Some men karry one man for bed wey nor fit waka,

7
00:00:21,280 --> 00:00:22,120
kom.

8
00:00:22,120 --> 00:00:25,080
Dem kon dey try to karry am enter di house kom meet Jesus,

9
00:00:25,080 --> 00:00:26,520
but bikos pipol many,

10
00:00:26,520 --> 00:00:28,320
dem nor fit karry am pass,

11
00:00:28,320 --> 00:00:31,000
so dem kon open di zink for di housetop,

12
00:00:31,000 --> 00:00:32,960
drop di man with di bed small-small,

13
00:00:32,960 --> 00:00:35,200
till e rish Jesus front for di pipol centre.

14
00:00:35,200 --> 00:00:37,660
Wen Jesus si how dia faith big rish,

15
00:00:37,660 --> 00:00:39,060
e kon tell di man,

16
00:00:39,060 --> 00:00:40,320
“My friend,

17
00:00:40,320 --> 00:00:43,740
I forgive yu all yor sins.”

18
00:00:43,740 --> 00:00:47,920
So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey,

19
00:00:47,920 --> 00:00:51,440
“Who bi dis man wey dey shalenge God like dis?

20
00:00:51,440 --> 00:00:53,820
Who fit forgive sin escept God?”

21
00:00:53,820 --> 00:00:55,800
Jesus know wetin dem dey tink,

22
00:00:55,800 --> 00:00:56,960
so e ask dem,

23
00:00:56,960 --> 00:00:59,820
“Why una dey tink like dis sef?

24
00:00:59,820 --> 00:01:02,000
Wish one eazy to tok?

25
00:01:02,000 --> 00:01:04,000
‘I forgive yu yor sin?’

26
00:01:04,000 --> 00:01:06,560
or ‘Get up make yu waka?’

27
00:01:06,560 --> 00:01:12,720
But make una for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sin,

28
00:01:12,720 --> 00:01:14,800
e kon tell di man wey nor fit waka,

29
00:01:14,800 --> 00:01:16,920
‘I tell yu,

30
00:01:16,920 --> 00:01:17,520
get up,

31
00:01:17,520 --> 00:01:20,440
karry yor bed make yu dey go house.’ ”

32
00:01:20,440 --> 00:01:21,280
At wons,

33
00:01:21,280 --> 00:01:22,880
di man kon get up for dia present,

34
00:01:22,880 --> 00:01:27,180
karry di bed wey e liedan put before kon dey praiz God as e dey go house.

35
00:01:27,180 --> 00:01:29,600
Evribody for der sopraiz well-well.

36
00:01:29,600 --> 00:01:33,480
Fear katch dem and dem kon dey wonder dey sey,

37
00:01:33,480 --> 00:01:37,740
“Na wonderful tin awa eye si today so o-o!”

