﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:12,000
So Jesus and en disciples cross go di oda side for di river for Gerasenes aria.

2
00:00:12,000 --> 00:00:14,680
As Jesus just dey kom down from di boat,

3
00:00:14,680 --> 00:00:18,500
one man wey get evil spirit kom out from di beri groun,

4
00:00:18,500 --> 00:00:20,040
run kom meet am.

5
00:00:20,040 --> 00:00:24,420
Na inside beri groun di man dey stay and nobody dey fit tie am,

6
00:00:24,420 --> 00:00:25,780
even with shain.

7
00:00:25,780 --> 00:00:31,960
Bikos dem don tie en hand and leg many times with shain and handcuff,

8
00:00:31,960 --> 00:00:33,280
but e dey kut dem trowey.

9
00:00:33,280 --> 00:00:35,740
Nobody strong rish to hold am.

10
00:00:35,740 --> 00:00:40,100
Evriday and nite for di beri groun near where mountin dey,

11
00:00:40,100 --> 00:00:41,680
e dey shaut,

12
00:00:41,680 --> 00:00:43,660
dey use stone dey kut en body.

13
00:00:43,660 --> 00:00:45,600
Wen e si Jesus dey kom from far,

14
00:00:45,600 --> 00:00:49,620
e run go meet am kon bow down for en front.

15
00:00:49,620 --> 00:00:51,320
Den e shaut,

16
00:00:51,320 --> 00:00:54,360
“Make yu leave mi,

17
00:00:54,360 --> 00:00:56,180
Jesus,

18
00:00:56,180 --> 00:00:59,840
yu wey bi God Almighty Pikin!

19
00:00:59,840 --> 00:01:01,760
I take God beg yu,

20
00:01:01,760 --> 00:01:03,560
nor sofa mi!”

21
00:01:03,560 --> 00:01:06,280
(Bikos Jesus don tell di demon before sey,

22
00:01:06,280 --> 00:01:09,460
“Komot from dat man body!”)

23
00:01:09,460 --> 00:01:10,800
Jesus ask am,

24
00:01:10,800 --> 00:01:13,240
“Wetin bi yor name?”

25
00:01:13,240 --> 00:01:14,140
E ansa,

26
00:01:14,140 --> 00:01:18,980
“My name na ‘Legion,’

27
00:01:18,980 --> 00:01:23,980
bikos wi plenty.”

28
00:01:23,980 --> 00:01:27,860
E kon beg Jesus make e nor drive dem komot from di aria.

29
00:01:27,860 --> 00:01:29,440
For di mountin side,

30
00:01:29,440 --> 00:01:31,880
plenty pig dey der dey chop.

31
00:01:31,880 --> 00:01:34,160
So di demon beg Jesus sey,

32
00:01:34,160 --> 00:01:36,680
“Oga God,

33
00:01:36,680 --> 00:01:40,160
make yu allow us enter di pig dem body.”

34
00:01:40,160 --> 00:01:42,200
So Jesus kon allow dem.

35
00:01:42,200 --> 00:01:46,220
So di evil spirit kom out from di man kon enter di pig dem.

36
00:01:46,220 --> 00:01:53,220
Den di pig dem run pass one low place enter di river and dem rish 2,000 wey die inside di wota.

37
00:01:53,220 --> 00:01:54,500
So,

38
00:01:54,500 --> 00:01:57,240
di men wey dey guide di pigs for der,

39
00:01:57,240 --> 00:02:03,320
run go spread di news for di town and pipol for di aria kon go look wetin happen.

40
00:02:03,320 --> 00:02:04,980
Wen dem waka kom meet Jesus,

41
00:02:04,980 --> 00:02:08,900
dem kon si di man wey demon dey inside am before sidan for der,

42
00:02:08,900 --> 00:02:12,480
e wear klot and en head korrect,

43
00:02:12,480 --> 00:02:14,460
so fear katch dem.

44
00:02:14,460 --> 00:02:20,320
Pipol wey si wetin happen to di man wey get demon before kon tell odas wey kom.

45
00:02:20,320 --> 00:02:23,480
Den dem beg Jesus make e komot for dia aria.

46
00:02:23,480 --> 00:02:25,700
As Jesus dey enter boat,

47
00:02:25,700 --> 00:02:30,540
di man wey get demon kon ask weda e fit follow am.

48
00:02:30,540 --> 00:02:33,340
But Jesus nor gri make di man follow dem.

49
00:02:33,340 --> 00:02:35,460
Instead e tell am,

50
00:02:35,460 --> 00:02:40,880
“Go yor house go meet yor pipol and make yu tell dem wetin God don do for yu,

51
00:02:40,880 --> 00:02:43,560
bikos God don sorry for yu.”

52
00:02:43,560 --> 00:02:45,340
So di man kon go,

53
00:02:45,340 --> 00:02:50,880
bigin tok for di whole village about wetin God do for am and evribody wey hear am,

54
00:02:50,880 --> 00:02:53,440
sopraiz well-well.

