﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,120
For inside wildaness,

2
00:00:07,120 --> 00:00:09,680
John di Baptist kon bigin prish sey,

3
00:00:09,680 --> 00:00:12,480
make pipol leave di bad tins wey dem dey do,

4
00:00:12,480 --> 00:00:14,440
make e for baptize dem,

5
00:00:14,440 --> 00:00:17,280
so dat God go forgive dem dia sins.

6
00:00:17,280 --> 00:00:23,240
Pipol for Judea and all di aria wey near am and doz wey dey Jerusalem,

7
00:00:23,240 --> 00:00:30,160
dey go meet John and e kon baptize dem for Jordan River afta dem konfess dia sins.

8
00:00:30,160 --> 00:00:33,140
John wear klot wey dem take kamel hair make,

9
00:00:33,140 --> 00:00:39,560
tie leda belt for waist and e dey chop lokust and honey for inside bush.

10
00:00:39,560 --> 00:00:40,780
E kon sey,

11
00:00:40,780 --> 00:00:48,980
“Pesin wey big pass mi dey kom for my back and I nor big rish who go luz di rope wey dey en shoe.

12
00:00:48,980 --> 00:00:51,400
I dey use wota baptize una,

13
00:00:51,400 --> 00:00:55,920
but e go baptize una with di Holy Spirit.”

14
00:00:55,920 --> 00:00:56,960
Dat time,

15
00:00:56,960 --> 00:01:03,160
Jesus kom from Nazaret wey dey for Galilee and John kon baptize am for Jordan River.

16
00:01:03,160 --> 00:01:05,740
As Jesus dey kom out from di wota,

17
00:01:05,740 --> 00:01:11,180
heaven open and God Spirit kom down like dove kon land for en head.

18
00:01:11,180 --> 00:01:14,340
Den one vois tok from heaven sey,

19
00:01:14,340 --> 00:01:21,220
“Yu bi My Pikin wey I love and yu dey make belle sweet Mi well-well.”

