﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,980
One man wey sabi di law well-well kon get up test Jesus,

2
00:00:09,980 --> 00:00:11,080
“Tisha,

3
00:00:11,080 --> 00:00:14,420
wetin I go do to take get life wey nor dey end?”

4
00:00:14,420 --> 00:00:16,640
Jesus kon ask am,

5
00:00:16,640 --> 00:00:20,240
“Wetin yu undastand about Moses Law?”

6
00:00:20,240 --> 00:00:22,140
Di man ansa,

7
00:00:22,140 --> 00:00:25,580
“Make yu love God yor Oga God with all yor heart,

8
00:00:25,580 --> 00:00:26,760
yor soul,

9
00:00:26,760 --> 00:00:29,180
yor pawa and mind,

10
00:00:29,180 --> 00:00:32,740
den love yor neighbour as yu love yorsef.”

11
00:00:32,740 --> 00:00:34,840
Jesus kon tell am,

12
00:00:34,840 --> 00:00:36,980
“Yor ansa korrect,

13
00:00:36,980 --> 00:00:40,920
make yu do dem and yu go get korrect life.”

14
00:00:40,920 --> 00:00:43,380
But di man won show sey en know well-well,

15
00:00:43,380 --> 00:00:45,220
so e kon ask Jesus,

16
00:00:45,220 --> 00:00:47,040
“Who bi my neighbour?”

17
00:00:47,040 --> 00:00:49,440
Jesus tell am dis story,

18
00:00:49,440 --> 00:00:56,580
“One man dey travel from Jerusalem go Jeriko and tif kon attack am for road,

19
00:00:56,580 --> 00:00:58,260
dem naked am,

20
00:00:58,260 --> 00:01:00,460
beat am till e nearly die,

21
00:01:00,460 --> 00:01:02,020
den kon waka leave am.

22
00:01:02,020 --> 00:01:03,900
Afta,

23
00:01:03,900 --> 00:01:06,300
one priest dey pass der,

24
00:01:06,300 --> 00:01:08,060
wen e si di man,

25
00:01:08,060 --> 00:01:10,760
e waka pass for di oda side for di road.

26
00:01:10,760 --> 00:01:11,860
Na so too,

27
00:01:11,860 --> 00:01:16,940
one worker for di temple still waka rish where di man dey,

28
00:01:16,940 --> 00:01:19,640
but e waka pass di oda side for di road.

29
00:01:19,640 --> 00:01:25,740
But one Samaria man wey dey travel for dat road kon rish where di man dey,

30
00:01:25,740 --> 00:01:27,540
as e si di man,

31
00:01:27,540 --> 00:01:28,340
e sorry for am.

32
00:01:28,340 --> 00:01:35,940
E waka go meet di man kon rob wine and olive oil for en sore and bandage am.

33
00:01:35,940 --> 00:01:43,020
Den e put di man on-top en horse kon karry am go one hotel and e kare for am dat nite.

34
00:01:43,020 --> 00:01:44,180
Di next day,

35
00:01:44,180 --> 00:01:50,180
di Samaria man give di hotel manaja two silva koins kon tell am,

36
00:01:50,180 --> 00:01:52,220
‘Make yu kare for dis man,

37
00:01:52,220 --> 00:01:54,140
wen I kom back,

38
00:01:54,140 --> 00:01:57,720
I go pay yu any estra money wey yu spend.’ ”

39
00:01:57,720 --> 00:02:00,180
Jesus kon ask di man wey e dey follow tok sey,

40
00:02:00,180 --> 00:02:02,580
“Among dis three men,

41
00:02:02,580 --> 00:02:07,320
wish one yu tink sey bi neighbour to di man wey tif attack?”

42
00:02:07,320 --> 00:02:10,180
Di man wey sabi di law well-well kon ansa,

43
00:02:10,180 --> 00:02:13,340
“Na di one wey kare for di man.”

44
00:02:13,340 --> 00:02:14,100
So,

45
00:02:14,100 --> 00:02:15,580
Jesus kon tell am,

46
00:02:15,580 --> 00:02:18,720
“Make yu go do di same tin too.”

