﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,580
Den,

2
00:00:06,580 --> 00:00:08,940
Jesus sidan face di ofrin box,

3
00:00:08,940 --> 00:00:11,640
dey look as pipol dey put money inside.

4
00:00:11,640 --> 00:00:15,320
Many rish pipol kon dey put plenty money inside.

5
00:00:15,320 --> 00:00:18,700
One poor woman wey e husband don die kon kom,

6
00:00:18,700 --> 00:00:21,780
put two koins wey nor rish one penny for inside di box.

7
00:00:21,780 --> 00:00:24,660
Jesus kon koll en disciples sey,

8
00:00:24,660 --> 00:00:26,500
“I tell una true word,

9
00:00:26,500 --> 00:00:31,280
dis poor woman wey e husband don die put money wey pass di oda pipol own.

10
00:00:31,280 --> 00:00:36,700
Bikos di oda pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get,

11
00:00:36,700 --> 00:00:37,980
but dis woman,

12
00:00:37,980 --> 00:00:39,480
as e poor rish,

13
00:00:39,480 --> 00:00:43,820
put evritin wey e get for life.”

