﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,840
Afta dem born Jesus for Betlehem wey dey Judea,

2
00:00:08,840 --> 00:00:11,200
for di time wey Herod bi king,

3
00:00:11,200 --> 00:00:14,440
some wise men from east kon go Jerusalem

4
00:00:14,440 --> 00:00:15,800
dey ask,

5
00:00:15,800 --> 00:00:18,860
“Where di Jew king wey dem just born?

6
00:00:18,860 --> 00:00:21,380
Wi si di star wey tok about am,

7
00:00:21,380 --> 00:00:23,320
so wi kom woship am.”

8
00:00:23,320 --> 00:00:25,140
Wetin dem tok so,

9
00:00:25,140 --> 00:00:27,800
vex King Herod and Jerusalem pipol.

10
00:00:27,800 --> 00:00:28,320
So,

11
00:00:28,320 --> 00:00:34,940
di king gada all di priest oga dem and di pipol wey sabi di law kon ask dem,

12
00:00:34,940 --> 00:00:37,980
“Where una tink sey dem go for born Christ?”

13
00:00:37,980 --> 00:00:39,920
Dem kon ansa,

14
00:00:39,920 --> 00:00:41,640
“Na for Betlehem,

15
00:00:41,640 --> 00:00:42,820
wey dey Judea,

16
00:00:42,820 --> 00:00:45,280
just as Profet Isaya rite sey:

17
00:00:45,280 --> 00:00:46,740
“ ‘Betlehem pipol,

18
00:00:46,740 --> 00:00:50,280
una wey small pass for all di pipol wey dey rule Judah,

19
00:00:50,280 --> 00:00:52,240
na from among una di pesin

20
00:00:52,240 --> 00:00:54,220
wey go lead all my pipol for Israel,

21
00:00:54,220 --> 00:00:55,680
go from kom.’ ”

22
00:00:55,680 --> 00:00:58,780
Den Herod koll di wise men go korna,

23
00:00:58,780 --> 00:01:01,800
make dem for tell am wen dem si di star.

24
00:01:01,800 --> 00:01:03,580
E kon sey,

25
00:01:03,580 --> 00:01:05,980
“Make una go look for di pikin well-well.

26
00:01:05,980 --> 00:01:07,220
Wen una don si am,

27
00:01:07,220 --> 00:01:08,600
make una kom tell mi,

28
00:01:08,600 --> 00:01:09,640
so dat mi too,

29
00:01:09,640 --> 00:01:10,960
go-go woship am.”

30
00:01:10,960 --> 00:01:13,080
Wen di king tok finish,

31
00:01:13,080 --> 00:01:16,720
di wise men kon dey go and di star wey dem si before,

32
00:01:16,720 --> 00:01:21,760
kon dey lead dem until e stop on-top di house where di pikin dey.

33
00:01:21,760 --> 00:01:23,680
Wen dem si di star,

34
00:01:23,680 --> 00:01:25,060
dem kon dey happy.

35
00:01:25,060 --> 00:01:27,040
Dem enter di house,

36
00:01:27,040 --> 00:01:31,600
si di pikin with en mama kon knee down woship am.

37
00:01:31,600 --> 00:01:35,680
Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi,

38
00:01:35,680 --> 00:01:36,680
gold,

39
00:01:36,680 --> 00:01:39,460
frankincense and myrrh.

40
00:01:39,460 --> 00:01:44,280
Bikos God warn dem for dream make dem nor go back go meet Herod,

41
00:01:44,280 --> 00:01:46,880
dem kon pass anoda road go dia house.

42
00:01:46,880 --> 00:01:48,640
Wen di wise men don go,

43
00:01:48,640 --> 00:01:51,260
God angel kon tell Josef for dream,

44
00:01:51,260 --> 00:01:52,880
“Get up,

45
00:01:52,880 --> 00:01:55,280
karry di pikin and en mama run go Egypt,

46
00:01:55,280 --> 00:01:59,280
make una stay der until I go tell yu wetin una go do,

47
00:01:59,280 --> 00:02:02,280
bikos Herod won kill di pikin.”

48
00:02:02,280 --> 00:02:04,100
Dat same nite,

49
00:02:04,100 --> 00:02:05,520
Josef wake-up,

50
00:02:05,520 --> 00:02:08,800
karry di pikin and en mama kon run go Egypt.

51
00:02:08,800 --> 00:02:11,140
Dem stay der till Herod die.

52
00:02:11,140 --> 00:02:14,800
Dis tin make wetin God profet tok happen sey,

53
00:02:14,800 --> 00:02:18,120
“I koll my pikin komot from Egypt.”

54
00:02:18,120 --> 00:02:21,680
Wen Herod si sey di wise men deceive am,

55
00:02:21,680 --> 00:02:22,820
e vex well-well,

56
00:02:22,820 --> 00:02:28,440
so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down,

57
00:02:28,440 --> 00:02:32,960
bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey,

58
00:02:32,960 --> 00:02:34,240
dem si di star.

59
00:02:34,240 --> 00:02:38,080
Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey,

60
00:02:38,080 --> 00:02:41,720
“Pipol hear kry and shaut for Rama.

61
00:02:41,720 --> 00:02:44,720
Rashel dey kry for en pikin dem wey don die

62
00:02:44,720 --> 00:02:47,320
and nor-tin wey pipol tok,

63
00:02:47,320 --> 00:02:49,140
fit make en heart strong.”

64
00:02:49,140 --> 00:02:51,080
Afta Herod die,

65
00:02:51,080 --> 00:02:54,900
God angel appear to Josef for dream wen e still dey Egypt,

66
00:02:54,900 --> 00:02:56,060
kon tell am,

67
00:02:56,060 --> 00:02:57,880
“Make yu get up,

68
00:02:57,880 --> 00:03:00,260
karry di pikin and en mama go Israel,

69
00:03:00,260 --> 00:03:02,440
bikos di pesin wey won kill-am,

70
00:03:02,440 --> 00:03:03,400
don die.”

71
00:03:03,400 --> 00:03:04,540
So,

72
00:03:04,540 --> 00:03:08,060
e karry di pikin and en mama go Israel back.

73
00:03:08,060 --> 00:03:12,000
But wen e hear sey Arkelaus dey rule for Judea,

74
00:03:12,000 --> 00:03:14,420
afta Herod en papa don die,

75
00:03:14,420 --> 00:03:16,800
Josef kon fear to go der.

76
00:03:16,800 --> 00:03:19,500
Afta God don warn am for dream,

77
00:03:19,500 --> 00:03:21,300
e kon go Galilee.

78
00:03:21,300 --> 00:03:23,420
Wen e rish Nazaret,

79
00:03:23,420 --> 00:03:25,060
e kon stay der.

80
00:03:25,060 --> 00:03:29,220
Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey,

81
00:03:29,220 --> 00:03:30,920
“Dem go sey Jesus,

82
00:03:30,920 --> 00:03:35,440
na Nazaret e from kom.”

