﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,960
For early morning afta dem don plan wetin dem go do Jesus,

2
00:00:09,960 --> 00:00:14,040
di priest oga dem with di law tishas and di Sanhedrin,

3
00:00:14,040 --> 00:00:16,860
tie am kon take am go meet Pilate.

4
00:00:16,860 --> 00:00:18,800
So Pilate ask Jesus,

5
00:00:18,800 --> 00:00:22,080
“Na yu bi di Jew pipol king?”

6
00:00:22,080 --> 00:00:23,200
Jesus ansa,

7
00:00:23,200 --> 00:00:25,660
“Na as yu tok.”

8
00:00:25,660 --> 00:00:28,440
Den di priest oga dem still dey akuiz am,

9
00:00:28,440 --> 00:00:30,720
so Pilate ask Jesus again,

10
00:00:30,720 --> 00:00:33,320
“Yu nor get anytin to tok?

11
00:00:33,320 --> 00:00:36,300
Yu dey hear all dis tins wey dem sey yu do?”

12
00:00:36,300 --> 00:00:42,340
But Jesus nor tok anytin and dis tin kon sopraiz Pilate well-well.

13
00:00:42,340 --> 00:00:45,240
Anytime wen dem dey do di Passova Feast,

14
00:00:45,240 --> 00:00:49,340
Pilate always dey free one prisona wey di pipol ask for.

15
00:00:49,340 --> 00:00:50,640
Barabas,

16
00:00:50,640 --> 00:00:53,360
one man wey kill pesin for di time wey dem dey rayot,

17
00:00:53,360 --> 00:00:56,900
dey prison with pipol wey nor dey obey govment law.

18
00:00:56,900 --> 00:01:00,640
Den di pipol kom meet Pilate kon ask am sey,

19
00:01:00,640 --> 00:01:02,680
make e free one prisona for dem,

20
00:01:02,680 --> 00:01:04,520
as e dey do before.

21
00:01:04,520 --> 00:01:06,160
So Pilate ask dem,

22
00:01:06,160 --> 00:01:10,400
“Una wont make I free Jew pipol king for una?”

23
00:01:10,400 --> 00:01:14,080
(Pilate know sey di priest oga dem bring Jesus to am,

24
00:01:14,080 --> 00:01:15,420
bikos dem dey jealous).

25
00:01:15,420 --> 00:01:20,260
But di priest oga dem tell di pipol make dem ask Pilate make e free Barabas.

26
00:01:20,260 --> 00:01:21,320
So Pilate ask dem again,

27
00:01:21,320 --> 00:01:28,060
“Den wetin una wont make I do to dis man wey una koll Jew pipol king?”

28
00:01:28,060 --> 00:01:30,280
Dem kon shaut,

29
00:01:30,280 --> 00:01:33,100
“Kill-am trowey!”

30
00:01:33,100 --> 00:01:34,880
Pilate ask dem,

31
00:01:34,880 --> 00:01:35,320
“Why?

32
00:01:35,320 --> 00:01:38,400
Wish bad tin e do?”

33
00:01:38,400 --> 00:01:41,640
But dem kon dey shaut more-more,

34
00:01:41,640 --> 00:01:45,480
“Kill-am trowey!”

35
00:01:45,480 --> 00:01:48,400
Bikos Pilate one do wetin di pipol wont,

36
00:01:48,400 --> 00:01:49,520
e kon free Barabas for dem,

37
00:01:49,520 --> 00:01:53,640
den afta e tell en sojas make dem flog Jesus,

38
00:01:53,640 --> 00:01:57,100
e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.

39
00:01:57,100 --> 00:02:02,920
So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada.

40
00:02:02,920 --> 00:02:07,620
Dem wear am purpol klot kon take shuku-shuku make crown wear for en head.

41
00:02:07,620 --> 00:02:09,840
Dem kon dey salot am,

42
00:02:09,840 --> 00:02:11,440
“Wi hail yu o-o,

43
00:02:11,440 --> 00:02:15,080
Jew pipol king!”

44
00:02:15,080 --> 00:02:19,960
Dem take stik nak am for head kon spit for en body.

45
00:02:19,960 --> 00:02:22,860
Dem knee down for en front dey bow for am.

46
00:02:22,860 --> 00:02:25,000
Wen dem don laf am finish,

47
00:02:25,000 --> 00:02:29,320
dem pul di purpol klot komot from en body kon wear am en own klot.

48
00:02:29,320 --> 00:02:29,760
Den,

49
00:02:29,760 --> 00:02:31,340
dem kon go kill-am.

50
00:02:31,340 --> 00:02:33,400
Di sojas kon force Simon,

51
00:02:33,400 --> 00:02:35,240
one man from Sirene,

52
00:02:35,240 --> 00:02:36,960
wey just dey enter di town,

53
00:02:36,960 --> 00:02:39,000
make e karry Jesus cross.

54
00:02:39,000 --> 00:02:42,160
(Di man na Alexanda and Rufus papa.)

55
00:02:42,160 --> 00:02:47,760
Dem take Jesus go di place wey dem dey koll Golgota (wey mean,

56
00:02:47,760 --> 00:02:49,240
“Skull Place”).

57
00:02:49,240 --> 00:02:51,960
Dem gi-am wine wey dem mix with myrrh,

58
00:02:51,960 --> 00:02:53,680
but Jesus nor gri drink am.

59
00:02:53,680 --> 00:02:56,720
Dem nail am for cross kon divide en klot,

60
00:02:56,720 --> 00:03:00,980
dey trow dice make dem for know wetin go rish each pesin.

61
00:03:00,980 --> 00:03:04,920
Na nine oklok for morning dem take nail Jesus for cross.

62
00:03:04,920 --> 00:03:07,000
Dem kon rite sey,

63
00:03:07,000 --> 00:03:09,640
“Dis na Jew pipol king.”

64
00:03:09,640 --> 00:03:12,440
Dem nail two tif with am for cross,

65
00:03:12,440 --> 00:03:15,360
one for en left and di oda for en rite side.

66
00:03:15,360 --> 00:03:18,440
Wetin dem rite for God word kon happen sey,

67
00:03:18,440 --> 00:03:21,940
“Dem kount Jesus join bad pipol.”

68
00:03:21,940 --> 00:03:29,400
Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey,

69
00:03:29,400 --> 00:03:30,400
“Eehen!

70
00:03:30,400 --> 00:03:32,600
Yu wey sey,

71
00:03:32,600 --> 00:03:39,160
yu go fit distroy di temple kon build am again for three days.

72
00:03:39,160 --> 00:03:39,680
Oya!

73
00:03:39,680 --> 00:03:42,940
Save yorsef make yu kom down from di cross!”

74
00:03:42,940 --> 00:03:50,120
Even di priest oga dem and di law tishas dey laf Jesus for where dem sidan,

75
00:03:50,120 --> 00:03:50,920
dey sey,

76
00:03:50,920 --> 00:03:52,360
“E save oda pipol,

77
00:03:52,360 --> 00:03:55,740
but e nor fit save ensef!

78
00:03:55,740 --> 00:03:56,460
Christ,

79
00:03:56,460 --> 00:03:58,920
wey sey e bi Israel king,

80
00:03:58,920 --> 00:04:01,540
make e kom down from di cross naw make wi si am,

81
00:04:01,540 --> 00:04:03,680
so dat wi go bilive!”

82
00:04:03,680 --> 00:04:08,120
Doz wey dem nail for cross with am kon dey curse am too.

83
00:04:08,120 --> 00:04:11,000
Wen twelf oklok for aftanoon rish,

84
00:04:11,000 --> 00:04:15,140
darkness kon kover di kountry until three oklok for aftanoon.

85
00:04:15,140 --> 00:04:16,760
Around three oklok,

86
00:04:16,760 --> 00:04:19,280
Jesus kon shaut sey,

87
00:04:19,280 --> 00:04:24,160
“Eloi!

88
00:04:24,160 --> 00:04:29,760
Eloi!

89
00:04:29,760 --> 00:04:37,360
Lama Sabaktani?”

90
00:04:37,360 --> 00:04:39,800
Wey mean,

91
00:04:39,800 --> 00:04:44,120
“My God!

92
00:04:44,120 --> 00:04:48,960
My God!

93
00:04:48,960 --> 00:05:04,560
Wetin make yu abandon mi?”

94
00:05:04,560 --> 00:05:08,400
Wen some pipol wey stand near der hear wetin e tok,

95
00:05:08,400 --> 00:05:09,480
dem kon sey,

96
00:05:09,480 --> 00:05:10,760
“Listin.

97
00:05:10,760 --> 00:05:12,680
E dey koll Elijah!”

98
00:05:12,680 --> 00:05:18,000
Den one pesin run kom with foam kon soak am inside betta wine,

99
00:05:18,000 --> 00:05:20,920
den e put am for stik give Jesus make e drink,

100
00:05:20,920 --> 00:05:22,160
den e kon sey,

101
00:05:22,160 --> 00:05:25,640
“Make una leave am!

102
00:05:25,640 --> 00:05:29,820
Make wi si weda Elijah go kom save am.”

103
00:05:29,820 --> 00:05:31,720
But Jesus shaut again,

104
00:05:31,720 --> 00:05:33,960
den e kon die.

105
00:05:33,960 --> 00:05:39,080
So di curtain for di temple tear into two from top go rish bottom.

106
00:05:39,080 --> 00:05:42,280
Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die,

107
00:05:42,280 --> 00:05:44,500
e kon sey,

108
00:05:44,500 --> 00:05:48,640
“True-true dis man na God Pikin!”

109
00:05:48,640 --> 00:05:51,800
Some wimen dey der dey look from far.

110
00:05:51,800 --> 00:05:53,360
Dem bi Mary Magdalin,

111
00:05:53,360 --> 00:05:55,200
Mary wey bi Josef,

112
00:05:55,200 --> 00:05:58,100
James and Salome mama.

113
00:05:58,100 --> 00:06:00,720
For di time wen Jesus dey Galilee,

114
00:06:00,720 --> 00:06:03,520
dis wimen dey follow and help am.

115
00:06:03,520 --> 00:06:06,320
Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem,

116
00:06:06,320 --> 00:06:07,120
dey der too.

117
00:06:07,120 --> 00:06:11,580
Wen evening don rish for di day before di Sabat Day,

118
00:06:11,580 --> 00:06:14,280
Josef wey kom from Arimatea,

119
00:06:14,280 --> 00:06:16,160
wey bi Jew kansol memba,

120
00:06:16,160 --> 00:06:20,600
wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well,

121
00:06:20,600 --> 00:06:23,160
go meet Pilate kon ask for Jesus body.

122
00:06:23,160 --> 00:06:26,100
Pilate sopraiz sey Jesus don die.

123
00:06:26,100 --> 00:06:29,860
So e koll di soja kon ask am weda e don tey wen Jesus die.

124
00:06:29,860 --> 00:06:33,280
Wen Pilate hear wetin di soja tok,

125
00:06:33,280 --> 00:06:35,840
e kon sey make Josef go karry di body.

126
00:06:35,840 --> 00:06:38,100
Josef buy linen klot,

127
00:06:38,100 --> 00:06:42,780
bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am,

128
00:06:42,780 --> 00:06:45,520
den e put am for grave wey dem dig inside rock.

129
00:06:45,520 --> 00:06:48,640
Den e roll big stone kover di grave mout.

130
00:06:48,640 --> 00:06:56,600
Mary Magdalin and Mary wey bi Josef mama dey look and dem si where dem beri Jesus put.

131
00:06:56,600 --> 00:06:58,300
Wen Sabat Day don pass,

132
00:06:58,300 --> 00:06:59,780
Mary Magdalin,

133
00:06:59,780 --> 00:07:05,200
Mary wey bi James and Salome mama kon buy some tins wey dey send well-well,

134
00:07:05,200 --> 00:07:07,640
make dem go rub am for Jesus body,

135
00:07:07,640 --> 00:07:09,300
make e nor for smell.

136
00:07:09,300 --> 00:07:11,600
For early morning on Sunday,

137
00:07:11,600 --> 00:07:13,240
as sun just dey kom out,

138
00:07:13,240 --> 00:07:16,420
dem kon go di place wey dem beri Jesus put.

139
00:07:16,420 --> 00:07:19,520
Dem kon dey ask each oda as dem dey go sey,

140
00:07:19,520 --> 00:07:27,260
“Who go help us roll di stone komot from di grave mout?”

141
00:07:27,260 --> 00:07:29,080
But wen dem look,

142
00:07:29,080 --> 00:07:29,880
dem si sey,

143
00:07:29,880 --> 00:07:32,400
dem don already roll di stone komot.

144
00:07:32,400 --> 00:07:33,720
As dem enter,

145
00:07:33,720 --> 00:07:40,240
dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.

146
00:07:40,240 --> 00:07:42,100
But e tell dem,

147
00:07:42,100 --> 00:07:43,840
“Make una nor fear.

148
00:07:43,840 --> 00:07:46,880
Una dey find Jesus wey kom from Nazaret,

149
00:07:46,880 --> 00:07:48,100
wey dem kill.

150
00:07:48,100 --> 00:07:50,460
God don raiz am from deat!

151
00:07:50,460 --> 00:07:51,860
E nor dey here again.

152
00:07:51,860 --> 00:07:55,060
Make una look di place wey dem put am before.

153
00:07:55,060 --> 00:07:58,660
Make una go tell en disciples and Pita sey,

154
00:07:58,660 --> 00:08:00,880
Jesus don go Galilee go wait for dem.

155
00:08:00,880 --> 00:08:02,800
Una go si am for der,

156
00:08:02,800 --> 00:08:04,540
as e tell una before.”

