﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,260
Afta Jesus don send di pipol go dia house,

2
00:00:08,260 --> 00:00:12,420
e kon tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side.

3
00:00:12,420 --> 00:00:14,460
Afta di pipol don go,

4
00:00:14,460 --> 00:00:16,340
Jesus kon klimb go mountin go pray.

5
00:00:16,340 --> 00:00:18,700
E stay der go rish evening.

6
00:00:18,700 --> 00:00:20,000
By dis time,

7
00:00:20,000 --> 00:00:22,580
di boat don go far from land.

8
00:00:22,580 --> 00:00:27,840
Strong wave kom dey karry di boat up-and-down bikos heavy breeze dey blow.

9
00:00:27,840 --> 00:00:29,500
For early morning,

10
00:00:29,500 --> 00:00:33,180
Jesus kon dey waka go meet en disciples on-top di wota.

11
00:00:33,180 --> 00:00:36,060
Wen di disciples si am dey waka on-top wota,

12
00:00:36,060 --> 00:00:37,180
fear katch dem.

13
00:00:37,180 --> 00:00:38,980
Dem kon dey shake dey shaut,

14
00:00:38,980 --> 00:00:41,660
“Na ghost o-o!”

15
00:00:41,660 --> 00:00:43,260
But Jesus tell dem,

16
00:00:43,260 --> 00:00:45,980
“Make una heart strong!

17
00:00:45,980 --> 00:00:46,940
Na mi,

18
00:00:46,940 --> 00:00:48,920
make una nor fear.”

19
00:00:48,920 --> 00:00:50,740
Naim Pita ansa,

20
00:00:50,740 --> 00:00:51,740
“Oga God,

21
00:00:51,740 --> 00:00:53,780
if na yu true-true,

22
00:00:53,780 --> 00:00:57,020
koll mi make I kom meet yu for di wota.”

23
00:00:57,020 --> 00:00:57,540
So,

24
00:00:57,540 --> 00:00:58,900
Jesus tell am,

25
00:00:58,900 --> 00:01:00,500
“Make yu kom!”

26
00:01:00,500 --> 00:01:05,940
Pita komot from di boat kon dey waka on-top di wota go meet Jesus.

27
00:01:05,940 --> 00:01:09,080
But wen e si as di breeze strong rish,

28
00:01:09,080 --> 00:01:12,340
fear katch am and e kon bigin sink.

29
00:01:12,340 --> 00:01:14,020
So e shaut,

30
00:01:14,020 --> 00:01:15,420
“Oga God,

31
00:01:15,420 --> 00:01:17,260
save mi o-o!”

32
00:01:17,260 --> 00:01:18,420
At wons,

33
00:01:18,420 --> 00:01:22,340
Jesus stresh en hand katch am kon tell am,

34
00:01:22,340 --> 00:01:24,840
“Yor faith too small.

35
00:01:24,840 --> 00:01:26,780
Why yu dey doubt mi?”

36
00:01:26,780 --> 00:01:29,580
Wen di two of dem don enter di boat,

37
00:01:29,580 --> 00:01:31,300
di breeze kon stop.

38
00:01:31,300 --> 00:01:35,980
Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey,

39
00:01:35,980 --> 00:01:37,660
“True-true,

40
00:01:37,660 --> 00:01:39,380
yu bi God Pikin.”

41
00:01:39,380 --> 00:01:42,440
Wen dem don cross di river go di oda side,

42
00:01:42,440 --> 00:01:44,980
dem kon land for Gennesaret.

43
00:01:44,980 --> 00:01:47,500
Wen di pipol for der know sey na Jesus,

44
00:01:47,500 --> 00:01:49,620
dem send message go all dia village,

45
00:01:49,620 --> 00:01:53,260
den dem kon bring all di pipol wey nor well kom meet am,

46
00:01:53,260 --> 00:01:54,820
dey beg am sey,

47
00:01:54,820 --> 00:01:59,680
“Make di pipol wey nor well tosh yor dress” and all of dem wey tosh am,

48
00:01:59,680 --> 00:02:02,580
kon well.

