﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,860
Wen Jesus,

2
00:00:06,860 --> 00:00:07,520
Pita,

3
00:00:07,520 --> 00:00:10,340
James and John kom meet di oda disciples,

4
00:00:10,340 --> 00:00:13,820
dem si many pipol and di law tishas gada,

5
00:00:13,820 --> 00:00:15,140
dey argue with dem.

6
00:00:15,140 --> 00:00:16,980
Wen di pipol si Jesus,

7
00:00:16,980 --> 00:00:19,940
dem sopraiz kon run kwik-kwik go greet am.

8
00:00:19,940 --> 00:00:21,340
Jesus ask dem,

9
00:00:21,340 --> 00:00:24,320
“Wetin una dey argue about?”

10
00:00:24,320 --> 00:00:26,940
One pesin among di pipol kon ansa,

11
00:00:26,940 --> 00:00:28,380
“Tisha,

12
00:00:28,380 --> 00:00:32,820
I bring my pikin wey get demon wey dey make am nor fit tok,

13
00:00:32,820 --> 00:00:34,100
kom meet yu.

14
00:00:34,100 --> 00:00:36,100
Anytime di spirit seize am,

15
00:00:36,100 --> 00:00:40,100
e go trow am down and e go dey bring foam from en mout,

16
00:00:40,100 --> 00:00:43,740
dey grind en tit and en body go kon strait.

17
00:00:43,740 --> 00:00:46,660
I tell yor disciples make dem drive di demon komot,

18
00:00:46,660 --> 00:00:48,640
but dem nor fit.”

19
00:00:48,640 --> 00:00:50,700
Jesus kon ask en disciples,

20
00:00:50,700 --> 00:00:53,540
“Una wey nor bilive!

21
00:00:53,540 --> 00:00:56,380
How long I go stay with una?

22
00:00:56,380 --> 00:00:59,220
How long I go dey bear with una?

23
00:00:59,220 --> 00:01:01,720
Make una bring di boy kom meet mi.”

24
00:01:01,720 --> 00:01:02,580
So,

25
00:01:02,580 --> 00:01:04,540
dem take di boy go meet am.

26
00:01:04,540 --> 00:01:06,300
Wen di spirit si Jesus,

27
00:01:06,300 --> 00:01:10,380
e kwik-kwik trow di boy for groun kon make am dey shake.

28
00:01:10,380 --> 00:01:11,780
Di boy fall for groun,

29
00:01:11,780 --> 00:01:14,620
dey roll and foam dey komot from en mout.

30
00:01:14,620 --> 00:01:16,420
Jesus ask di boy papa,

31
00:01:16,420 --> 00:01:20,140
“Since wen dis tin don dey do am?”

32
00:01:20,140 --> 00:01:21,660
Di papa ansa,

33
00:01:21,660 --> 00:01:24,940
“Na since e bi small pikin.

34
00:01:24,940 --> 00:01:29,660
Di spirit dey always trow am inside fire or wota make e for die.

35
00:01:29,660 --> 00:01:32,060
But if yu go fit do anytin,

36
00:01:32,060 --> 00:01:34,920
make yu sorry for am and help us.”

37
00:01:34,920 --> 00:01:36,940
Den Jesus ask am,

38
00:01:36,940 --> 00:01:38,100
“Yu mean,

39
00:01:38,100 --> 00:01:39,420
‘If I fit?’

40
00:01:39,420 --> 00:01:42,760
Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”

41
00:01:42,760 --> 00:01:46,580
Kwik-kwik di boy papa kon shaut,

42
00:01:46,580 --> 00:01:48,820
“I bilive o-o!

43
00:01:48,820 --> 00:01:52,000
Help mi make I bilive more-more!”

44
00:01:52,000 --> 00:01:54,540
Wen Jesus si sey pipol dey gada,

45
00:01:54,540 --> 00:01:57,300
e kon tell di evil spirit,

46
00:01:57,300 --> 00:02:00,260
“Yu deaf and dumb spirit,

47
00:02:00,260 --> 00:02:04,760
I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”

48
00:02:04,760 --> 00:02:06,620
Di demon shaut,

49
00:02:06,620 --> 00:02:10,380
shake di boy well-well kon komot from en body.

50
00:02:10,380 --> 00:02:14,540
Di boy sleep for groun sotey many pipol kon dey sey,

51
00:02:14,540 --> 00:02:16,380
“E don die!”

52
00:02:16,380 --> 00:02:19,600
But Jesus whole di boy hand small-small,

53
00:02:19,600 --> 00:02:22,800
karry am up and di boy kon stand up.

54
00:02:22,800 --> 00:02:24,400
Wen e enter di house,

55
00:02:24,400 --> 00:02:26,340
en disciples kon ask am,

56
00:02:26,340 --> 00:02:29,080
“Why wi nor fit drive di demon komot?”

57
00:02:29,080 --> 00:02:31,320
Jesus ansa dem,

58
00:02:31,320 --> 00:02:37,780
“Na only with prayer and fasting dis kind one dey take komot.”

