﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:11,940
Den di disciples gada round Jesus kon tell am evritin wey dem don do and tish.

2
00:00:11,940 --> 00:00:13,720
Jesus tell dem,

3
00:00:13,720 --> 00:00:17,520
“Make una follow mi make wi go rest for sometaim”,

4
00:00:17,520 --> 00:00:22,120
(Bikos many pipol dey-kom-dey-go and time nor dey to chop).

5
00:00:22,120 --> 00:00:26,720
So only dem kon enter boat go one place where pipol nor dey.

6
00:00:26,720 --> 00:00:29,660
But many pipol si dem wen dem dey go,

7
00:00:29,660 --> 00:00:35,300
so di pipol kon run with leg from all di towns kon first Jesus and en disciples rish di place.

8
00:00:35,300 --> 00:00:37,200
Wen Jesus kom down from di boat,

9
00:00:37,200 --> 00:00:40,260
e si plenty pipol and e kon sorry for dem,

10
00:00:40,260 --> 00:00:44,560
bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem.

11
00:00:44,560 --> 00:00:46,740
So e kon tish dem many tins.

12
00:00:46,740 --> 00:00:48,500
Wen day don dey dark,

13
00:00:48,500 --> 00:00:50,260
en disciples kom meet am sey,

14
00:00:50,260 --> 00:00:54,540
“Dis na place wey pipol nor dey stay and day don dey dark.

15
00:00:54,540 --> 00:00:59,620
Make yu send dis pipol go buy wetin dem go chop for di town and village wey near here.”

16
00:00:59,620 --> 00:01:01,300
But Jesus ansa,

17
00:01:01,300 --> 00:01:04,240
“Make una give dem sometin chop.”

18
00:01:04,240 --> 00:01:05,540
Dem kon sey,

19
00:01:05,540 --> 00:01:09,680
“Make wi go take two hundred silva koins buy bread give dem chop?”

20
00:01:09,680 --> 00:01:11,420
Jesus ask dem,

21
00:01:11,420 --> 00:01:13,940
“How many bread una get?

22
00:01:13,940 --> 00:01:15,780
Make una go shek.”

23
00:01:15,780 --> 00:01:17,380
Wen dem don shek,

24
00:01:17,380 --> 00:01:18,820
dem kon ansa,

25
00:01:18,820 --> 00:01:21,980
“Na five bread with two fish.”

26
00:01:21,980 --> 00:01:24,900
Jesus kon tell di pipol make dem share diasef into group,

27
00:01:24,900 --> 00:01:25,960
sidan for grass.

28
00:01:25,960 --> 00:01:28,740
So dem sidan for difren-difren group,

29
00:01:28,740 --> 00:01:30,060
hundred-hundred,

30
00:01:30,060 --> 00:01:31,420
fifty-fifty.

31
00:01:31,420 --> 00:01:33,660
Jesus take di five bread and two fish,

32
00:01:33,660 --> 00:01:35,860
e look heaven kon tank God,

33
00:01:35,860 --> 00:01:37,700
den e divide di bread.

34
00:01:37,700 --> 00:01:43,860
E give en disciples make dem share am for di pipol and e kon divide di two fish among dem too.

35
00:01:43,860 --> 00:01:45,980
All of dem chop beleful

36
00:01:45,980 --> 00:01:49,060
and wen dem gada di fish and bread wey remain,

37
00:01:49,060 --> 00:01:50,760
twelf basket full.

38
00:01:50,760 --> 00:01:52,660
Di pipol wey chop di bread,

39
00:01:52,660 --> 00:01:54,300
rish 5,000 men.

