﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:11,320
Jesus and en disciples kon go one place wey dem dey koll Getsemani and Jesus tell dem,

2
00:00:11,320 --> 00:00:13,560
“Make una sidan for here,

3
00:00:13,560 --> 00:00:15,760
bikos I won go pray.”

4
00:00:15,760 --> 00:00:17,120
E take Pita,

5
00:00:17,120 --> 00:00:19,080
James and John follow body.

6
00:00:19,080 --> 00:00:22,320
E mind kon dey trobol am and e nor dey happy.

7
00:00:22,320 --> 00:00:23,980
E kon tell dem,

8
00:00:23,980 --> 00:00:27,320
“My heart dey heavy well-well like sey I won die.

9
00:00:27,320 --> 00:00:27,960
So,

10
00:00:27,960 --> 00:00:31,720
make una stay here dey wosh.”

11
00:00:31,720 --> 00:00:36,300
E waka go front small kon fall face groun,

12
00:00:36,300 --> 00:00:38,320
bigin pray,

13
00:00:38,320 --> 00:00:39,000
“Papa!

14
00:00:39,000 --> 00:00:41,320
If yu wont,

15
00:00:41,320 --> 00:00:44,720
make yu let dis sofa pass mi.”

16
00:00:44,720 --> 00:00:49,320
Jesus kon pray,

17
00:00:49,320 --> 00:00:51,760
“My Papa,

18
00:00:51,760 --> 00:00:55,020
e nor get wetin yu nor fit do.

19
00:00:55,020 --> 00:00:59,320
Make yu take dis sofa cup from mi.

20
00:00:59,320 --> 00:01:02,760
But nor bi as I wont am,

21
00:01:02,760 --> 00:01:05,760
but na as yu wont.”

22
00:01:05,760 --> 00:01:07,400
Wen Jesus kom back,

23
00:01:07,400 --> 00:01:09,340
e meet en disciples dey sleep,

24
00:01:09,340 --> 00:01:10,680
so e tell Pita,

25
00:01:10,680 --> 00:01:12,400
“Simon,

26
00:01:12,400 --> 00:01:13,880
yu dey sleep?

27
00:01:13,880 --> 00:01:16,680
Yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?

28
00:01:16,680 --> 00:01:18,580
Make yu nor sleep,

29
00:01:18,580 --> 00:01:22,280
but dey pray make yu nor for fall enter temptashon.

30
00:01:22,280 --> 00:01:24,260
Man spirit won pray,

31
00:01:24,260 --> 00:01:26,720
but en body dey weak.”

32
00:01:26,720 --> 00:01:28,280
E komot again,

33
00:01:28,280 --> 00:01:30,200
go pray as e pray before.

34
00:01:30,200 --> 00:01:31,960
Wen e kom back again,

35
00:01:31,960 --> 00:01:34,120
e si sey dem still dey sleep;

36
00:01:34,120 --> 00:01:35,260
dem nor dey pray,

37
00:01:35,260 --> 00:01:37,600
so dem nor know wetin to tell am.

38
00:01:37,600 --> 00:01:40,220
E kom di third time kon ask dem,

39
00:01:40,220 --> 00:01:42,320
“Una still dey sleep?

40
00:01:42,320 --> 00:01:43,880
Di sleep don do,

41
00:01:43,880 --> 00:01:46,020
bikos time don rish!

42
00:01:46,020 --> 00:01:47,140
Make una si,

43
00:01:47,140 --> 00:01:49,540
dem don sell Man Pikin give sinnas.

44
00:01:49,540 --> 00:01:51,960
Make una get up make wi dey go.

45
00:01:51,960 --> 00:01:52,940
Si,

46
00:01:52,940 --> 00:01:54,560
di pesin wey won sell mi,

47
00:01:54,560 --> 00:01:55,460
dey kom!”

48
00:01:55,460 --> 00:01:57,080
As Jesus still dey tok,

49
00:01:57,080 --> 00:01:58,000
Judas,

50
00:01:58,000 --> 00:02:02,720
one of di twelf disciples kon kom with plenty pipol wey di priest oga dem,

51
00:02:02,720 --> 00:02:08,040
di law tishas and di eldas send and all of dem karry swod and big-big stik.

52
00:02:08,040 --> 00:02:09,120
(By dis time,

53
00:02:09,120 --> 00:02:12,400
di man wey won sell Jesus don give dem sign sey,

54
00:02:12,400 --> 00:02:14,880
“Di pesin wey I go kiss,

55
00:02:14,880 --> 00:02:15,680
naim bi di man.

56
00:02:15,680 --> 00:02:19,080
Make una arrest and hold am well-well.”)

57
00:02:19,080 --> 00:02:20,360
Wen Judas kom,

58
00:02:20,360 --> 00:02:22,280
e go meet Jesus kon sey,

59
00:02:22,280 --> 00:02:24,520
“Tisha!”

60
00:02:24,520 --> 00:02:26,280
Den e kiss am.

61
00:02:26,280 --> 00:02:26,800
So,

62
00:02:26,800 --> 00:02:29,480
di pipol kon seize and arrest Jesus.

63
00:02:29,480 --> 00:02:35,100
One pesin wey stand for der kon take en swod kut di High Priest savant ear komot.

64
00:02:35,100 --> 00:02:36,560
Jesus kon tell dem,

65
00:02:36,560 --> 00:02:41,340
“Na mi una karry swod and big-big stik kom arrest like sey I bi tif?

66
00:02:41,340 --> 00:02:44,400
I dey with una evriday for di temple dey tish,

67
00:02:44,400 --> 00:02:46,640
but una nor arrest mi den.”

68
00:02:46,640 --> 00:02:50,320
Dis tin happen so dat wetin dem rite for God word,

69
00:02:50,320 --> 00:02:51,360
go bi true.

70
00:02:51,360 --> 00:02:54,660
Den all en disciples kon run leave am.

71
00:02:54,660 --> 00:02:57,200
One yong man wey tie small klot for waist,

72
00:02:57,200 --> 00:02:58,620
dey follow Jesus.

73
00:02:58,620 --> 00:03:00,680
So dem won kon arrest di man join,

74
00:03:00,680 --> 00:03:05,580
but e kon run komot with nakednes and leave en klot for der.

75
00:03:05,580 --> 00:03:07,240
Den,

76
00:03:07,240 --> 00:03:09,640
dem take Jesus go meet di High Priest,

77
00:03:09,640 --> 00:03:11,640
so all di priest oga dem,

78
00:03:11,640 --> 00:03:14,500
di eldas and di law tishas kon gada.

79
00:03:14,500 --> 00:03:18,740
Pita follow Jesus from far till e rish di High Priest varanda.

80
00:03:18,740 --> 00:03:22,200
E sidan with di guards dey warm en body near fire.

81
00:03:22,200 --> 00:03:27,240
Di priest oga dem and di Sanhedrin dey find wetin dem go take akuiz Jesus,

82
00:03:27,240 --> 00:03:29,160
so dat dem go fit kill-am,

83
00:03:29,160 --> 00:03:31,000
but dem nor si anytin.

84
00:03:31,000 --> 00:03:35,320
Many pipol lie for Jesus head and dem dey tok difren-difren tins,

85
00:03:35,320 --> 00:03:37,740
but dia story nor gri with each oda.

86
00:03:37,740 --> 00:03:41,700
Some pipol stand up kon lie against am sey,

87
00:03:41,700 --> 00:03:43,880
“Wi hear wen e sey,

88
00:03:43,880 --> 00:03:47,440
‘I go distroy dis Temple wey dem build with hand and afta three days,

89
00:03:47,440 --> 00:03:50,580
I go build anoda one wey dem nor use hand build.’ ”

90
00:03:50,580 --> 00:03:52,400
All dia story nor dey good,

91
00:03:52,400 --> 00:03:54,600
bikos dem nor gri with each oda.

92
00:03:54,600 --> 00:03:58,040
Den di High Priest stand for dia front kon ask Jesus,

93
00:03:58,040 --> 00:03:59,440
“Yu nor get ansa?

94
00:03:59,440 --> 00:04:02,320
Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?”

95
00:04:02,320 --> 00:04:05,360
But Jesus kwayet and e nor ansa dem.

96
00:04:05,360 --> 00:04:07,560
Den di High Priest kon ask am again,

97
00:04:07,560 --> 00:04:10,400
“Na yu bi Christ wey bi God Pikin?”

98
00:04:10,400 --> 00:04:11,640
Jesus ansa,

99
00:04:11,640 --> 00:04:16,560
“Na mi and yu go si Man Pikin sidan for God rite hand,

100
00:04:16,560 --> 00:04:19,500
wen e dey kom inside di kloud from heaven.”

101
00:04:19,500 --> 00:04:22,680
Den di High Priest tear en own klot kon sey,

102
00:04:22,680 --> 00:04:25,620
“Why wi dey find more pipol to tok for dis matter?

103
00:04:25,620 --> 00:04:28,240
Una don hear di word wey e tok against God!

104
00:04:28,240 --> 00:04:30,800
Wetin una tink sey make wi do am?”

105
00:04:30,800 --> 00:04:32,640
Dem kon ansa,

106
00:04:32,640 --> 00:04:35,000
“E suppose to die.”

107
00:04:35,000 --> 00:04:38,000
Den some bigin spit for Jesus body,

108
00:04:38,000 --> 00:04:44,840
dem tie en eye kon dey nak am dey sey,

109
00:04:44,840 --> 00:04:48,400
“Profesai naw!”

110
00:04:48,400 --> 00:04:51,980
Di pipol wey dey guide di place still join beat am.

111
00:04:51,980 --> 00:04:53,900
For dis time,

112
00:04:53,900 --> 00:04:55,560
Pita dey for di varanda,

113
00:04:55,560 --> 00:04:58,060
den di High Priest girl savant kom der.

114
00:04:58,060 --> 00:05:00,400
Wen e si Pita sidan dey warm ensef,

115
00:05:00,400 --> 00:05:02,960
e look am well-well kon sey,

116
00:05:02,960 --> 00:05:06,080
“Yorsef dey follow dat man wey kom from Nazaret,

117
00:05:06,080 --> 00:05:08,060
wey dem dey koll Jesus Christ.”

118
00:05:08,060 --> 00:05:10,600
But Pita deny kon sey,

119
00:05:10,600 --> 00:05:13,380
“I nor even know wetin yu dey tok about!”

120
00:05:13,380 --> 00:05:16,200
Den e waka go di gate and fawol kon do,

121
00:05:16,200 --> 00:05:18,200
“Kukuruku!”

122
00:05:18,200 --> 00:05:20,160
Wen di savant girl si am,

123
00:05:20,160 --> 00:05:22,600
e kon dey tell di pipol wey stand der sey,

124
00:05:22,600 --> 00:05:25,100
“Dis man dey among dem.”

125
00:05:25,100 --> 00:05:27,180
But e deny again.

126
00:05:27,180 --> 00:05:28,440
Small time,

127
00:05:28,440 --> 00:05:30,920
di pipol wey stand for korna kon tell Pita,

128
00:05:30,920 --> 00:05:32,680
“True-true,

129
00:05:32,680 --> 00:05:34,440
yu dey among dem,

130
00:05:34,440 --> 00:05:36,640
bikos na Galilee yu from kom.”

131
00:05:36,640 --> 00:05:39,500
Pita kon bigin curse and swear sey.

132
00:05:39,500 --> 00:05:43,040
“I nor know dis man wey una dey tok about so o-o!”

133
00:05:43,040 --> 00:05:44,260
At wons,

134
00:05:44,260 --> 00:05:45,240
fawol kon do,

135
00:05:45,240 --> 00:05:46,840
“Kukuruku!”

136
00:05:46,840 --> 00:05:48,180
di sekond time.

137
00:05:48,180 --> 00:05:51,100
So Pita kon remember wetin Jesus tell am:

138
00:05:51,100 --> 00:05:53,520
“Before fawol go do ‘Kukuruku!’

139
00:05:53,520 --> 00:05:54,360
two times,

140
00:05:54,360 --> 00:05:56,920
yu go deny mi three times.”

141
00:05:56,920 --> 00:06:01,720
Den Pita kon bigin kry well-well.

